Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Madam Sand Packer

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, November 25, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Madam Sand Packer

 Eweeeeeee....



Kpoi! Kpoi! Kpoi! Una yard pipo, i hail o!

Stella-octavia-lepanther! I salute o! How makeit?!

People gather to settle kworeh..wetin happen?


Na the Madam and her Housemaid wey near my customer salon!

The woman say make the girl dey go!

She say she nor dey go anywia! Make madam give her her dross!


Madam say na she buy her the dross and she fit seize am!

Hian! Dross wey the girl don dey wear already?

Wetin you wan use am do! Give her make she dey go na!

Na so their neighbour wey be retire uniform oga, say why dem dey use shout disturb him sleep?!


They carry the matter give the man!

He say make the woman give the girl her dross!

Small time the Madam say ehn, make the maid stay!

Maid say at this point, mba! she wan go village say Make madam call the agent wey bring her come lagos!


Madam nor gree to call agent.

People join mouth collect agent number! Less than 15mimutes, agent land!

Na im the maid and agent begin speak their language! They nor know say the old man neighbour sabi the language!

The man say whaaat! So na the kain evil wey the woman dey do be that?!

Akon reposition near the old man, na before the revelation agive the man radius, as i know say he get shakabula for house! Aneva ready to use ear collect wetin anor know biko!

The old man say make the maid enter house go bring evidence!

Na im she commot with calabash wey sand full inside!

People don dey hiss say na normal something!

Una know say if our people nor see blood, dey nor dey reason say the matter serious!


The agent speak language give maid to break the thing for grand!

The Madam begin shout, dey beg ooo! Make dem no destroy her life!*chineke!*

Madam wetin dey inside this calabash? She say na ordinary sand o!

Ok if na ordinary, why you come comot wrapper and gele?! Slippers sef don fling reach bustop!


Ngwa, ok go pour the sand inside gutter?! Before we say Judas collect bribe, this woman wan comot bra! Abeg! Abeg o! 

This kain early morning!

Maid say na lie o say Na sand from front of people shop! Say na midnight her Madam dey enter market go pack sand, Say she dey escort her sometimes!  *choi! human beings e!*

Half the people wey gather to give Madam morah, to fling the maid comot, na im the maid point say her madam don pack sand from their shop! 


God abeg ooo!

Their business wey dey boom before don drop, na madam turn hersef to LAPO wey dey borrow dem money! Money wey dey nor dey fit repay or do anything tangible with!

Ania the maid say biko, una reash our area? She say na turn by turn, our own na end of that month for calendar! *eleeeee!*

Na one of the women drag the calabash wey she smash am for grand!

As calabash land grand Na im madam faint!

Aneva hear where police dey put mosquito net inside cell!

 I dey come! Yard hia raikom!

19 comments:

  1. Sisi Senaponi, i suppose buy you gift this xmas 😂😂😂

    ReplyDelete
  2. Na wah oo, Sisi thank God e no reach ur area.

    ReplyDelete
  3. She wan use the maid pant do juju as she Collect the pant ,she no want make the maid go because she will expose her.so she bin wan kpai the maid if say she no go.

    ReplyDelete
  4. People wicked aswear. See wetin "madam" de do her fellow human beings. Na dross na im come open her nyash outside so.

    ReplyDelete
  5. 🤣🤣🤣 Sisi you too much o

    ReplyDelete
  6. Ha!!!... Stella hia raikom🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  7. For Lagos city, things dey happun o. Na to shine eyes and hold God well well!

    ReplyDelete
  8. hian!! this world is so full of evil. Chai! See wetin pesin enter becos of money wey she go die leave

    ReplyDelete
  9. Ohh Sisi! Bless you for being such a mood lifter

    ReplyDelete
  10. Things dey happen, thank God she has been exposed.

    ReplyDelete
  11. Things dey happen oh,sisi the area amebo thanks for the info.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141