Stella Dimoko Korkus.com: Sunday Laughs

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Sunday, September 18, 2016

Sunday Laughs

Have a nice Laugh and dont let anybody dull your shine you hear?


































On a lighter mood;
SOME LAFFABLE WARRI PIDGIN PROVERBS!!!

1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin.

2. Woman wey never see problem... Na im
dey still hold breast run.

3. Woman wey dey find pikin no dey wear
pant sleep.

4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later e go hear am.

5. Na for afternoon dem dey find black goat.

6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg.

7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.

8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him march fish, wetin him mama go march?

9. Small pikin wey dem carry for back no
know say the journey far.

10. Person wey don faint before no be
stranger to death.

11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see.

12. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy labour pains.

13. Yansh no get teeth but e dey cut shit.

14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if
nobody hail am!! é go hail himself

15. Totoh water small, but e reach preek take baff.

16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND.

17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.

18. Na cricket tell him children say, No
matter how ground strong, Them no go sleep outside.

19. Pikin wey say him mama no fine they use style call him papa blind man.

20. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat.

21. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch.

22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.

23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS,BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK.
24. Dem no dey tell tortoise say race don start.

25. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food.

26. Before you see monkey, monkey don see you.

27. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, no go jump again.

28. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury.

29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am.

30. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze.

31. Meat wey you dey forbid, no use your
teeth cut am.

32. My thing and our thing no be the same
oh.

33. Na happiness dey make prick stand.

34. Na as goat stand for market dem dey
price am.

35. Craze no hard to form, na the trekking be wahala.

36. Its a small world!! No mean say you fit
trek from Naija go London.

37. No matter how hot your temper be, e no fit boil beans.

38. Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup.

39. Today’s newspaper na tomorrow Suya
wrap.

40. Akara and moin moin get the same
parent, na wetin dem pass through make
dem different.

ABEG WHICH IS THE FUNNIEST. . .



66 comments:

  1. Lmao @ continue prayering. Yorubawood will not kee person one day

    ReplyDelete
    Replies
    1. 41. No matter the shakara wen yansh do, leg dey first am enter house .
      42. Na where your craze stop, some people own start from , if you think say I be Linus mbah, go check otokutu bridge .
      So my people make una take the life sofiri sofiri 😀
      Since morning my Tafawa belewa never see Fulani ( belle never see food ) 🚶🏼🚶🏼🚶🏼 let me go and prepare fast fast things mehn.

      Delete
    2. 43
      No b person wey motor jam dey see d number of the moto wey jam am

      44
      Person bite you for yansh no care say shit dey from yansh comot but when u bite am for head, he begin say u no know say brain dey for head ?

      Delete
  2. Hahah.. Get figure out the funniest of the warri proverbs cus they are all way to funny.

    That man on the 7th pics has really suffered. From 1 meme of him to another.

    ReplyDelete
  3. Yes o Stella, nobody can dull my shine today and always....

    ReplyDelete
  4. These warri proverbs demand over make sense die..hehehhe

    ReplyDelete
  5. 33 and Dat SDK communication whatever... Lol

    ReplyDelete
  6. Stella, na inside that yellow office you dey blog ?.. Lol

    ReplyDelete
    Replies
    1. Na busybody correcter's office.

      Delete
    2. Lmao!!! Queen Hadassah you cray share. ...

      Delete
    3. Eheheheh, busybody corrector indeed.

      Delete
  7. The funniest to me; woman we dey find pikin no they sleep with pant.

    ReplyDelete
  8. none jare my sister..yawnss

    ReplyDelete
    Replies
    1. o ga!, e b like say dem dey follow u from ur village, so all dis write ups/proverbs no funny give u...smh

      Delete
    2. U need honey and Lucile coconut oil

      Delete
    3. @anonymous 9:57,the winsh wey dey follow u,go use broom fly from benin..give us yur own "anonymous laughs" naa..unam ikot

      Delete
    4. Lol smarsmarhty pants kuyaresit na

      Delete
  9. Lol,very funny,woman wey never see problem,na im dey hold breast run

    ReplyDelete
  10. 😅😂😄@ Yansh no get teeth but e dey cut shit
    Lmao @Totoh water small, but e reach preek take baff.

    ReplyDelete
  11. Happy Sunday All.

    I am a silent BV. Stella, after reading yesterday's TTC 49 Post, I now know God dines on your blog. You are but a Tool in God's hands.

    That Poster, is a great testimony and victim of God's Love.

    ReplyDelete
    Replies
    1. No be only Victim of God's love. Haba! u people should fear God!

      Delete
  12. Lol @ SDK communication center..stella is that an affiliate of SDK blog?

    ReplyDelete
  13. STELLA YOU DON ENTER ANOTHER LEVEL... WOW.

    ReplyDelete
  14. 😃😃😃👍

    ReplyDelete
  15. Lol@ tohtoh water small but he reach preek take bath,nice one Stella bebe

    ReplyDelete
  16. Stella stella! U be real waffarian. My personal best is 13 and 15...

    ReplyDelete
    Replies
    1. Abeg na who una wan send dis kain msg abi na employ 4 work?wetin d 13 n 15 talk?my sroll button no gud abeg!!

      Delete
  17. Nice one... Happy sunday
    BlackBerry restart got me.

    ReplyDelete
  18. Lmao @ SDK communication centre. Maybe that's BBC's office

    ReplyDelete
  19. The second and third crack me up then the warri proverb, they are all so funny. Happy Sunday all. No church for me today, not happy with my life.

    ReplyDelete
    Replies
    1. But honestly, White Berry!! Not hating but just observing...must you beg for EVERYTHING??!!

      The fact that no one has heeded your call means you are doing something wrong. You come across as aggressive and extremely desperate. Change your modus operandi and see if your call won't be answered .

      Once again, just an observation from a concerned BV. Lighten up; life is too short

      Delete
    2. You're so shameless and irritating. There's never a time you're happy with your life. Desperado oshi.

      Delete
  20. Hahahaha... Yansh no get teeth but e dey cut shit! Lmao

    ReplyDelete
  21. Ewu!Ewu!Ewu!First to comment.Nobody can try me.I am the best!Ewu!Ewu!Ewu!

    ReplyDelete
  22. I didn't get the cricket one o, biko make person dash me explanation giveaway!

    ReplyDelete
  23. Hahahahaha! Those Warri proverbs though.. so fuuny!
    1 and 2 are my fav.

    ReplyDelete
  24. I got more than humour out of it. There are some deep messages in there.
    "If e be like say everybody dey craze" na you dey craze"...I used to be that person, always nit-picking and never wrong. Something happened some months ago that made me realise I need to sit my arse down and do some introspection. Turns out, I wasn't as 'perfect' as I thought. Now, I try to live and let others live.

    MISS Jacobs.

    ReplyDelete
  25. Lol,pls someone should bless me with airtime for subscription, mtn or Airtel thks in advance.my ll expire on tues

    ReplyDelete
    Replies
    1. I don laugh scatter body. No 35 is just too funny.

      Delete
  26. Nawa for that second joke o. Sucking ur househelp breast to see if ur child was being poisoned???? Why not admit u had wanted to do that all along. Stupid guy idiot.mtchww

    ReplyDelete
    Replies
    1. Abeg who offend u?ddnt transfer aggression na;its jst a joke inugo?!!!

      Delete
  27. Even in the 90's when we were in primary school, we had started talking about tohto water even though we didnt know what it meant.. This our Warri sha

    ReplyDelete
  28. Very funny, I love them all don't knw which is d funniest thanks dear 4 shearing these.

    ReplyDelete
  29. Hahahaha the foolish man sucking the maid breasts. Foolish man indeed

    ReplyDelete
  30. Warri no dey carry last!

    ReplyDelete
  31. Laughing my ribs out @ warri proverbs, eyes already laughed out...

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141