Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Lagos State Say Make All Pikin Sidon For House Until 'Fada' Notice..

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Tuesday, October 20, 2020

Pidgin Post - Lagos State Say Make All Pikin Sidon For House Until 'Fada' Notice..

 Lagos state government don drop press release say make every student for the state wey dey go school siddon for house until 'fada' notice,until them fit calm down Lagosians wey dey protest say make dem EndSARS and End Police Brutality for Obodo Nigeria...





Dem advice say make the Students dey learn how them dey learn since when Covid 19 lock dem put for house for many months.....

If students stay for house,dem parents nko?Dem go stay too or dem go go work?I dey ask because i dey wonder who go dey look some of these small pikins for house if them papa and mama go still go work?

Na to siddon look remain.

Una Doh Ooooh

Pidgin post go return!

26 comments:

  1. Replies
    1. When Freeze dey talk am sey “ ds year go rugged”, some people dey call am craze man. Freeze don turn seer as e prophesy over happen sef. Na wa .

      Delete
  2. Our children make una no wory na una future we de fight for.

    ReplyDelete
  3. Nigeria just dey turnioniown.. Make una wait, my question be say wetin happen to Nigeria covid, them no update us again... With d number of protester and notin do us since except for hungry,... Make una tell dem say make dem off mic

    ReplyDelete
  4. If mama and papa go to work,Who will take care of the children tho.Parent out there please protect your children oooo.

    ReplyDelete
  5. How man go do? Make dem commot children for road Tilly matter come down small

    ReplyDelete
  6. Stella,wetin happen to our dog now. Abi she dey protest too? This goat no happy to replace am o.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Abeg this goat naim get swag pass the dog, you nor see am tie wrapper,carry handbag and wear glasses😕 how swag dey reach again?
      By the way, how you know say the goat nor dey happy? You sabi speak e language???

      Delete
  7. One of my neighbor works in a public school.. She sef run reach house yesterday ni o due to the protest everywhere, she said parents kept coming one after the other to pick up their children at the early hours of the day.

    ReplyDelete
  8. Na wa.
    It is well with this country.
    Those that have paid Sch fees nko?

    ReplyDelete
  9. My children are excited even me that wakes up early to drop them off!..
    Abeg make this not pass this week oo..
    They have stayed home enough during the Corona lock down...

    ReplyDelete
  10. You see this news got me so angry,to think that my child just resumed yesterday o 🙄😡

    ReplyDelete
  11. Good the schools are shut. My whole family is home, hubby worked yesterday and heard nwii on the roads,his firm finally shut down too.

    There are lots of things to learn from home and online but for this week they'll be sleeping and playing first.

    As I type I'm the only one awake.
    Let them rest. This country na wa.

    ReplyDelete
  12. There parents go kukuma sidon 4 house too,bcs only them nor fit takecare of themselves.

    ReplyDelete
  13. 2020 na ogbonge year.things na pasa ka passat!!

    ReplyDelete
  14. good ooo as we no won hear story for anything wey go happen to those children

    ReplyDelete
  15. This year no come to smile but with God all things are possible. God, I know you're still in charge.

    ReplyDelete
  16. The school I teach in opened.Live in ilasamaja Lagos state

    ReplyDelete
  17. Madam Stella the tin tire person o..me wey dey always go out go hustle how I go do.as Dem pickin dey house na to lock them inside sure pass..I go prepare food for them,bath them lock them Waka go hustle so we go see food chop tomorrow.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Very risky..what if there is a fire outbreak?..
      No amount of money is more important than those children

      Delete
    2. Please and please, don't lock your kids inside the house. What if there's emergency like fire outbreak, or one of them fall sick. Had I known will never be your portion.

      Delete
  18. E good o, e beta make dem dey for haos dan make somtin bad happun to dem for roads.

    ReplyDelete
  19. This 2020 should come and go already!
    What a hell of year
    I wish i could uninstall 2020 .

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141