Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - The Heart Breaker

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, July 04, 2022

Sisi Senaponi's Corner - The Heart Breaker

 Sisi!!




I hail o...my pipu dem dem!



Stellacoco...How market? I greet o!

Oga harvest gist me as his friend Oga Tobe, like to dey attend youth churches. To dey collect flyers dey sweet am as na fine fine ushers and co-workers dey full there!


One time Oga Tobe jam one Sister Chi wey evangelize give am! He follow her go church.


He form sick one time, she carry fruits go give am for house. He open door make she enter. One thing lead to another, Sister chi backslide, begin sleepover, comot man house for 5am before neighbours go wake! Clean and cook like maid.
Oga Tobe chop Sister Chi finish, without cutlery, clean mouth! *Choi!*


He begin wink eye for another Sister Bleh inside church but this second sister no gree enter room with am! She say na until after marriage stulvz *sharp geh*


Na one day the second sister invite Oga Tobe, say one member dey do small get together for him compound!


He dress follow her go like couple something!


They reach there see all the single female workers for church and their Pastor wife.


Oga Tobe say they sidon seperate from the female, and na each sister carry man come.


So men on one side, women on the other side facing the Pastor Mrs like small meeting.


He say na Garnished Goat meat, stick suya and fruit juice dey display for the table as the men dey pick and chop but the females no near the table at all.


He say heat begin catch am inside 'AC wey go kirikiri' like Goat way him kukuma be! The minute the Pastor Mrs call the first Sister Chi wey he chop clean mouth, and she use bad eye look him side as she waka go front, guilty conscience wan kill him for chair!


Pastor Mrs ask Sister Chi where her 'contribution' dey?! She point Oga Tobe where he sidon say but he no gree stay with her, he chop and go!


Pastor Mrs say make Sister chi stand for one side, she call the second Sister Bleh, make she bring her contribution. Sister Bleh come drag Oga Tobe go front as her contribution!


Oga Tobe say na so Pastor Mrs talk say she see say this Brother Tobe na 'he-goat' wey wan chop the two sisters and use him 'something' scatter the lives of other sisters! *eleeeeee!*


Na so Oga Tobe say the brother wey be Head Usher for church, carry big matchete give Pastor Mrs. He say he wan move but his leg gum for ground!


Pastor Mrs come tell the two sisters say 'will they agree to divide the brother and share him equally?'
The two sisters say 'No problem, make Pastor Mrs turn the brother to the He-goat wey him kukuma be!


They say first sister go collect the head and the second sister the rest of the body as na she bring the man come the service, sorry meeting! *kiikiiikii*


Oga Tobe say as they wan use the matchete cut him head, nna ehn, na oga harvest wake am for sleep say sister Bleh dey find him outside, say time don reach to go special program!


I laugh throway leg up! Jesus abeg! I nor fit stop the laugh. E pain me say na dream! Na him blokos dey suppose use do stick meat!


Oga harvest say since then, him friend say he fear women pass anything inside life! He come genuinely repent and even join workforce for real church. You see this God ehn, if he wan align person wey dey misbehave...na kpakalam!


I say make Oga Tobe better thank him mama for village! Na so he for Jor dispatch to unpatch!


Make i go greet Mama Nedu, she travel go see her in-laws. Una doh o!

11 comments:

  1. Hahahaha. This dream sweet me. At least he don repent. You self Sabi give Stella different names. Every week different names. Twale for you oo

    ReplyDelete
  2. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  3. I love your stories. Keep them coming 👍

    ReplyDelete
  4. Hahahahahaha God arrest am well

    ReplyDelete
  5. lol interesting...Nice one....Thank God say oga Tobe finally repent...

    ReplyDelete
  6. Dem for use oga Tobe blokos make stick meat 🤣😂🤣😂

    ReplyDelete
  7. So funny ... . ..Josaria

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141