Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - The New Geh...

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, March 25, 2022

Sisi Senaponi's Corner - The New Geh...

Sisi Senaponi is here to entertain you with hilarious gists/Amebo talks from all around.....

If you like gist, you wont be disappointed....









I hail o...kpoi! Kpoi!...na who dey haarsee e?
Stellalimpopotopia...I greet o!


Na heat bin wan finish persin for dis side! Rain nor gree fall! Nepa nor gree stand! Na sidon look we dey so!


Na as my roommate wey dem kidnap resign, wey she still never see Job. We reason am find another person join body, make we dey share the rent into 3.


So this our third friend (Soba) pack enter, she dey work for one nice company for Island. Her Oga Oyinbo make her him right hand person and Team Lead.


Stella, na one night wah go work, my phone begin vibrate for past midnight. Na im my second roommate begin shout 'Jesus! Jesus!
I run go toilet mah fit hiaram well!


I for say 'You see am? He enter our haarse? Lock door! Lock door!Nor let am comot o! My problem plenty nor be small! Carry my higher education wey dey under bed give am, na dia my prayer points full! I go reach haarse na na na! Nor gree meh Jesus comot o!' *choi..and him be omnipresent!*


Nne, lock window! lock window! begin sing 'I will never let you go, unless you bless me! Nor too hollam o! Nor meh Angeh gee you slap o!
Check him leg, check him leg, he wear sandals!? Na im be dat! Ngwa ngwa, touch the sandals! Nor try thief am o! Meh Angeh nor give you strong konk for head!
Hollam for cloth! Hollam for cloth! Nor too hollam o! Meeh current nor go fling you throway!


*wheelchair corss abeg!*


My second roommate begin shout Sena! Sena!
Choi...I for say, Jesus ask of me? Abeg tellam I dey enter road o! For nice if one Angeh fit jor come carry me for wings!

* if I hear say I no do stowaway go heaven!*


She say nor be Jesus come jare, say na Soba wake for midnight from sleep, her tongue don twist, say she nor fit talk and she dey hold head, dey run serious temperature join!


Na which kain thing be this?


How I wan leave work for middle of night, from Island go mainland?! 

* You wey na broad daylight dem thief you comot!*


Na im I say make she quick carry Soba phone, make she call her Papa, as the man na prayer warrior for dem church!


I call again, she don calm down, don begin talk. Soba Papa say na person wey him pikin follow talk for office come tie her mouth inside sleep! 

*Eleeee! Prayer get power, abeg!*


Issokay! Nne,so na which kain vehicle you drive go jam person? wey dey come use Julius Berger finish you like this? She say na ordinary 'wheelbarrow' o!

I say wetin hapun?!



For dem office, dem bring one new girl join their team. Her oyinbo oga say make she dey mentor the geh. Na im the New geh wear Dwess wey the Bwess dey gather snow inside AC! 

HR wey be Man go report give Oga, to avoid victimisation, Oga tell Soba make she go address the Geh.

Na im Soba carry the Geh for one side, tellam say the Dwess too expose, meh she use scarf or coat cover am! She say the New geh squeeze face say wetin do her Dwess? Say Aftohroh, Oga and HR nor carry complain come give her by themselves!

Na wetin Soba talk wey dey come use better horsewhip, wipe sense comot for her body! Use rope tie her tongue for midnight!


She say she reach office the next day the New geh look am say ' How was your night?' If na you, how you for answer??

29 comments:

  1. Hahahahaha how was your night? That is why it is not good them go tell to confront person. Too many people are demon possessed.

    Soba next time don't be the one to go message. Some messages dey lead to death.

    Thank God for prayers. If you no strong, no go advise person ooo

    ReplyDelete
    Replies
    1. Could not read and understand the pidgin. Please can someone summarise in plain English?

      Delete
  2. I dey breaktime dey chop dey scream with laff. πŸ€£πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚πŸ€£

    ReplyDelete
  3. Senaponi ehn πŸ˜€πŸ˜€πŸ˜€πŸ˜€πŸ˜€πŸ˜€πŸ˜†πŸ˜†Stella abeg change the mascot above put one funny looking dry body woman wey plait thread for head.

    ReplyDelete
    Replies
    1. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚
      e go match d gist.

      The Anon πŸ‘† asking for translation.
      Drop recharge cards,those who load will translate for you. Language is expensive.

      Delete
  4. 🀣🀣🀣🀣🀣🀣
    This your tori dey o. See as I dey laff for office. Na dis wan good for all those our sisters and neighbour wey dey like decide for other people how to dey live their life jare.

    ReplyDelete
  5. Nawa; na to siddon dey look, drink water join

    ReplyDelete
  6. She should bring her diction closer to English. I like pidgin but this is too scattered. Read more than 2/3 and understood nothing!

    ReplyDelete
  7. Things dey happen. Lessons learnt. Dey your dey next time

    ReplyDelete
  8. Thank you. Na laugh get me here

    ReplyDelete
  9. I sabi read and write in pidgin English wella but this one get as e be abeg. It's so difficult to understand.

    No vex.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Eyah, you be ajikpako. This gist na for correct areans like munwa

      Delete
    2. Ijeoma πŸ™†πŸ™†πŸ™†πŸ™†πŸ™†
      Ajekpako is a local girl,I think you meant an ajebutter, a polished girl.

      I read twice before understanding.
      Wheelchair corss means it's costly,she can't afford it after the accident. 🀣🀣🀣

      Haarse is house.
      Aftohroh is after all.

      Sena prayer points full higher education notebook o πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚
      Na im be say God no dey answer you since naπŸ™†

      Quite a hilarious post,learn Pidgin English it is worth it.
      Sena 🀝

      Delete
  10. Omo,this Tori sweet my belle die.
    See as I scatter laugh for office.

    Abeg, make Soba no near that girl again oo.
    Her cup go soon full.
    She go soon jam power wey pass the one wey she carry Waka for body.

    Abeg, make we always dey pray every time bcos we no no the kind spirit wey dey some pipul body.

    God's protection on all of us everyday.

    ReplyDelete
  11. Weldone Sisi, you be correct 'gister'πŸ˜‚

    ReplyDelete
    Replies
    1. Gist too sweet, the pidgin na die🀣🀣🀣🀣

      Delete
  12. Some people are possessed with demons and have agenda.

    Tell Soba next time HR should address that new geh.

    Prayer is the key

    ReplyDelete
  13. Work on your pidin so that people go understand am better and follow the story Wella..

    Well if na me.. I go tell her say my night was great.

    ReplyDelete
  14. Reduce the pidgin small abet, na when. U say them tie her tongue I begin understand the yarn

    If not I ben no for grab anything

    ReplyDelete
  15. 🀣🀣🀣🀣🀣.... how was your night 🀣🀣🀣🀣.. but this your pigin too konk sha

    ReplyDelete
  16. The pidgin is too conc.
    I couldn't understand the write-up

    ReplyDelete
  17. Inside life matter oo...πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  18. I love this broken jare; keep
    It up 🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  19. This broken hard to read and understand

    ReplyDelete
  20. Had a good laugh πŸ˜…πŸ€£πŸ‘ŒπŸ‘ŒπŸ‘ŒπŸ‘Œ

    ReplyDelete
  21. Weldone Sisi Sena, I always look forward to your gist πŸ˜˜πŸ˜˜πŸ˜˜πŸ˜˜πŸ‘πŸ‘πŸ‘πŸ‘πŸ‘

    ReplyDelete
  22. This pidgin is very hard to understand. But thanks to the anonymous that translated some words up there. Had to read it again slowly before i got the gist. Soba stay away from that geh, she no mean we'll for you oh.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141