Stella Dimoko Korkus.com: The Hustle Post....

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Sunday, August 09, 2020

The Hustle Post....

The newly introduced Hustle post.....
We will keep Hustling until our hustle pays off........





207 comments:

  1. Hustling is very important, one day it will pay off.. God no go shame us

    ReplyDelete
  2. Hustle oh so when you see people spending lavishly you will not be saying vanity upon vanity.....WORD

    ReplyDelete
    Replies
    1. You say you be actress, but na for only SDK blog we dey see your pictures, Hanty hustle hard.

      Delete
    2. 🤣...hustle make conductor no wed you with another passenger because of change

      Delete
  3. Too blessed to cursed9 August 2020 at 13:08

    Hustle o make your neighbor wey go work no turn you to nepa notifier!
    Oga sunday abeg what time did they bring the light last😁😁😁

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hustle oooo, make your parents no think of switching you now when you don old sef.... because you no dey show any potential/ positivity.

      Delete
    2. Oga Sunday, which time them take light 😀

      Delete
    3. 😭😭😭😭🤣😭😭

      Delete
  4. Too blessed to be cursed9 August 2020 at 13:10

    Hustle o make you come sdk blog to hustle for money ontop best hustle coat😋😋😋🏃‍♀️🏃‍♀️🏃‍♀️

    ReplyDelete
  5. My brother hustle ooo,make dem no dey always add your name to "and others" when they call/list names of people you're in same category as if their tongue will twist if they call your name or the ink in their pen will dry off if they write your name.

    ReplyDelete
  6. Replies
    1. Your body dey hotttt as you no see tithes and offering collect, pastor "calm down" and find another hustle oooo.

      Delete
    2. Hustle oh,make girl no tell you say i am mentally attracted to you,But i can not date you...Na money be fine bobo.

      Delete
    3. Lmao @ mentally attracted to you 😂😂😂😂😂😂
      Bye Gigi

      Delete
  7. my sister hustle,get name and career for yourself,fela Durotoye and Tara life suppose fit you too,not everytime Otedola and wife case,get life my sister

    ReplyDelete
  8. Hustle o make you go overseas for emergency medical attention because of leg pain

    ReplyDelete
  9. Hustle o make your children no ask you what you were doing when your mates were making money

    ReplyDelete
    Replies
    1. 😂😂😂God no go shame us

      Delete
    2. Hustle, Hustle, focus more because I never met a dollar I didn't like.

      Delete
  10. Hustle ooooo make you no reach fast food hear price begin dey ask for okpa.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Na money dey make man wey ugly fine. My brother hustle now and hustle hard oooo.

      Delete
    2. @13:21
      The Okpa is more nutritious that your vain fast foods.
      How can you compare the nutrient value in french fries,
      pizza and burger to our great okpa. All those fast foods
      are called junks, by people who are enlightened.🤦🏻‍♀️🤦🏻‍♀️🤦🏻‍♀️🤦🏻‍♀️🤦🏻‍♀️

      Delete
  11. Hustle 💪🏽ooo make them no collect your so possible girlfriend then you go con dey explain the Tory give everybody for 🍺beer spot like one Huncle laycoooon

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hustle oooo, make rich man pikin no come dey do anyhow for your front.

      Delete
    2. Taa,you are not even current,did you watch last night's party?

      Laycon is a potential inlaw now.
      He chop luscious kiss.

      Delete
    3. 🙄🙄🙄🙄 King! King!! King!!!, how many times did I call you? We fit enter boxing ring for this blog, man.

      Delete
  12. Hustle make you travel abroad for common neck pain, because This life no balance at all.

    ReplyDelete
    Replies
    1. 😂😂😂 e no balance at all

      Delete
    2. Hustle oooo, make SDK no dey suspect say you wan scam her.

      Delete
    3. @Jerusalem
      Abroad is not heaven.
      So no big deal about traveling abroad.
      😏😏😏😏😏

      Delete
  13. Hustle o make you no go trek away your shoe sole because you wan cut out #50 from the bus fare!

    ReplyDelete
  14. Hustle so that u will not be saving up to buy five alive.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hustle oooo, make you dey fly go Dubai if you wan treat neck pain.

      Delete
  15. Hustle ooo, so that your family will not eat 101

    ReplyDelete
    Replies
    1. 😂😂😂God no go shame us

      Delete
    2. "Adama Indimi weds Prince Malik Ado Ibrahim" hmmmmmmm, my people hustle oooo make your wedding enter business section for blogs/forums.

      Delete
  16. Hustle oo make you no fellow Dem dey say na small difference even Dey between olumiri rivers and Jacuzzi “ all na water💦 “
    I put it to you ma Broda difference dey

    ReplyDelete
    Replies
    1. 😂😂😂😂 d difference dey no be small

      Delete
    2. Hustle oooo, make you no get your ancestor as your in-law.

      Delete
  17. Hustle make you no go call children wey you follow go marry their mama sir/ma

    ReplyDelete
  18. Hustle ooo make you no go dey press Stella P A neck for night on top give away

    ReplyDelete
  19. Hustle ooh, so small children no go address by your name instead of aunt/Uncle

    ReplyDelete
  20. Hustle make you no use because of #50 dey follow one passenger dey find change.

    ReplyDelete
  21. Hustle oo, so when you travel for Umuada/Umunna meeting they won't ask you to share food for people your older than.🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  22. Hustle oo make you no dey focus your energy on ass licking

    ReplyDelete
  23. Hustle oooo, make your pikin no hate you because you born am for Nigeria. This country no be am.

    ReplyDelete
  24. Hustle oooo, make your wife and your mama no dey fight for who go sit in front of your car.

    ReplyDelete
  25. Hustle o,so you won't have 2 IDs on SDK blog to be receiving giveaway

    ReplyDelete
  26. Hustle o, so SDK won't read your mail and hiss

    ReplyDelete
  27. Hustle o,so that when your in law see your missed call ,he can even borrow credit just to call you back

    ReplyDelete
  28. you fit tell your shadow make him go hustle no be everytime him go dey follow waka. copied

    ReplyDelete
  29. A lot of people playing golf in Nigeria are hungry o. Na show off. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  30. Hustle o, so that one day SDK go give you sef a shout out like angel tee

    ReplyDelete
  31. I met this post today... hustle o so that you no go come SDK dey sound like fowl wey dey ovulate

    ReplyDelete
  32. Hustle o make dem no use tinted glass drive your gf pass you and you go tell them “hi”

    ReplyDelete
  33. Hustle o, make you no go mix palm oil for akamu sake of say you and your family wan drink custard.

    ReplyDelete
  34. 😂 😂 😂 😂 😂 😂
    Hustle oooo........
    My people hustle.

    ReplyDelete
  35. Hustle oo so when you get neck pain na to go aboard instead of buying 50naira Aboniki

    ReplyDelete
  36. Hustle make you park come out for that street wey doctor igodo 🌿 herbal cleaner big big-speaker no dey let una hear word

    ReplyDelete
    Replies
    1. Ahhhhh dis one haf destroy the table patapata I no do again 😂😂🤣🤣😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂🤣

      Delete
    2. 😂😂😂😂u dey vex today ooo

      Delete
    3. King jerry why are you like this😂😂😂😂😂😂. This life no balance at all.

      Delete
  37. Hustle o make the Security man at Tantalizers Eatery walk straight to you to say 'Sorry Ma,please are you the one,that parked the Chrysler ride,someone wants to come out Ma'
    hahahahaha

    ReplyDelete
  38. Hustle so you no go see hair for another woman body say na waste of money she for use buy one plot of land.

    ReplyDelete
  39. Hustle o....make your children no dey sing that song :"Iya mì o lowo lowo sugbon mo lolorun". when they are frustrated.

    ReplyDelete
  40. Hustle so you won't say na mumu dey go boutique.

    ReplyDelete
  41. Hustle ooh so that you no go poison you children's mind say uncle dey wicked cos he refused to help you as no be him tell you to dey born like fowl.

    ReplyDelete
  42. Hustle o make people no use one particular top/shirt identity you🤣🤣

    ReplyDelete
  43. Hustle ooh so that your wife go dey always ask you durrrling do you want to eat before eating or you want to eat after eating.


    Lol SDK please pardon my craze...I am just happy today.

    ReplyDelete
  44. Hustle o o make Obasanjo no write letter to you o

    ReplyDelete
    Replies
    1. 😂😂😂baba can write letter sha

      Delete
    2. 😂😂😂😂. Obj's letters shaa

      Delete
  45. Hustle oooo make you no dey get energy to operate triple ID for SDK blog 😂🤣😂🤣

    ReplyDelete
  46. Hustle o o make your children dey shower not baff o

    ReplyDelete
  47. Hustle ooo, make your pikin no be your retirement benefit.

    ReplyDelete
  48. Hustle oo make dem call you Honey, sweetheart,Chairman na Papa Emeka

    ReplyDelete
  49. Hustle o o make dem call you Oga, Chairman, honey not Papa Emeka

    ReplyDelete
  50. Hustle o o make you enjoy madam for una bedroom anytime , no be for night wey una go dey check if una pikin don sleep for una to touchlight cos una dey sleep for one bed

    ReplyDelete
  51. Hustle o o make people no know say na you when you put slippers for domot

    ReplyDelete
  52. Hustle o make you reach the G-spot of your career

    ReplyDelete
  53. Hustle oo make you no send FOIHN as Stella or Ella becos of data giveaways

    ReplyDelete
  54. Hustle oooo, make your children no go dey type vanity upon vanity anyhow.

    ReplyDelete
  55. Hustle oooo, make your children drink all types of tea except pover-tea.

    ReplyDelete
  56. Hustle oo
    Make ur inlaw no dictate for u

    ReplyDelete
  57. Hustle ooo
    Make ur junior one no disrespect u

    ReplyDelete
  58. Na money dat makes people call u madam

    ReplyDelete
  59. Hustle oo make u no wait for danfo conductor to find your 10naira change from other bus

    ReplyDelete
  60. Hustle oo make you no fix emergency fasting as food no dey house

    ReplyDelete
  61. Hustle oo make people no see you as a begger when you wan ask for directions

    ReplyDelete
  62. Hustle ooo make u no hid bread on top ceiling fan

    ReplyDelete
  63. Hustle ooo make your neighbor no buy new TV ask you whether you go need the carton😂😂

    ReplyDelete
  64. Hustle ooo make you no carry screw driver or join two wires dey start you car.

    ReplyDelete
  65. Hustle oo make ndi obioma tailor no come dey call you customer.

    ReplyDelete
  66. Hustle make you no blame your past failures for future mistakes

    ReplyDelete
  67. Hustle ooo,make dey no tell you for party say rice dey but meat don finish.

    ReplyDelete
  68. Hustle ooo,make you no see enjoyment as waste of money.

    ReplyDelete
  69. Hustle ooo,make bank charges no spoil money wey you wan withdraw.

    ReplyDelete
  70. Hustle ooo,make you no shout say food never reach you for burial.

    ReplyDelete
  71. Hustle ooo,make your food no gree done because you use APC rice and PDP groundnut oil cook am.

    ReplyDelete
  72. Hustle ooo,make you no carry charger for neck dey find where they on generator.

    ReplyDelete
  73. Hustle ooo,make they no use sticker hide your face for selfie

    ReplyDelete
  74. Hustle ooo,make your soap no flat like sim card.

    ReplyDelete
  75. Hustle ooo,make you no burst into tears cos food no reach you for owambe.

    ReplyDelete
  76. Hustle ooo,make they no use your pikin act witch for school.

    ReplyDelete
  77. Hustle o make your mother no tell you say you are jealous of your younger brother wey buy car...

    ReplyDelete
  78. Hustle ooo,make they no tell you to stand up so that your rich younger brother go sit for family meeting.

    ReplyDelete
  79. Hustle ooo,make you no queue up for politician gate dey fight on top 10 cups of rice.

    ReplyDelete
  80. Hustle ooo,make your child no vomit garri for class.

    ReplyDelete
  81. Hustle,make you no dey use 0 1 0 formula for food.

    ReplyDelete
  82. Hustle make you no use two hands greet your junior.

    ReplyDelete
  83. Hustle ooo make you no buy agba añu mmiri car

    ReplyDelete
  84. Hustle make you no drag meat with your pikin

    ReplyDelete
  85. Hustle make you no wear suit,knot tie dey pursue danfo every morning.

    ReplyDelete
  86. Hustle make you no wait till garri swells before you drink am

    ReplyDelete
  87. Hustle make you no see Gucci and Versace symbol as satanic Satanism

    ReplyDelete
  88. Hustle make you no talk say buying latest IPhone na waste of money.

    ReplyDelete
  89. Hustle so that you go fit charter private jet from Abuja to Lagos for 3,100,000.

    ReplyDelete
  90. Hustle make no talk say people wey buy new car for Christmas na ritualists.

    ReplyDelete
  91. Hustle oo make if plenty people pack In front of a shop before you park they will leave them and attend to you first

    ReplyDelete
  92. Hustle make DJ no vex off music on your wedding day cos you still dey owe am

    ReplyDelete
  93. Hustle oo so that if you wear okirika or mass production people will be doughting that is not the mass production that your own is the original that person like you can't wear fake

    ReplyDelete
  94. Hustle make you no shout amen wey loud pass speaker for church for poverty prayer point.

    ReplyDelete
    Replies
    1. I hear you Pastor, Ride on sir, I claim it etc. Wahala dey. 😂😂😂😂😂😂

      Delete
  95. Hustle so that you will not be doing shoe alignment up and down.

    ReplyDelete
  96. Hustle make your trouser no tear as you wan climb bike

    ReplyDelete
  97. Hustle make you no talk say na only one game cut my ticket

    ReplyDelete
  98. Hustle make you no give visitor food dey pray make he no finish am

    ReplyDelete
  99. Hustle make dey no put you for okada collect change

    ReplyDelete
  100. Hustle make dey no dey ask you whether light don come since morning

    ReplyDelete
  101. May God bless our legit hustle. Amen

    ReplyDelete
  102. Hustle ooo,make them no dey use ur mouth as opener for family meeting...
    Hustle oo,make u no dey call every rich man ritualist..
    Hustle oo,make u no dey trek they go night vigin,come they say every big car wey pass that night they go occultic meeting

    ReplyDelete
  103. Hustle o before u go dey look for #500k u go pick from ground.Who one loss am?

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141