Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Dem Don Respond Say No Pikin Die For Port Harcourt Teaching Hospital Say All Nah Lie

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Sunday, July 03, 2022

Pidgin Post - Dem Don Respond Say No Pikin Die For Port Harcourt Teaching Hospital Say All Nah Lie

Di University of Port Harcourt Teaching Hospital say truth no dey inside tori wey say some pikin wey dey for dia Special Care Baby unit die.









Chairman of di Medical Advisory Committee CMAC UPTH Prof Lucky Onotai tell BBC Pidgin say no pikin die for di unit as im respond to reports wey say some small pikins dem wey dey incubator for di Neo-natal unit of di hospital die sake of lack of power supply

Prof. Onotai add say even though dem get power challenge, dem get generator back up wey dem dey work with.


"Di pipo wey dey tok dis tin dey tok lie. Na fake news. If na so wia di Mamas of dis pikin dem wey die? Ask dem make dem show you if really e happen.


"We get power challenge. Dat no be new tori for Nigeria. Evri wia for Nigeria dey get power challenge but we dey manager am with our generator.


"Di transformer bin get challenge wey we don fix but no day dey pass wey we no dey put on di generator. So no be true," e tok.


Wen BBC Pidgin visit di hospital on Saturday, we see Peace Marcus wey be mama wey dey on admission with her preterm baby for di Special Care Baby Unit (SCBU).


She say since she don dey on admission for over one month, she never see pikin wey don die and even her baby still dey incubator dey receive care.


"I don stay here over one month because I get preterm baby. I never hear say any baby die here. No baby don die here." She tok.

from BBC.com
 

4 comments:

  1. No smoke without fire oo, no matter how little the fire be. Naija I hail thee.

    Ada Agu

    ReplyDelete
  2. No smoke without fire oo, no matter how little the fire be. Naija I hail thee.

    Ada Agu

    ReplyDelete
  3. The mother's of the babies, are their mouths sealed? Why can't they speak up if such happened?

    ReplyDelete
  4. Over to the families involved.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141