Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - The Remote

Pages

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, May 16, 2022

Sisi Senaponi's Corner - The Remote

 WOW....





Una doh ooo!!


Stellamamalade.....You do well!


Landlady don land e!

 I say wey picture from the omugwo? She say phone don break! I say why your body nor dey smell of baby powder, abi na Adort you go babysit? She hiss comot my side, climb up!


She never hear anything about our new regime, she carry west climb stairs like turkey wey egg hang for him behind!


I still wan tell am how Bobo go collect food from Timo hand, even beat the pikin join! Food wey Mama Timo send am make he carry go give customer o! Mama Timo don mark am!


He nor too teh, I begin hear shout! Who carry the provisions? Na who carry her gold?! Landlord sidon for balcony, wear glasses dey read back of Bible.


Bobo open door, everybody take cover! He say who be the nuisance wey dey disturb him 2o'clock sleep! As the 2year old pikin wey him be! *clickstongue*


Landlady carry phone, call boys, Boys enter yard, Bobo carry beer give dem!.. Na card boys dey follow Bobo sidon dey play since!

Bobo say where the Semo and Eforiro wey he say make him ancestor cook for am?! I say make he nor worry, my dispatch go soon land!

I been arrange with Mama Timo ahead ahead, as she kukuma get Canteen! Timo don carry food come o! The semo hot no be small.


Bobo say make boys dey go! Say he wan lem the semo join him first lady! He balance chop well!


Stella, Na wake we wake for morning, wey bobo dey sweep compound!

 He prostrate give landlord! 

Bobo help Landlady fetch water! Help me fold my clothes for wire. He ask if anybody wan go market???....Eleeeeeee!


Mama Timo say their yard too far from market, she wan come collect room and parlour for our side! This our God na real wonderwonder!




Hahahahahahahaha so Landlady na juju woman be that......Where she go since sef!


9 comments:

  1. 😁😁😁@landlord wey dey read back of bible. bobo regime don end sharply

    ReplyDelete
  2. Bobo has been jazzed🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  3. 🀣🀣🀣🀣🀣🀣🀣🀣🀣,dibia pass dibia.

    ReplyDelete
  4. 🀣🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  5. Lol. Sisi darling, you're doing wellaπŸ‘

    ReplyDelete
  6. So bobo na all mouth 🀣🀣🀣. Abeg which one be he dey read back of Bible hahahaha

    ReplyDelete
  7. Na Sisi jazz am Stella...Sisi na badt geh...😁😁😁.

    ReplyDelete
  8. Na mama Timo put jazz for food

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141