Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Covid 19 Palliatives Just Dey Fall From Heaven Like Manna..

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Saturday, October 24, 2020

Pidgin Post - Covid 19 Palliatives Just Dey Fall From Heaven Like Manna..

 One thing wey we no go forget be say this EndSars protest open the yansh of some people wey wear double nicker.......




My people, why Covid 19 palliative go full warehouse for everywhere for Naija and if the people open am begin pack,dem go begin shout say na for poor people dem bin dey save am for and dem bin wan begin distribute am now now before them begin pack am....

Na who wear Napkin wey dem dey tell all this tory?

If dem say na poor people get the covid 19 palliative,the people wey dey pack am so,no be poor people?

Make dem no worry about sharing am again,just drop all the address wey dem hide the remaining palliative put and the poor people go share am by them sef....

When hungry full everywia during lockdown,na two loaves of bread them give two street to share,the beans and rice dem share for plenty people no go reach ne household chop.....

Make nobody complain,make we take am say God open heaven,begin pour covid 19 manna for fellow Nigerians.......

Thank God oh....Abi blog visitors wetin be your say inside wetin i write so?

36 comments:

  1. E good as breeze just dey blow their yansh anyhow. Palliatives wey be say na the people suppose get, don dey sidon for warehouse tey tey. I bin see one video wey the pple wey bin tif the palliatives dey share am for some beggars. Una try jare.

    ReplyDelete
    Replies
    1. As in eh, dem over-try. The person wey hoard those palliatives, God go hoard im blessings.

      Delete
    2. Aunty candy abeg den no tiff the palliatives,den go carry thier own share ni as the thing don dey too tey for where government put am ni

      Delete
    3. Dem try, no be small. Dem dey like Robin Hood sef! Dat prayer wey you pray, Amiiiin ooo.

      Delete
    4. Chai!..Edo State one has just been found...

      Delete
    5. Christmas really came early for these ones.

      Delete
    6. Abeg sweetlurlacollections, no vex say I write tif o. Dem no tif am.

      Delete
    7. At least some pipo go see something chop this Xmas

      Delete
  2. LMAO, God thank You o for this protest wey Don open people nyash

    ReplyDelete
  3. My own is, so far it’s warehouse where the palliatives are stored! Scatter the door, pull down the walls, dismember everything dismembering. The people should loot it. Infact, whenever you are leaving home, always carry wheelbarrow with you, you never can tell where palla will jam you. It is your right. Take it by force. Anyone block your path, bounce them and move. Those items were sent for the poor masses but the rich and greedy decided to hoard it for their descendants up till the 10th generation. Evil and heartless Much!!!!

    ReplyDelete
  4. I truly hope they qre actually reaching the poor people now. Why is Nigeria like this. Its so depressing

    ReplyDelete
  5. No be lie. Na manner from heaven 🤭

    ReplyDelete
  6. This is the most positive thing that has come out of this whole protest. How heartless politicians.

    ReplyDelete
  7. Stella na true talk na im you yarn so,

    Yesterday i see one video wey dem pack money, pounds o, dollars o, euro o, no kain currency wey no dey dia, wetin pain me be say some of the money don tear finish, some don even burn, how some pesin wicked like dis? some people get long throat, and na wetin go kill dem.

    My anger this morning na governor Nyesom Wike, the padi man no dey hear wetin dey happen for oyigbo, i hear say some people wey wear mufti, they shot any young guy them see for road, them still dey kill kill people.

    People no see food buy chop, because this curfew take them by surprise, so dem no stock up there house, how long this curfew wan last? As for the fools wey dey blame IPOB, 600 years to una and una family, una dey hear me so? wetin concern IPOB for the matter? I no dey support IPOB but make una no dey yarn rubbish na, make una take am sufri dey lie na.

    Another one wey i hear na say Aboki people dey vex say them kill some of their brothers for that shoot out wey happen on Wednesday, so dem say Aboki people dey plan to come burn people houses for night when dem dey sleep, now every body eyes just dey open for night. why Aboki people dey like this? Na only their people don die since all this kasala burst?

    ReplyDelete
  8. I thank God for the manna. I received one pack of indomitable in Akure, Ondo state.

    ReplyDelete
  9. Na their cup full so, God come expose them

    ReplyDelete
  10. ANY WAREHOUSE WEY CARRY PALLIATIVE, MAKE DEN BREAK AM DOWN MOVE EVERYTHING COMOT.

    I DONT NEED THE PALLAIATIVES. I CAN AFFORD THEM BUT MANY PEOPLE CANT. WHY WICKED???

    WETIN PALLIATIVES FOR POOR PEOPLE DEY DO IN SIDE OBA PALACE? GOD GO PUNISH THESE PEOPLLW 100%

    ReplyDelete
  11. Naija matter don tire me abeg.

    ReplyDelete
  12. Useless, selfish and greedy man that called himself oba of Lagos, packed food ment for the poor, that's why God sent youths to disembark his house and steal his stool. Cos God is angry with him

    ReplyDelete
  13. The thing way dey pain me be say, warehouse no dey surulere axis.. Na one cup of derica rice remain for house and I need rice badly..

    ReplyDelete
  14. Manna dey fall for teslim house, Oluyole, wcci juncture Ibadan right now

    ReplyDelete
  15. All I know be say our leaders dey selfish and wicked,haba something we Dem suppose share for people.
    These people no dey shame at all. Imagine them talk say na protest make them no share am,abeg when protest start?
    I don tire for this country I no go lie.

    ReplyDelete
  16. 6 months after lockdown, various State Governments is STILL HOARDING PALLIATIVES! 😲

    It will never be well with them and their generations❗

    ReplyDelete
    Replies
    1. State Governments *are* STILL HOARDING PALLIATIVES! 😳 (sorry for my error)

      Delete
  17. Calabar nah 4 warehouses ooo

    ReplyDelete
  18. imagine good for them,make they pack every packable nonsense

    ReplyDelete
  19. Wicked people. This was the reason most households that needed palliatives didn't get help.

    The most Complex B

    ReplyDelete
  20. Well..word out there is that these items were donated by Alhaji Aliko Dangote few weeks ago to the various State governments.

    Dangote had to determine how it was to be shared, including the modalities and processes involved in sharing it. So it was taking time in getting all these sorted out.

    The various state governments were actually waiting for further instructions and clearance from Dangote so as to proceed with the sharing.

    ReplyDelete
  21. Stella babe breeze don blow for Edo state! The tin cast! see as food don dey spoil, our Governor say them dey keep am for poor people, you keep so tey he come dey spoil! I just loss respect for the man.

    Food full everywhere meanwhile people dey hungry! Why these people wicked like this is still a mystery to me.

    ReplyDelete
  22. Good. So please do not blame Buhari.We don see say Buhari dey disperse but your Governors or leaders meant to distribute to the populace.dey block am.

    ReplyDelete
  23. And Buhari’s ex girlfriend was there claiming she visited all the 36 states and all palliatives were distributed.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141