Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post . Couple Wey Their Wedding Video Go Viral Talk How Dem Meet And How Dem Love Each Other And Decide To Marry

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Thursday, May 19, 2022

Pidgin Post . Couple Wey Their Wedding Video Go Viral Talk How Dem Meet And How Dem Love Each Other And Decide To Marry

Make you Never say never!

The Married lovebirds tell BBC Pidgin how them meet and as their love shack them, dey rush marry.....









Husband

Since wey dem born me woman no dey hard me to get, na the gift wey God give me. People wey tall sef wetin God give me, e no give them. No be jazz no be anything na just se dem like me


When I dey service, the most beautiful girls in camp for EbonyI State na my own, dem love me, dem like me.. Dem run after me no be because of money, I no get money.


My name na Efuoma Asigri Amos, a graduate of computer science. I'm a business man in Emede.


I first marry for 2018, we stay for two years before issues start, we no fit settle the issue, the marriage breakup for 2021 finally.


Wife:

The first time I meet my husband na prophecy bring am come no be se e come my house. As I go church nai prophet see the vision dem con tell me and aunty se make we come, we go, I say no problems.
We no reach six months before we rush to do marriage.








Husband:

Most times when I see my wife dey happy, I dey always thank God because of the kind of woman God give me, e don settle all my issues. I dey always admire her, I dey give her names like my gold, my sunshine, my mummy or Ome ,e means "that's my own"


When I wake up for night I see her, I go smile I go thank God, I go say whosoever wan put asunder the person no go succeed.


Wife:

For this earth wey we dey, God create some people tall, short, slim and fat nobody get comma for this life. My husband na very kind man, e dey take care of woman, very jovial, pet woman, anything wey you want e go give you.

When I and my husband bin wan marry, my friends and family no talk anything like se " na that short man you wan marry?" Dem no do like that. My sisters, uncles, parents and everybody support us.


Husband:

When i look the past, the suffer, the pains and tears wey I go through compared to this one now, this one cover the pains , the tears wey i face because God don silent the insult. People talk se I no go see another woman marry as the first one go, na the one dem design for me but I tell dem say dem no be God, na God I put my trust, na him get the final say, who go fit do anything to Amos and Hope.


from: BBC Pidgin




 


 

25 comments:

  1. May God bless your home

    ReplyDelete
    Replies
    1. They look so happy. Hml to them.

      Delete
    2. Why would a Prophet see vision on whom you'll marry and invite you for it???
      Why can't all these Prophets see visions concerning the state of Nigeria???

      Delete
    3. 'Prophet' is involved in this marriage??? No wonder!

      Delete
  2. May God keep their love and make their marriage a happy one.

    ReplyDelete
  3. Urmm, I heard 'they' are well endowed where it matters. Yay!! Who stone me ?! 🏃🏃🏃

    ReplyDelete
  4. I watched the interview on bbc, the guy loves the lady so much but from what i observed, the feeling is not mutual. I wish them all the best sha.

    ReplyDelete
  5. More love and happiness in your Home. Amen.
    Bbjac

    ReplyDelete
  6. God bless your home.


    PS. y'all be nice today cause the weather is so calm.🤗🤗🤗

    ReplyDelete
    Replies
    1. And we will do just that 🙁

      God bless una home

      Delete
  7. Ok ooo. Make the love continue ooo

    ReplyDelete
  8. Congratulations to them once again

    ReplyDelete
  9. Rove nwantitin.
    Congratulations to them o!

    ReplyDelete
  10. God bless their union. Every one should marry their kind.

    ReplyDelete
  11. May their love stand the test of time.Congratulations

    ReplyDelete
  12. Happy married life to them

    ReplyDelete
  13. This prophet dem call
    Hope no be way she marry am cause of prophet

    ReplyDelete
  14. Congratulations to them

    Love is sweet

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141