Na serious matter o!
The Ikeja Special Offences Court don grant serial liar Blessing CEO ₦20 million bail for the property wahala wey dem say reach ₦69.15 million.
Court talk say she gatz bring two sureties wey go show say dem get money reach that level. Dem go even screen Blessing and her sureties for the Lagos State Judiciary Bail Information Management System to avoid stories that touch..
As if that one no do, court don tell Immigration Service make dem hold her passport well well make she no fit waka comot Naija till the case finish.
EFCC carry her go court for stealing and obtaining money by false pretence, but she say she no guilty.
Case don shift go October 12 for continuation of trial.
Na so e be.

Na wa!
ReplyDeleteWahala jam problem 😂
ReplyDeleteNa wetin she find naim she don dey see so, I no pity her at all.
ReplyDeleteWahala be like werin again ?
ReplyDeleteWater..e dey flow 😀
DeleteI don't understand how someone will steal 69m and they will grant bail of 20m, please who will be kind enough to explain to me... what will happen to the 69m?
ReplyDeleteBail money has nothing to do with the main sum.
DeleteBail money is refundable until the case is determined.
DeleteVery good
ReplyDelete