Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Uncle-Paytional Hazard!

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, May 27, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Uncle-Paytional Hazard!

 




Kpoi! Kpoi! Kpoi!


Na who dey house eh, una fellow SDK Yardflix pipu? I greet o!


Stellacapuchino...I hail o! How terrain, e gallant?!


Na customer house I dey, wey my phone begin vibrate...Oga harvest send me message, make I quick come yard! I fly okada, land!


He drag me enter room, lock door! Na im I look behind am, see woman wey carry octopus hair, vulture nails, paint mechanic oyel for face!
Chineke! Wetin be this? Hooman or forest spirit?!
Wetin hapun?! Where you from see this kain person? You never settle your village people?! Den send am come?!


Nne, Na Oga harvest carry 'learner' olosho come house on top N2k5 discount! He say hotel room too cost! He say he 'pless' engine finish, he nor know say the girl nor too get shock absorber! Small time, that one begin wriggle in slow motion like person wey wan manifest!


Oga harvest wey make one girl carry shoe, run comot for yard like say na Bush Baby dey pursue am! He nor jor gather the fear of God! He go spend the last kobo for wetin he pay! He nor dey ask permission to shift tins! Mba! Na offence to even ask!


I quick call Matron, she show with her staff to come carry learner go clinic!


Na im one Aunty, wey forget her rope and bucket of grass for house, Enter yard begin shout. She say make Oga harvest bring the new olosho wey him carry comot from hotel come out o!


Landlord wake, come tanda for balcony say why the stupid geh enter him compound dey make noise?!


Aunty face landlord say, Make he no vex say she thief him hand chain, the last time wey landlord come knack on credit Say but make he keep him 'Asparagus' far from her! *clickstongue* 

Landlord begin find him teeth wey fall comot for ground!


I face Aunty, wetin hapun?

She say Oga harvest don book am for the evening, he no come show! Say she don cancel other appointments so he must either do or pay!


Matron comot from inside Oga Harvest room, face Aunty say ' no be you I still dey treat for Hepatitis, I say make you no near man! You no dey hear word?!I go use police arrest you o!'


The two staff dey carry learner comot, na im landlord shout from upstairs! He fly staircase come down! Tundun! Tundun! I say you sabi this one too?! Landlord say na him Niece! *cough*

Be like say na that him house for Uk(raine) she sabi, abi? That one see dey!


Nne, na Landlord Sugarbaby wey him dey sponsor for Yabatech o! I say All well 'is' Good! Aftohroh na IT she kukuma come do for Oga Harvest factory! All na Occupational hazard! Money never waste!


Abeg mah go buy card tell Mama Ejima wetin her baby daddy don cause for yard. Mah buy #500 resharg! To talk the one wey she ask me join the one wey she nor ask! Yard dey too peaceful abeg! *clickstongue*





Haahahahahahahahahhahahahahahahahaha The olosho wey Oga harvest carry nah Landlord ' cousin' wey e dey train for school?hahahahahaha

10 comments:

  1. Hahahahahaha no be small learner olosho

    ReplyDelete
  2. Are these stories real at all? Really entertaining sha, keep it up.

    ReplyDelete
  3. 😂😂😂 your column is always interesting and that your compound na another house of commotion 😂😂😂😂

    ReplyDelete
  4. Hahahaha no be small thing

    ReplyDelete
  5. I bn dey bad mood since morning 😂🤣😂🤣😂🤣

    ReplyDelete
  6. 🤣🤣🤣🤣😂😂😂😂

    ReplyDelete
  7. Hard to follow, not the pidgin but the speaking/writing pattern

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141