Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Former PRTT Oga Pata Pata Maina Tok Say Make Judge Give Am Bail Make Dem No Cut Him Leg

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Saturday, February 20, 2021

Pidgin Post - Former PRTT Oga Pata Pata Maina Tok Say Make Judge Give Am Bail Make Dem No Cut Him Leg

Abdulrasheed Maina, the former oga patapata for Pension Reformed Task Team (PRTT), on Friday come begin beg Judge for Federal High Court for Abuja say make e to grant am bail (make e run again) make e for go treat himself for better hospital sake of say e allegedly no well....









E say if him no go treat him knee wey (e take run before) don pafuka,say them fit cut the leg throwey.

Na Maina Lawyer dey beg the Judge for Maina.

Na the second time wey the Lawyer go dey ask for Bail after them recapture Maina from Niger Republic wey he wan pass use run enter America.

Wetin you think about this kind News? Make them release am or not? You dey think say e fit wan run again? Tok your mind ohhhh
 

5 comments:

  1. Make dem give am bail but he should receive treatment for National Hospital for Abuja, not abroad n

    ReplyDelete
  2. Oga please nothing dey do you, na scope you dey use for us

    ReplyDelete
  3. Na which Kain talk be that? Ok make him bring all the money wey him Tiff first, then we go talk about the bail mata.

    ReplyDelete
  4. My own be say, make them treat am the way Dem dey treat other criminals. Poor man wey steal 100000, Dem no dey give am bail make e go treat himself. Infact, them fit lock am for jail make e no see court for years. Some dey die for jail for crime wey them no vomit sef. Therefore, I no see reason why Dem go give legit criminal bail.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141