Na on Tuesday morning, di tori start to flood social media afta fellow musician, Esther Igbekele post about di mata for her Instagram page.
For her caption she write say, "RIP Aduke Gold. A General don fall."
Dis dey come four months afta anoda gospel artiste, Morenikeji Egbin Orun.
One video bin trend on social media wia one man bin tok say "finally, UCH release Aduke bodi afta several hours of shouting, screaming, dem finally release am".
Tok-tok pesin for UCH Funmilayo Adetuyibi tell BBC say na dia hospital Aduke Gold die and also chook mouth on di video wey bin trend on social media.
She say di pipo wey dey di video bin dey para say dem no quick write Aduke Gold death certificate.
Adetuyibi say wia Aduke Gold die no dey in care of di doctor wey family bin dey ask for di singer death certificate.
She say na wetin cause delay in writing death certificate, wey make di pipo dey para.
"She bin dey go through diagnosis, na in di process of di diagnosis she die. No be ward or theatre she die. I no fit disclose too deep into her medical record".
from BBC pidgin

19 comments:
Such a painful loss
So sad 😢
May her soul rest in peace
So sad! May she rest in peace.
So sad,rest in peace ma'am 😔🙏🏿
May her soul continue to rest in peace
Sad 😔
May her soul rest in peace
Rest in peace God's minister. I do much love the performance she did with tope alabi sometimes last year, she's a talented gospel musician, indeed it's a heavens gain
May her soul rest in peace. Amen
I'm wondering why you would use pidgin for something so sensitive. It's bad enough that pidgin is difficult to read for some of us but this looks like mockery than just a post.
My opinion.
May her soul rest in peace
it's well.
Anon, hope you saw the last line?
It wasn't SDK reporting but BBC pidgin
May her soul rest in peace
Rest well Aduke🙏🙏
Hello iya Boys
May God grant her rest
May her soul rest in peace
So sad,may her soul rest in peace
May her soul rest in peace.
Anon 13.58,read to comprehend,there is what we call BBC pidgin,they wrote the narrative not SDK, plus it's good if you go learn pidgin to help yourself.
Post a Comment