Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - The Evidence

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, June 20, 2022

Sisi Senaponi's Corner - The Evidence

 Hehehehe




Una doh o! My people! How dey go? dey go?


Stella-ego-bekee, how de overs? I hail o!

Uncle Joe get shop for market area, him family dey Village. He na gentle man.

He nor dey too like to dey buy food chop for aside.


E nor too teh wey Aunty Clara begin cook, carry food come market give Uncle Joe.


*Afang wey enter Buckingham come blue tooth Oval office! Choi!*


Small time we hear say, Aunty Clara husband wey be soldier don come back Lagos But Aunty Clara still dey carry food give Uncle Joe sometimes.

Small time, na im Uncle Joe carry him wife and children come Lagos o.


Aunty Clara no come get access to Uncle Joe like before. So we nor know if their meeting point don change or nothing dey hapun again.


Oga Peter dey sell dross, and orisirisi, even correct First Grade Bra! Those ones wey be say person no fit wear go deliverance. Nothing dey comot! nothing dey enter! Be like Romanian Breastplate! Na im!
And him market nor too corss like that!


I remember one time wey person clear Mama Nedu breastplate for wire! Na how Oga Peter sight am for her neighbour body! Wey he identify the goods say na Armed robber Mama Nedu dey follow live for house!


So as I dey gist you dey go, na so Oga soldier come market one day. He quietly call Uncle Joe say he wan follow am talk. Be like say the conversation dey go well, una know say these correct soldier people nor dey like wahala! Den go retire or dey mufty but na dem dey quiet pass for public. And correct men nor dey too talk or make noise.


Nne, as these two men don talk and discuss finish amicably, One woman just come. She begin shout say na from Aunty Clara house She dey from come o!


The woman say make Aunty clara husband, help her warn him wife! Make she nor dey follow her husband laugh inside market again! The woman say she don overhear say Aunty Clara dey follow her man go do short time for hotel. *Eleeeeee*


The day wah enter the hotel na when Mama Ebube pikin wan do bridal shower. And na the hotel she lodge with her friends.


Na devil say make she go put the party for rainy season. Nne, na when breeze begin blow, wey thunder begin fire, na so ceiling kukuma open the floor! Gbam! Odi bridal shower! Na as dem dey carry bucket, na so dem dey carry bag and cup to fetch the water!


Me wey go feed my eyes, Nna ehn, the kain kpoff kpoff and chicken-wey-comot-better- incarceration, wah carry come house ehn!


They say bride dey heartbroken! She comot the hotel with her friends, go lodge another side. *Clickstongue*


That side wey be say small noise dey vex the bushbaby wey dey comot from inside wardrobe for midnight!
And these ones don carry speakers and bikini to dance 'odogwu'.
*Female Bushbaby wey dey carry whip, wey get beef for girls wey nor dey like wear cloth! Girls wey na one of their potential bobo thief bushbaby mat!*


Innocent Groom wey go book room of N4,200 per night! He nor tell bride say na the Pentagon suite he even book give her! As na 'regular' customer wey him be!


He nor too know how the place dey be for long time as him own stay nor dey kukuma pass 30mins to 1hr. *side eyes*


Last last, everybody go dey alright. Na so this woman say she get evidence say Aunty Clara dey seduce and go the hotel with her husband.
Husband wey thunderbolt dey learn work for him body! *Akuko*


They say make she bring evidence! She comot dross from inside nylon bag!


Oga soldier do poker face! We no know if he recognise the dross or not!


Small time Aunty Clara run enter market. She tanda one side she nor talk.
Small time people say make she defend hersef Na! She say no be she get the dross!


He nor too teh wey we begin hear bell! Oga Peter dey do him normal marketing, dey waka pass... as he see the woman wey hold dross! He say wetin dey hapun?! Den gossip give am for one side.


Oga Peter look the dross, look the woman, look the dross again,look Mama Ebube, look Aunty Clara, look the road and continue him waka!


Na so aunty Clara and her husband comot, go house! We nor hear pim after that day.

 I dey wait make oga Peter come this side, he geh something wah wan ask am!

11 comments:

  1. So na only okrika all of una neighbour dey wear? Oga Peter go don sabi everybodi bra size be dat na...

    ReplyDelete
  2. You want ask oga Peter whether him recognize the dross abi?

    ReplyDelete
  3. Breastplate as in bra?🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  4. My favourite column, ❤😍💕

    ReplyDelete
  5. I dey suspect say oga Peter recognize the dress but he no want spoil things for Aunty Clara

    ReplyDelete
    Replies
    1. I dey tell you.
      Na Oga Peter sell the bra give Aunty Clara,for sure e know the bra

      Delete
  6. Oga Peter na correct guy man

    ReplyDelete
  7. That your area and adultery na 5 and 6.

    ReplyDelete
  8. @simply divine. The woman accused a soldiers wife of cheating with her husband and brought our an underwear to prove it. The soldier did not comment, the oga Peter who sells the type of underwear must have recognised his merchandise. But as guy man, he refused to cast the owner. Sisi no well at all!😂😂

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141