Stella Dimoko Korkus.com: Chronicle Of Blog Visitor Narrative...

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, March 13, 2017

Chronicle Of Blog Visitor Narrative...

Na wah oh!




STAND ALONE NARRATIVE
ABROAD BOYFRIEND ISH

Here goes my chronicle…..

The work when I dey do no dey let me see road well talkless of mingle.

Na im I come dey Facebook o, dey do my tin jejely nai I meet one friend of mutual friends(UK based) 48YRS AND ME NA 31YRS

Na so we come begin gist for some years, before you knw am, we come begin talk some kain worries when two of us get.



Nai I yarn am say dis whole country and work don tire me, I for no mind move o, nai he say make I try get visa na even ginger me come send me invitation.



I come try some 3years back, dem don nearly give me o (they come tell me say, my salary too small and dem no feel say I go come bak when I reach there). Choi! Dem no even hide am sef under the guise of - … the purpose and justification was not verifiable as Schengen dey do….. dem just knack am give me!!!! Na dat time I knw say the work when I dey do na big name wen dey kill small dog!!!



So I come tell am d result o…he come say we go try again! I say u and who? I no go there again. Say the only way when I go fit use dat my small salary when dem condemn na if na my husband I dey go meet, I go knw say dem fit overlook if he get better work there.



Nai guyman say make we try am again na, but this time make we do marriage (whether he don first dey find wife bfr I no knw as I come talk nai he quick quick jump at d offer). Based on say I dey single at the time, nai I decide to give am a try. Na so we come dey ‘date’ o. Dey try to know each other o…. in the process I come see some badddddd tins like:



1) He no send church (him excuse na he dey work weekends), I come say at least make it a point of duty to go to church once a month. He say wetin b my own with church sef? He no get



2) He be like who no dey hear when u dey talk to am (cos he go dey talk off point) I first tink say na network, later later I come realise say na so he be dese last few days) We no just dey the same wavelength at allllllllll



3) He is not family oriented(You know when u dey date person when wan take you serious, he go dey try wan get along with your siblings, this one? Whosai!!!!!, then anoda red flag( for am to buy ticket come Nigeria, na war… he say he need to save money first( HIAN- person when dey work and be citizen? Person when never come home in 19yrs?) This life big ooooo, Person no go just visit Nigeria in 19yrs when him parents dey reside here… na wa o



4) I never even talk, he don dey try hint me say- for that side na 50/50 o, nai I clear am say- whether you like am or not, you are Nigerian even though dem born you for that side… Man na Man. You must live up to your responsibility.I no talk so I no go support you, but no use am choke me say if eventually I come, na 50/50.



5) Also, he first marry to one oyibo, bt marriage no last reach 3yrs. I ask am wetin happen, he say- she no gree move from her city, him sef move go meet am bt he no fit cope, nai he move back break up with both consent o.( Dat story no gel for me at all)



6) Anoda tin, Grown man go dey ask hw much he go use tak come Nigeria when go reach am for one month as if he no dey watch news and how things don change since 2yrs ago talkless of 19yrs. I come even tell am say 2000pounds, na so he ask me if he wan build house? That time sef d exchange rate never high like dis o…. HE NO JUST SABI SOME KAIN BASIC THINGS.



7) I no like d kain clothes he dey wear (all dose kain clothes when mature man no suppose wear like baggy knickers and polo with stupid inscriptions (eg PINAS LOWRIDERS, GO FUCK YOURSELF OR IF YOU DON’T LIKE ME GO HUG THE WALL) on them.



8) Na so this old man go go facebook, put picture of babes when get extra large booty with inscription (Is God not good?) Choi, I don talk tire, He go tell me say na him wall, he can do what he wants.



The big one come be say, as I say make he show say he serious- na so Omo guy send ring ooooooooo (I just wear d ring snap show am then wear am inside house and mayb when I dey find accessory to complement others(Sincerely)



9) Basically everything na push I dey push am. Him Nigerian passport na me push am do am (he come dey thank me later). He come finally book ticket, cheap one (all of us like cheap things but this one na poison cos he wait for almost 1 yr to first gather d money bfr he come book am for far far date so that e go cheap).



Now he wan come naija, I don already dey tell am say I no sure say I fit do wetin he want and I dey return him ring to am once he come- he dey there dey tell me to start making the plans for the intro and registry. I no even ansa am again, na so he send me msg say I dey give am silent treatment. Then aspa the registry sef, he say me and am go just go, make we for get d certificate take start to process the papers, then the introduction when he dey talk, na him go just come see my mama(as if I no get papa) tell am say na him o, bt nw as e be so, we wan just do d registry first then when d papers don ready, we go come do the big traditional and church wedding as I want(Some people no get VALUES sha). I come ask am wetin do him family- he say him papa no well, the siblings wen dey d ctry he no sure say dem go get chance to leave work follow am come (Na dis one I take conclude say na either spirit he be or him head dey do skoiskoi).



Abeg my fellow BVs, make i no read any curse for the comments. I use everything una hold dear take beg una. I just need advice on how to tell him to go and get a life and how to return the ring without anyone getting hurt.


NA ADVICE I TALK NO B CURSES O.


YOU NEVER KNOW WHAT OTHERS ARE GOING THRU UNTIL YOU GO THRU SUCH YOURSELF. LONELINESS NO GOOD O ESPECIALLY WHEN YOU ARE OF MARRIAGEBALE AGE, SOMETIMES YOU JUST NEED SOMEONE IN YOUR LIFE TO SHARE SOME THINGS WITH AND WHEN THIS SOMEONE IS NOT FORTHCOMING, YOU TRY TO SEE IF YOU CAN MAKE THE AVAILABLE PERSON WORK TO YOUR STANDARDS, BT AT THE SAME TIME E GOOD MAKE PERSON STILL OPEN EYE……

169 comments:

  1. Who has the time to read this razz rubbish to the end?

    ReplyDelete
    Replies
    1. Don't ever try dis rubbish writing in pidgin again, sdk y approve dis

      Delete
    2. C'mon Quickky
      Someone needs advice n that's what u can come up with
      Gush

      Poster, please leave the guy
      Don't marry someone u don't really know
      Try ask your mutual friend somethings about him

      Delete
    3. Let me catch myself reading this. I havent finished an epistle in English it's now pigin? Hian!!

      Delete
    4. Quicksilver
      You're an Idiot. Fuck u for saying such to the poster, Ms English teacher, are you not Duchess on facebook? Heavy runs girl. Cow

      Delete
    5. Make I perch for here. Babe cool down for Jesus, say you be 31, no mean say your brain don fry na. Make una define this una relationship, na contract or na the real deal? If na contract, den you no suppose catch feelings but if na the real thing, ol' gal, give yourself brain and move on.

      Delete
    6. Reading in pidgin is hard Hun. Next time type in English

      Delete
    7. On d contrary i actually enjoyed d gist. Quickie trust me its not easy 2 write in pidgin o. I try it sometimes n ended up in English.



      To d poster, RUNNNNNN. thats all i can say.

      Delete
    8. I don't normally like reading in pidgin, but this one was sweet. It really flowed and I enjoyed it. The writer is a clown. Lol.
      Her words are just too funny.

      Delete
    9. I has headache reading this chronicle. Anyway move on if u persive that the man is not being sincere.

      Delete
    10. Babe, when he comes to Nigeria, sit him down and talk to him. Una need to define the relationship. Also let him know you "MUST" meet his family before anything.

      This whole thing is already looking like a contract. You too old to fall for such. It's better to remain single than enter one chance.

      Delete
  2. I'm sorry, the pidgin really put me off this chronicle.

    I don't know how to read correct pidgin well but I can type small lol. I'll leave others to advice you here...
    Pele

    ReplyDelete
    Replies
    1. My thoughts exactly...had to read some outloud to try and get it but...I'll pass...
      Good luck dear

      Delete
    2. This is why some people won't progress. Diversify.

      Not everyone speaks and type English fluently. If you couldn't read just jump and pass

      Delete
    3. You people are complaining about the pidgin. Meanwhile you will hail villager when he spills out rubbish everytime.

      Delete
    4. You all can't read this but will read Hebrew villagers write here and paise him even. You guys get problem.

      You all should go to the next post.

      Delete
    5. What is wrong with you people? Why must you cuss and spew trash all the time?
      Are we not different people here? With different minds and opinions? Please leave me to state mine.. State yours and move on!!!
      Rubbish

      Delete
    6. I absolutely love the pidgin. please leave that man alone please. That agbaya is all shades of wrong!! Please keep off and stay away from him make e no use him reggae spoil your blues.

      Delete
    7. Lolo, Don n Anon 15:46 tnk u all. I dnt understand wat d complain abt pidgin is 4. BTW, english nor b by force.

      Delete
    8. I enjoyed reading this and very easy to understand. Anyhow u tell this guy, he go still vex. He no go de heartbroken, na pocket broken he go de. Omo that your guy is extremely stingy even to himself na WA. Run faster than your leg can carry you.

      Delete
    9. I enjoy reading this write up.😛. Babe, abeg, delete that guy from your life. E no worth am at all. Which kind parol be this? Mtscheeeew. Better things loading jare

      Delete
  3. U already knw this situationship will not work. Stop holding on to shit jst cos he stays in jand. U have got standards (i suppose), don't stoop that low.

    ReplyDelete
    Replies
    1. anonymous gangster13 March 2017 at 16:35

      She said so already nah, she just needs help on how to let him Dow gently. Did you read at all?

      Delete
    2. I cannot write in pidgin this well.. nice, reading it felt somehow though, but I clap for ur writing.

      U already know u dnt need that man, na loneliness push u to him. I have a question, where will he stay when he comes? Ur place or hotel?

      I go advice make him no come at all since ur heart no dey there. But if he comes, o well, I dnt know, but u have to tell him how u feel. But Sister no marry that man!!!!!

      Delete
  4. Replies
    1. You dont have anything upstairs.

      Delete
    2. You dont have anything upstairs.

      Delete
    3. Yes, please do, no one needs your smelly sperm here. Tankio.

      Delete
    4. Pls follow your heart,return his ring this is pure one chance and u sure don't love him

      Delete
  5. My head hurts reading your pidgin lolz. Brb

    ReplyDelete
    Replies
    1. Me too, what was she thinking when she typed it 😕

      Delete
    2. 😂😂😂
      I sha enjoyed it😆
      Very funny chronicle.

      Delete
  6. That guy married the oyinbo for papers, you should have been able to discern that.

    He reached out to you to help you with visa, i don't see why you want to be catching feelings on top.

    He said you should arrange marriage so you could come over...he's not dating you, you are the dating him.

    He probably just needs children with full Nigerian blood.

    The question here is not about marriage at all, it's simply are you ready to contract a marriage for papers?

    Remember he will be the one you know over there if it works out,you will be stuck with him for months/years till you get your footing.

    Reason am well.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Exactly, poster listen to @bipolar me. the man just wan help you so that u go also help am. Do u want a proper marriage for ur life or u jst want go abroad? Pick one.

      Remember u will live with him for years first before u can stand on ur own, so talk to him first and understand his thoughts and reason.. but I still advice, dnt marry him.

      Delete
    2. Don't marry him? But they have to get married first before he invites her over

      Delete
  7. Pretty much difficulty reading this.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Another fake idiot.As if your English is perfect meanwhile you speak yoruba or ibgo at home with your poor parents.fake ass bitches

      Delete
  8. Hmmmm! I don't even know what to say but tread with care




    Long live SDK

    ReplyDelete
  9. This one na bad market. All the red lights are there, abeg no do

    ReplyDelete
    Replies
    1. I loved reading this but babe, you're in a situationship not relationship.
      Does he know where you live and work? If yes, break up and return his ring through the gate man. If not, biko change your phone line, block him on Facebook and move on with your life. This is dead on arrival, no need working it out.
      P.s, don't be desperate next time.

      Delete
  10. Stupid ass chronicle.

    ReplyDelete
  11. I good as you knack am for pigin instead of make you carry bomb full everywhere.
    Abeg i get no other way you go return ring. Na to return am be dat. Tell am say im no pass; chikina.

    And you sef, make you no carry two leg waka enter well for that registry matter. E be like say the guy na 419 kin person wey get satan for cupboard.

    I don talk the one wey me know.

    ReplyDelete
  12. Nne you never ready to marry. See talk

    ReplyDelete
    Replies
    1. So if she's your sister, you will tell her to go ahead with the plan ?
      Most of you lose your senses when you hear abroad story.. Imagine.

      Delete
    2. Never ready to marry wetin? Guy with the characteristics she listed above? Abeg that marriage na one chance.
      See babe, there's no sugarcoat sugarcoating anything so just return the ring and make your reasons plain and simple with no ambiguity. You no do again and apologize for the ticket he spent a year to save or target for.

      Delete
    3. That marriage was seriously dead even before they started talking abt it sef...
      Abeg make girls the enter relationship with their brain nah...so because say an away man make she go enter one chance say she wan marry and age don run leave am? ...poster God dey show u serious light ooo...Run!!!

      Delete
  13. hard to understand what's written up there.
    how healthy is your ikpu??
    if it is unhealthy ...... then you are on a long thing.
    my ikpu is bae

    ReplyDelete
    Replies
    1. So its all about ikpu for you 😂😂😂😂😂

      Delete
    2. I marvelled the day I heard ur voice.
      I support ur movement but ur comments on SDK is an absolute turn off for anyone who intends to be part of ur movement.

      If only wishes were...

      Delete
  14. BABE, LIFE IN UK IS NOT EASY O. FOR A MAN OF 48 YEARS, ARE YOU SURE HE ISNT MARRIED TO A NIGERIAN IN UK? OR EVEN IN NIGERIA? DONT ENTER ONE CHANCE O. IF YOU NOTICE COMMA, LEAVE HIM AND FIND A YOUNGER GUY.

    THIS ONE THAT BUYING PLANE TICKET IS WAR, CAN HE AFFORD WEDDING? EVEN IF HE DOES REGISTRY, ARE YOU SURE A WEDDING WILL FOLLOW AFTER? DONT ALLOW HIM TO GIVE YOU BELLE AND WHIZZ O!

    OR YOU WANT TO BECOME LORD OF THE RINGS? EVEN IF YOU GO TO UK, JOBS ARE NOT EASY TO GET. HOW WILL YOU COPE WITH A MAN WHO IS ALREADY STINGY TO YOU WITH NAIRA TALKLESS OF POUNDS? ITS NOT LIKE YOU WILL ENTER THE COUNTRY AND START WORKING IMMEDIATELY. PLENTY DUE PROCESS DEY. DO YOUR HOMEWORK BEFORE YOU POST ANOTHER CHRONICLE.

    MEN ARE NOT SCARCE. IT'S BECAUSE OF POVERTY THAT GUYS ARE NOT THINKING OF MARRIAGE. 31 YEARS IS NOT OLD ENOUGH FOR YOU TO MAKE A DECISION THAT WILL RUIN YOUR FUTURE. THE LADIES MARRYING AT 33 DONT HAVE 2 HEADS. HAVE PATIENCE AND BE OPEN AND GOD WILL GIVE YOU A REAL MAN AND NOT THIS YOUR ARADITE UK BOO

    ReplyDelete
    Replies
    1. I agree. So on point. At 31... you will still find someone. Don't go and enter one chance and regret your life

      Delete
    2. Upon all your capslock you didnt read the chronicle properly. She said: SHE NEEDS ADVICE ON HOW TO TELL HIM OFF WITHOUT DRAMA.

      Delete
    3. Lovely pidgin.Very creative. Please go sell that ring for Ojuelegba, okay? Don't hurt your self, sweetheart....

      Delete
    4. Lovely pidgin.Very creative. Please go sell that ring for Ojuelegba, okay? Don't hurt your self, sweetheart....

      Delete
    5. Words can hurt someone be nice

      Delete
  15. Mhen this your pidgin chronicle slow down my reading.
    1. How are you such this man is really 48years.from your explanation he behaves like a 55years old man.
    Pls dont let age pressure push you into what you will regret tomorrow.
    Think of an excuse to give him,pls let him carry his old papa self somewhere.sorry poster am not concerntrating well replying you, I have a visitor.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Because your poor father in the village writes English or your mother tongue is English. Shameless lots, complaining about English. Even British differentiate themselves. Someone from Liverpool will have a totally different accent and pronunciation than someone from Jersey but trust fake Nigerians. Do you know that Jamaicans and some Africans adore pidgin? Stop forming unnecessary you stupid people

      Delete
    2. My dear your head dey there! He is probably older and does not want to involve his family cos they know he is alresdy married. Grandpa alert. Tell him not to bother coming that you changed your mind and your family is not in support or you even prayed about it. Just be blunt.

      Delete
  16. The guy has hidden agenda, trust me.
    A broken relationship is better than a broken marriage.

    ReplyDelete
  17. This ur pidgin English gave me a headache. Poster don't u have toasters in Nigeria biko. What is all this.

    ReplyDelete
  18. I can't read it abeg,too difficult to understand

    ReplyDelete
    Replies
    1. Because your poor father in the village writes English or your mother tongue is English. Shameless lots, complaining about English. Even British differentiate themselves. Someone from Liverpool will have a totally different accent and pronunciation than someone from Jersey but trust fake Nigerians. Do you know that Jamaicans and some Africans adore pidgin? Stop forming unnecessary you stupid people

      Delete
  19. Girl make you know say to go church no be to know God. Make you dey read ya bible dey do wetin im talk; na im be koko.

    If you wan marry spirit, make you collect wetin im de bring come. I beta make you run as you leg fit carry you. Dat kin man no be am.

    You sef get mind wan go abroad when you no get plan B. You wan leave ya work for man mata? Na that time when you lose ya work, come no get husband you go know say the "small work" good; say kaki no be leather. And say Ogogoro get same color with water but im strong pass.

    I don yarn am as I know.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Chai! You just knack the nail for the head.See pigin! Pigin pass pigin ooo....

      Delete
  20. Loneliness is a bastard. From YOUr narrative you're a sharp chap! Do not lower your standards for an inconsistent human.

    Success dear.

    Oluwa it is time! Provide our boos

    ReplyDelete
  21. It is better as you wrote in pigin than to throw bombs everywhere!
    There is no other way to return his ring but to return it!
    If you swallow that "registry bait", the man will just walk back to his base and you will become a bat; neither a mammal nor a bird, "married" but not married till age do you in!

    ReplyDelete
  22. this your chronicle just made my headache worse.
    Madam, you are 31...please act like it.
    if this guy is not giving you what you want & you are not happy, please move on.
    Stop sending annoying chronicles in pidgin on an issue you should have sorted yourself.

    are you that lonely?

    ReplyDelete
  23. Madam na wa for u oooo, see as you just number the bobo errors like say u sef no get your own for body. My sister, nobody holy pass. Me I feel say the guy even try sake of say him accept to carry you go obodo yonda come still send you invite free of charge. E be like say you no know say na beta money some people dey collect/charge just to organise invite for person. And from wetin you talk e be like say na ready made guy you dey look for, you no even know whether bros just dey try test you. Anyway, me I go jus advice say make una see first after all oyinbo people say face to face is better than hundred letters. And concerning that 50/50 mata, na true hin talk, tax dey finish dem there, abi na 80/20 you wan do? Biko don't be stingy jare. Vex if u wan vex, na truth I yarn you.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Forget test abeg, this bros na bad market. UK guys no be am, i have a lot of them as friend.

      So because he send am invitation, she suppose to dey worship him ?
      Abroad na wetin sef ?

      Delete
    2. My thoughts exactly
      Poster listen to this advice

      Delete
    3. Ur talk na rubbish talk and u dey sound like desperado. E no better for her to meet guy for ninja here Wey go foot all her bills than go abroad to meet old man wey no dey reason well, which useless test him dey test am.babe abeg chill dey pray to your God to send u better bobo here for ninja than go to the abroad to suffer,Me I marry for age 33 to sweet guy and taking good care of us.no rush in this life oh if not everyday na cry u go dey cry

      Delete
  24. Please whats with the pidgin???

    ReplyDelete
    Replies
    1. You can't spell correctly but asking what with the pidgin? Fake bitchy.

      Delete
  25. Loneliness is bad at the same time its better to avoid entering wrong marriage. The repercussions is severe. Sit him down when he comes, engage him in an heart to heart conversation, let him know you can't cope. You have tried so hard to overlook so many things and make it work but your happiness counts. So you just have to let go. God will provide you a suitable partner before this year runs out. Cheer up

    ReplyDelete
  26. Next time write in clear english, i can't read this.

    ReplyDelete
  27. Too many red flags. Thread with caution. I have noticed that embassies a lot of times turn down request to travel when you have an invitation letter from the person over there to foot your bills. It's better not to present a letter at all

    ReplyDelete
  28. Hmmmmmm me i cant even date a man that is in abuja while i am in jos sef how much more an abroad man. Brad taught me a very good lesson that will last for an eternity.i raise beyonce hands for all of una wey dey do "long country" relationship.








    *hangs leg on the wall*

    ReplyDelete
  29. I really can't read this, I find it really stressful reading pidgin English.. Just saw Bipolar's comment and I understand you want to have a contract marriage? Well, that thing keeps people stuck on nothing.. You are not in love, you are in a 'situation'. Don't get married to him.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Ok, but there nothing like pidgin English my sister. It's either pidgin or Nigerian pidgin

      Delete
    2. Shut the fucked up, who are you forming for? Is your father a British? Do you even speak English at home? Some of you speak yoruba and igbo at home but forming for pidgin.you can't read shut the fuck up and leave this place.

      Delete
  30. Dear Poster,

    Don't mind all these men oh! UK men especially. They can be deadly.
    Thank God you know what you want, because if you do mistake follow am go there ehn?, you'll discover he has been married severally and has some kids, very manipulative etc.

    My elder sister once entered such a trap. It was just God and Lagos sense that she used to escape him... That is the story for another day.

    My dear Poster, no beating around the bush. Just tell him plainly; "dear blabla, I have thought about your proposal and had a rethink. I don't think we are meant for each other, pls I think we should remain as friends, and forget about this marriage ish"

    Now is not the time to tell him about his family. When he has come to terms with your decision, then you can bring that up

    Thank God say your head correct. Pls relax. I like your sense of humour. YOUR HUSBAND WILL LOCATE YOU THIS YEAR. make you no go enter one chance.

    Cheers..

    ReplyDelete
    Replies
    1. My Sis also nearly entered one chance with a guy that lives in the UK. He was married to another woman but lied about it until a friend's friend exposed him. Sis is a medical doctor doing well in the US. Go figure...

      Delete
  31. Chai,to read hard me gaaann,please let him know how you truly feel before u pull the carpet totally.personally though I feel there's a reason a man of that age never marry with kids and he could not have married the oyinbo for papers since he's a citizen.if you av anyone to snoop on his background or someone that's knows the family well,his story has a lot of gaps,u don't just not come home from the abroad in 19yrs abegg!

    ReplyDelete
    Replies
    1. It's hard to read, yet your English is a so poor.You can't even spell right.Fake people everywhere

      Delete
  32. The signs are clear na, what more do you want to hear

    ReplyDelete
  33. Dis ur pigdin just spoilt ur chronicle!wat are u even saying? If u don't like d guy,wen he coms,u free me! No too much magana for dis ur chronicle na! Next time poster try and write in english language! I belive u went to school and u are a graduate right? Don't be stressing people wit dis ur bad vocab mbok! D recession is already dealing with us!nor com add u own! Nor take ur reggae spoil our blues abeg!

    ReplyDelete
    Replies
    1. English professor since its difficult for you to read her chronicles,please...biko...mbok jump and pass to another post abi na force to read chronicles? Haba...

      Delete
  34. I cant even understand this write up, My head aches from reading this

    ReplyDelete
    Replies
    1. Oh please. Spare us the fakery

      Delete
  35. One chance tinz

    ReplyDelete
  36. Jeeez i just have terrible headache after reading this shit. Chai who send me message?
    Anyway i feel like you both dont have a chemistry at all. Would you marry him if he start attending church?
    Do you think he will make you happy if he changes his dress sense?
    Do you see yoursef being happy with him after three kids?
    Woman give him back his ring and stop trying to make it work by force.
    If a man loves you, you will know.







    *hangs leg on the wall*

    ReplyDelete
    Replies
    1. When did the headache start? After you read and dropped the 1st comment or when u read again to drop this second comment.

      Delete
    2. Hmmmm Chai bvz can followmatize! you go fear trolling headache. Kpaskilis forming help me ask oh.
      As a matter of fact the pigin made it hilarious. I laughed all through.

      Delete
    3. Lol...Linda Arinze abeg you be monitoring spirit?...#caughtintheact!

      Delete
  37. And if you want to break up with him, do so before he comes to Nigeria. It will be very unfair if u made him come to the county for nothing

    ReplyDelete
    Replies
    1. Exactly what i wrote down there. Start tellijg him now that you can't marry him before he get here.

      Delete
  38. I put it to you that you knew all along all these faults but now backing out because it all does not seem very rosy. Couples abroad share responsibilities,so if you are not ready to 'woman' up better let him be.31 isn't too late to work on yourself (English added) and find someone who would walk, dress, talk,eat, breath, fart and Take care of you according to your specifications!

    ReplyDelete
    Replies
    1. English added???? It takes a very intelligent mind to write in pidgin. Try and see, make you know say khaki nor be leather.

      Delete
  39. This uncle is not for your type, please leave run from such person. He's not into you and not ready to settle down. Pray to God to send yours and He will do it. Arobanko still full him body/mind.

    ReplyDelete
  40. I'm having a headache reading not to talk of comprehending. "Nai I..nai he..."No! I can't do this to myself.

    Write in a proper English,then come back.thanks

    ReplyDelete
  41. I find your writing amusing,was smiling all through (smiling cos of the writing and not the chronicle o)
    U already know this man is not your kind of person so you shouldn't have led him on
    Now he has used 1 year to gather money to buy ticket to come and see his wife
    Wetin go come apn
    now?

    Start giving him the silent treatment maybe he'll get the signal

    *Ace signing out*

    ReplyDelete
  42. As na pidgin u take narrate,i go reply u for pidgin. Abeg sis, no go start wetin u no go fit finish. Marriage no be by force o,tell am say e no go work again(say u don tink am wella). How person wan come marry u witout his family? At his age,him no dey matured at all. If u follow am go there,na to go born for am be dat and u fit no see ur pple again till u die! No be jinx o! Let him know d needful kia kia. I don talk my own.

    ReplyDelete
  43. Your Pidgin is a No No....
    Trying so hard to make it sound so interesting but in all honesty it just didn't make sense to me...
    Stopped reading it after awhile.....

    Whatever the case maybe i wish you the best....

    ReplyDelete
  44. My head hurts from reading pidgin English? Seriously?
    Goodness! Are you fake people for real? Explain who and what you are forming for?

    I read to the end and i must commend your sense of humor.

    My advise, wait until he comes home before you draw your conclusion. Maybe he is out of touch with a lot of things. Meet him first, get to know him.



    KING XOXO MYSTERY

    ReplyDelete
    Replies
    1. Help me ask these people oh.
      At least you guys now know how other people feel when you type out comments in your language.

      I found this chronicle both amusing and annoying.
      Amusing because of the way it was written, pidgin English and all... The writer certainly has a sense of humour.
      Annoying because this chronicle was obviously written by a girl who knows her mettle and lowered her standards for too long just because she was lonely.
      Poster, you already knew early on that this man was not for you, yet you dragged this thing on for so long that it became difficult to tell him the truth about your feelings.
      No matter how you tell him now, he will be upset because it will seem like you just made him waste time and money for nothing.

      There's no way out but to just tell him your mind, do not attempt to spend any time alone with him.
      Men like this can be very charming when they went to be...or dangerous.
      If you sleep with him, you will start catching feelings, wake up one day 5 years and 2 children later and wonder if you were jazzed.

      A word is enough for the wise.

      Delete
    2. It is not about being fake, speaking is different from reading, I sincerely couldn't stand reading the chronicle.

      Delete
  45. Please, don't ever write in pidgin if you want a good advice. Your write up gave me headache

    ReplyDelete
    Replies
    1. God bless u

      Delete
    2. You are all fake people here. What's so difficult here now ? But you will praise villagers for writing some head breaking shit here.


      Grammar no be your language.
      Inferior sets.

      Delete
    3. Saint j! That thing in ur mouth.
      I wish its mine u decided to take in.

      Delete
  46. You should av at least write it in English nw...My advice for u is to follow ur heart.. You wear the shoe and knows where it pinch u

    ReplyDelete
    Replies
    1. Her pidgin is better than your English.

      Delete
    2. Hahahahaa
      Aunty Ganiyat
      Ki lo sele ti eyin na n blow bomb?

      Written
      Know
      Pinches

      *Ace signing out*

      Delete
    3. Hmmm...English language no be here ooo... you wanted to correct the poster and ended disgracing yourself.
      Look and pass...no you wanted to read... Ok read and don't comment you felt madam Stella will dash money to those that are commenting...just take a good look at yourself! English professor oloshi.

      Delete
  47. My sister, just tell am say you no dey do again and you know wan go the jand again, as a woman when you have a bad feeling about something don't try to paint a better picture.

    ReplyDelete
  48. Don't get it when people say they cannot read pidgin abeg what is the different between the two, if you can read english you should be able to read anything even other languages, abi na form my head spin, my dear please don't think he his that bad from your write up, all you need do is sit him down and understand the basis, abroad is not Nigeria if i dey lie abeg ask Stella when they the abroad

    ReplyDelete
  49. Very very hilarious expression you sure can pass for a commedian lol, though hard to read pidgin. Tell the Bobo you a not feeling him then send his ring through DHL to the dude.

    ReplyDelete
  50. my dear, all this UK bobo no sure o, abeg tell am you no dey do before he come sef better than him coming to hear from you directly and find a way to return the ring at least there was a way he sent you the ring, do same and live your life in peace, before person go put you for yawa. abeg beter late than be late.

    ReplyDelete
  51. You dont learn how to jump off from the cliff, just jump. That is to say there's no way to return the ring, other than to return it anyhow.

    Start singing it to him now that you are no longer interested and you would be returning his ring oncevhe he come Naija.

    ReplyDelete
  52. See all the kpako forming posh. ..all of a sudden yall don't understand pidgin english. Fake assess.

    ReplyDelete
  53. even those who are scrutinizing her english can't write well.....plz if the english is giving you headache them force you read am???? rubbish!!!! babe plzz dont marry someone you can't cope with. all the best dear.

    ReplyDelete
  54. All of una don get headache now. Ordinary pidgin you can't read. I'm butty to the core and I read it with ease. Hmm madam if your instinct say it's not right, it probably isn't! Don't gamble with your life o. I don talk my own. You sef know as e dey go. Ngwanu bye bye till the next kuroniku 😄

    ReplyDelete
    Replies
    1. I seriously wonder what is difficult to read here.Not like they speak good English on a good day oh... With all the mistakes I read here all the time, I come de wonder the bvs wey de make am oh.

      Delete
  55. This is a major one chance you are about to enter, all the red flags you listed are enough to warn a sane person off but your desire to leave Nigeria is obviously clouding your judgement some. You will regret it if you go ahead with this man, of that I am sure.
    Pls be patient, prayerful and trust God completely. Delay is never denial, 31 or not, your own man will find you and you will have a kind of peace within like you have never known.

    ReplyDelete
  56. This pidgin na WA oh. Hope you get good advice from people that are able to read.

    ReplyDelete
  57. Is this a joke or what? Who has time to read this pidgin English? You sound so razz. My friend, write in English language. You think I will give myself headache and stress my life further by reading this thing you wrote? Gerahere

    ReplyDelete
    Replies
    1. Because your poor father in the village writes English or your mother tongue is English. Shameless lots, complaining about English. Even British differentiate themselves. Someone from Liverpool will have a totally different accent and pronunciation than someone from Jersey but trust fake Nigerians. Do you know that Jamaicans and some Africans adore pidgin? Stop forming unnecessary you stupid people

      Delete
    2. She is not razz, rather you are the razz one.She wrote in pidgin. Please deal with it. Why dont you use your name let me fry your ass here.
      And next time its 'get out of here'.You actually sound so cheap and local with 'gerahere'. What the heck is that?

      *not the writer but someone just angry at your tone here. And yeah, I chose you to reply to.

      Delete
    3. See this asshole.. Fufu forming butty.

      Delete
  58. You think you're talking to street people like you? So razz

    ReplyDelete
  59. Please don't marry him because he sounds like a baggage. Imagine at 48 years, he still talks and behaves like that. This one can kill o

    ReplyDelete
  60. Madam, this is a typical case of a child trapped in a man's body,dealing with midlife crisis knocking on his door. Don't make a mistake that you will live with for the rest of your life. I actually think you should let him know how you feel,considering how he handles money matter. It won't be fair he comes to Nigeria with the hope of getting married and he gets jilted.
    Talk to him without any selfish motive or interest,if he is wise he will adjust.if he does not fit into your spec still,let him go. Don't give him false hope and make him spend the little he is managing.
    God will help you out.

    ReplyDelete
  61. Look at them shamelessly shouting i can't read, me as a foreigner married to a nigerian can even read but those who were born in the village, grew in poor environment, went to mediocre school will be claiming shakespeare.No wonder most of you are fake and fake accent just to belong.The poster didn't want to write in english probably because she can't spell well which most of you will leave the advice and curse her, now she used a language she knows it's a problem to most of you. Y'all stink and sick seriously.

    Fake people everywhere.

    ReplyDelete
    Replies
    1. From the write-up I think the poster is educated, but she just decided to write in pidgin cos someone who is not cannot write pidgin so well. Let them be forming what they are not.

      Delete
  62. Please try to get some information about his background before you take any step

    ReplyDelete
  63. Please try to get some information about his background before you take any step

    ReplyDelete
  64. I don't under what you wrote. I can't s I spend 8 hours in the office and still come and suffer to decipher whatever it is you wrote.

    I wish you well.

    ReplyDelete
  65. this is nonsense😁i dont do pigin english

    ReplyDelete
  66. Don't try marrying that man. You've seen all the signs that you will surely regret that union. I know loneliness is not easy and I'm not one to judge but marriage is a big deal and moving countries an even bigger deal. If the man is not worth it please don't do it because it's misery.
    All the best as you make your decision.
    NB: If your problem is how to break free my sister are you a learner? Wait for him to offend you next and hold on to it, don't accept his apologies, tell him you need time to reevaluate the relationship and from there my sister pick race because this is one chance o.

    ReplyDelete
  67. You all pretending you can't read D pidgin, how work for una side. Abeg English Don bring gbagam on una alert. They form nonsense on this blog.

    Poster abeg which work you do to take kill small dog, na that one struck me. Abeg leave that guy jare. Everything is showing red flag.

    ReplyDelete
  68. In as much as I like the abroad I won't advice you to marry him...
    And if you want to marry him bcos of abroad are you ready to stand alone cos this kind of man won't support you financially and Oyo is your case, so think well and don't do something you will blame yourself for life...

    ReplyDelete
  69. First make I applaud your pidgin style. I carry hand up for you. Sister, loneliness is a biatch! But you will miss your lonely life when you marry this lousy excuse of a man. Abeg take your time find person wey correct small. But make I tell you true true, no be because of you this man dey come Naija? Nor be jeje e Sidon wey you nag am say make e come back home? You nor realise say na mental patient before he send ring? Omo, dis man go vex o. Pray make e no bring gun come Naija as dem Akata dey behave, make e no go fian you.

    Omo, that man must not come toh you o. Send his ring back. Apologisee to am say no be hin, na you. Say your pastor say your enemy go need deliverance that any man wey marry u now go just slump die! God forbid o. But na so u go talk am, say u dey go enter prayer house for one year with serious fasting.

    God go help you oooooo.

    ReplyDelete
  70. Nice one. Talking about your command of pidgin. One of the best I have read so far. No mind those forming tush for pidgin but their gbaguns are always outta this world.

    Okay back to business: plenty k-leg dey for the guy foolowibg wetin you don write. At his age, he should be more settled than what you have written about him. Not a pushover. Make your findings about him. Look before you leap. You are not too old to act desperate naa.

    ReplyDelete
    Replies
    1. I like her write up. I smiled all through while reading it.

      Delete
  71. Signs are everywhere, use your head

    ReplyDelete
  72. Funny enough I think the writer has a good grasp of English language. She just wanted to write in pidgin
    She's talking about red flags and not being on same wavelength.
    Her pidgin chronicle was well constructed because she has a good grasp of English language. Did you see where she repeated verbatim the words on the man's tshirts which she didn't like?
    Poster, leave the man Abeg. You deserve so much better than him. You may think time is going but God's time is the best.

    Six things to start praying about NOW

    ReplyDelete
  73. Love love the pidgin,my sis u too old to fall mumu for this matter and too young to dey show this level of depression for marriage matter,if we wey marry people we think say we over know sef,marriage no easy like that 4 us,take am jeje,better man go show,this UK papi na 1 chance of so no enter

    ReplyDelete
  74. Love love the pidgin,my sis u too old to fall mugu, for this matter and too young to dey show this level of depression for marriage matter,if we wey marry people we think say we over know sef,marriage no easy like that 4 us,take am jeje,better man go show,this UK papi na 1 chance of so no enter

    ReplyDelete
  75. It wasn't easy but I think I understood it to make some sense out of it.
    Actually 48 and not married is not unusual in UK. I won't advice it but I know it's very possible. However one thing About UK based guys (am specifically referring to UK because that is what am familiar with) they are stingy with their money. It's doesn't come easy and if you're someone that works for your money honestly. Departing from it is kind of hard. This guy has major red flags, don't ignore it.picture of large booty women on his Facebook, @ 48 (really?) When he's not 21. Even 21 that does that is not common and I see that as being childish. Doesn't go to church. (Hmmmmm). If he's not family oriented now, he definitely won't be after marriage. Am tired enough talking. Please last words. In my opinion, the guy is a no no

    ReplyDelete
  76. Wallahi, this is simply my best chronicle write up ever.. I so much enjoyed reading it cos i read it 3times, i believe its a contract marriage

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141