Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponis Corner . -Permanent Side Chic And Ignorant Wife

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, October 03, 2022

Sisi Senaponis Corner . -Permanent Side Chic And Ignorant Wife

 Laugh no gree me...

Hehehehehehehehehehe


 




Una doh o! Na who dey we yard fa?!


Stellacomprehendo!...how dey area?!


Una see Nepa?! Be like say rat or rabbit don chop our transformer wire this time arand. Na to go on Lantern level be that as usual!


We sidon aside dey collect fresh air!


Na im we begin hear as next compound people begin drag person for their side!

Na wetin happen?! Bucket begin fly left, right, and center!


Na as Mama Ejima wey like fight pass anything dey stretch neck, na so wrapper fall comot for her body! *sideeyes!*


Without shame, she wan bend for my front direct to carry the wrapper!

*God forbid bad thing! This her under wey don carry plenty destinies enter one chance!*


Abeg o, shift that side before you bend biko!


She tie wrapper and still waka go next compound to see wetin dey happen. Hian!

My antenna nor dey mood this night abeg, market jor get as e be!

I kukuma wait mah hear the matter wey she go carry come!


E nor reach five minutes wey the tone for that side change! They don break person head with stool!


As me sef rush go there, na Mama Ejima I see for grand with head wey blood don cover!

Na so we rush her go Matron side!
They help her sew the thing together!

All these one, na still with that singular wrapper wey she tie comot for house o!

I say how you go dey comfortable to carry only wrapper comot for house?!
She say no be just next compound?!


I say e nor matter! What if na police carry dem for next compound, na so she nor go wear payint enter kirikiri so!


We still dey discuss the matter when Matron begin try use eye to discharge one Aunty wey enter the clinic!

Me I see the signal, so I shift curtain make I see wetin she dey try code!

The Aunty get belle like 8months to almost due sef. Matron say make she dey go her family house, say she go come see her! As she just enter town!


I say Matron why you wan stress this Aunty Na, I quick pull chair make she sidon!


Na there Mama Ejima dey follow the Aunty gist o! She say her husband nor dey around but them dey talk for phone well well! *sideeyes!*

Mama Ejima begin give her gists of when she sef first born twins!


I pull Matron one side, I say no be who I think the Aunty be, she be?! Matron say Yes!

Nna ehn, anor fit close mouth e!


The Aunty dey befriend Papa Ejima from long time before he marry Mama Ejima.

This Aunty wait, wait, say maybe he go come marry her!


Na when she hear say he don marry another woman for Ilorin and even bring her come Lagos, the aunty give up! Wey she go the abroad but her parents house dey we area.


She still nor gree marry all those years, as she don pursue all her suitors comot! Now wey age don dey her side, she come carry belle!


I say how she do am?!


Matron say na person wey God don write with her from 'beningin' still get the belle! 

Udonminit!

You mean say na..? ...as in na...? Matron wink me eye. *chineke!*

I say shey she sabi the man wife? Matron say Yes na! But na the wife nor sabi her! *choi!*

As i dey watch as these two women dey laugh, dey gist...i just begin wonder wetin fit happen, if Mama Ejima know the identity of the person she dey follow relate?! *ololololoooo!*


Nna ehn, Matron quick sort Mama Ejima out and we begin waka go house!


I ask her where Papa Ejima dey? She say he suppose don come back house before we reach sef! I say make we wait keke, she say na to leg am go pay us as night don come!

Na im i ask her say wetin be her advice for person wey wan snatch person long time man?!

She say na the other person wey get the man nor sharp! I say very wonderful!


We reach yard true, true, Papa ejima don sidon aside begin wonder why we never reach since we comot Matron side. He say he call Matron to know if everything dey ok.


Na so i look the man, anor even fit talk wetin dey my mind. I jor carry my stool, enter house!


Na from inside i hear Papa Ejima say he wan quick collect something for next street! *sideeyes!*



Hahahahahahahahahahahahahhahahahahahah ohmy goodness i don laugh tire!

22 comments:

  1. You mean say na..? ...as in na...? Sisi you be correct ameboπŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚. But why some men be like this? Mama ejima don get step child but she nor know. Nawaa oo.

    ReplyDelete
  2. Amebo wey go harvard be this o,sisi I hail o

    ReplyDelete
  3. This is too funny. You write so well, laugh don finish me

    ReplyDelete
  4. πŸ˜†πŸ˜†πŸ˜†

    ReplyDelete
  5. Hmmm,woman na the enemy of woman.

    ReplyDelete
  6. πŸ™†πŸ™ŠπŸ˜‚πŸ™ˆπŸ˜…πŸ˜‚

    ReplyDelete
  7. Sisi u too like amebo nawaoooh, that woman that is pregnant is very stupid, with papa ejima too, they are both stupid, what if the bubles bust wetin them go do

    ReplyDelete
  8. Inside life...wetin una no want make papa hear, na papa go still settle am.

    ReplyDelete
  9. Your amebo na top notch πŸ™ŒπŸ™Œ

    ReplyDelete
  10. Mama ejima don get her own amebo for her doormot. Make she no dey go find gist,this time the gist na from her hause.

    ReplyDelete
  11. Nawa ooo. Weytin sisi nor go see for yard

    ReplyDelete
  12. 🀣🀣🀣🀣🀣🀣 sometimes, when am bored or sad, I go back to read previous ones. I love this column so much. Never a dull moment. Wow πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  13. 🀣🀣🀣🀣sisi is a first class amebo

    ReplyDelete
  14. 🀣🀣🀣🀣 Sisi you be correct amebo. Papa Ejima want to go and see his pregnant side chick. I pity for mama ejima o

    ReplyDelete
  15. 🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  16. Oh wow. Why get pregnant for another's man tho??

    ReplyDelete
    Replies
    1. E dey pain you? Na ya man dem get belle for? Abeg shift

      Delete
  17. 🀣🀣🀣🀣 AMEBO
    But the man na useless man o. Why he nor marry the woman na? He marry another person finish, con still go impregnate that one again.

    ReplyDelete
  18. New word alert
    "Beningin" Sisi u get first class for amebo. Amebo wey be like amala, ewedu, gbegiri and assorted meat.
    Mama Ejima o.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141