Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - New Regime

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, April 11, 2022

Sisi Senaponi's Corner - New Regime

Sisi Sena has landed with gist....






Kpoi kpoi kpoi! Una fellow SDK Yardflix pipu dem dem! How body dey today?! Issoraite...

Stellamamalade...I hail oo..


Choi na where I wan even start this gist give you like this o!


Una see this our yard fa, na orisirisi tenant dey come and go! Landlord greedy pass politician! If spirit come rent room, he fit give am parlour join! Once he see money for hand, the rest na Doctor handwriting!


Na so this tenant move enter O! He dey smoke pass anything! Him window na chimney! Smoke go jor dey comot like say he host sango for room!


The other day wey I rush go market, na so so eye Kabiru and him gang dey gimme! Dem almost buy 1 bag of water finish for my hand. Dey parade my shop per minute per minute!


Na when Mama Philo enter my shop, she begin ask me when I begin smoke or sell Igbo(weed).


My whole cloth wey I spread near Bobo window don absorb the whole thing! The cold wey I get nor gree me smell the cloth! Una see Am!


Anyways, na so Landlord go do business wey i no know with Bobo O. Bobo come go break Landlord Volvo wey he park for aside!


Na im landlord carry boys make dem come beat Bobo, drag am comot for him house!


Na so one fine woman wey resemble that 'ego oyinbo wey dash persin slap the other day'. The woman enter yard, park three Rangerover aside yard with men wey be like Hulk Hogan!


Make una come see commotion...Bobo no gree open door until the woman near the door say 'Bobo, it's me mummy, open the door!'

Na so landlord wey don go comot agbada, come down with shortnika and singlet to break bottle for bobo head, tanda dey look the empty yard. Landlord backups don disappear as dem see camo for dem hulks Hogan cap.


Na im Ego Oyinbo carry bad eye give landlord. She tell landlord say, so he never do am say he try to punch the pikin comot for her belle for Polytethnic, say he still wan come kill him abandoned pikin after almost 25years...Eleeeee! 




So bobo na Landlord blood and flesh o! No wonder he nor geh sense!


The woman say, your son came to find you his father! There you go!
Na so woman turn, enter car, drive comot O!


Na yard meeting we dey so o! Bobo don take over! Thank God say I no kukuma get female for house. And I dey kukuma carry dagger waka under my dross! Na new regime we dey so O!

9 comments:

  1. Na the mama spoil the pikin, she busy dey hustle find money upandan without paying attention to the boy as a single mother. Now money don come and pikin don spoil!! Shey na money go repair the damage wey the boy don become??

    As for the papa na the boy be him karma. That boy go show am real pepe!!!

    ReplyDelete
  2. @eleeeee
    πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚
    Senaponi is from enugu state.
    Confirmed 😎🀠

    ReplyDelete
  3. Wait, the boy is the landlord's son??? Wawuuuu.

    ReplyDelete
  4. na the word dross dey make me laughπŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  5. This na wetin we call the chicken has come home to roostπŸ˜‚

    ReplyDelete
  6. Wahala 🀣🀣🀣🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  7. When a man refuses to control his 2nd brain, the result of 2nd brain will control him when the time comes.

    Self control is the key.

    See landlord, see sleepless night. Kikikikkk

    Wahala

    ReplyDelete
  8. Bobo na landlord pikin? See gbege

    ReplyDelete
  9. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ€£πŸ€£πŸ€£πŸ˜‚πŸ˜‚ problem

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141