Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Best Friend With Wicked Mind

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, September 05, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Best Friend With Wicked Mind

 Hmmmm, this is deep!





Kpoi! Kpoi! Una doh o!


Stellacinamonpapaya, I hail o!


I say make i comot house go by needle and thread as Obioma sef don join odogwu gang.

He don dey dictate which dross customer suppose troway! God abeg e!


Those days wey be say even when dross don amputate finish, na obioma go even hep person tack St. Michael put. Kiikiikii..now they don rebrand and upgrade o!


Their money now na from 200naira upwards. Minus the insult wey person go collect on top tear tear for clothe wah use my money buy!


Na for the mama wey dey sell thread and needle i land, I meet her as she dey advice one fine aunty wey resemble Fulani with her pointed nose and ebony skin.


She dey use handkerchief dab eyes make her make up nor too shift.


The Mama begin tell her say, she sef too put body for grand! Say how she go tell another person that kain secret Inside this life wey we dey So!

No body wan attend to me, me sef neva ready to be attended to. The aunty kneel down, thank the mama and she comot.


Mama phone ring, she begin discuss with person for phone.

Una know say our African mothers never complete talk if tempo never rise reash bustop!


Mama say ehn, shebi she don warn the geh make she nor too dey trust friends. Say her head nor gree friendship since she be small pikin!.

Say she go tell her friend about the 7months miscarriage she get after her fiance use beating finish her!

The new man wey she come dey befriend now, mama say she advice her, not to get pregnant before the marriage. So she begin use birth control medicine, but she nor tell the man.


The new man dey stylishly wait to see if she go get belle, she sef dey stylishly avoid belle, to see if he go pay her bride price first.


Na im her best friend wey sabi all her life history! The one wey she carry her life give, as God nor dey house to confide in again go tell the new man say the Aunty no fit born! Say her womb don damage after she go abort 7months old belle!*choi*


The matter scatter the man head, na so he find Aunty go her shop, cause serious drama!

He say so she be barren woman, and she wan use sense tie him down! He say no wonder she never carry belle all these while as he dey do do!

Aunty begin cry, she nor know how to explain! Abeg when person ask her were you pregnant? Did you take out the baby at 7months!
And the two answer na Yes! Abeg how she wan explain give man wey already don get poisoned mind fa?!


He say he nor dey do again. Na so she carry herself come explain to her godmother.


This mama na her own mother best friend as her own mother don kpai since she young and na this Mama raise her with her Papa family dem dem.


Nna ehn, as my ears full and balance the matter, anor even come remember wetin I find come.

I just dey look okada wey dey go and come, this life too deep abeg! The mind of man is desperately wicked indeed.

I say Mama I wan buy tape rule, sorry thread! She say which colour i say any one!


Abeg na dross awan sew, anybody wey nor like my colour riot for wire, fit go tie another rope for backyard! *clickstongue*




Hahahahahahahahhahahahahahahahahahahahahahaha

26 comments:

  1. Lol,there are good and bad friends...choose wisely!

    ReplyDelete
    Replies
    1. Your last para....haha hah haha hahaha.

      How I wish she would find time to explain to the guy well.

      Delete
  2. Well-done Sisi! I enjoy your stories.

    ReplyDelete
  3. This friend nawa, i don't blame her, i blame the lady weh go open mouth waaah, she has learnt her lesson sha, i believe she knows better now.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Thank you. Keep secret as secret

      Delete
  4. Na em make I no get best friend till jesus comes. I cannot fit, the only friend wey I think say I get for university show me her true color for my marriage period, so now I dey my dey and I dey enjoy am,nobody fit open my nyash or spread false gist about me coz where u wan start from?? I dey like ghost.

    ReplyDelete
  5. ๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚

    So wetin that yeye friend gain? Na wa!

    ReplyDelete
  6. Why that girl go live for man house wey never marry am,serves her right๐Ÿคฃ๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿคฃ

    ReplyDelete
  7. Hmm. Wicked friend. This is why some people avoid others by all means
    For this life anything wey don open no fit be secret again na. She should have told her new man about her open past

    ReplyDelete
  8. Some frds re worse than enemies. They may not wish you dead but are hell bent on causing pain to people. May God keep such frds away from us

    ReplyDelete
  9. I don't keep friends. At all, just mingle with people I meet and it ends there

    ReplyDelete
  10. Some friends are evil and must be avoided

    ReplyDelete
  11. If one is fortunate to have a solid friensdhip. Na to protect it with one's life and serious prayers! Sometimes to be an island has saved alot from heartaches. God help us all.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Protect kini? Ain’t protecting nothing. I’d be good to you. But like a bird, you must fly my dear

      Delete
  12. Trust no one,take your problem to the Lord and leave it there..... Josaria

    ReplyDelete
  13. Some people mouth no dey fit keep anything to themselves at all. They must tell 'friend'

    ReplyDelete
  14. How you go remember wetin you go buy when better food dey table๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ...amebo

    ReplyDelete
  15. Sisi, aproko work fit you๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚
    Backstabbed of a friend will not end in this life.

    ReplyDelete
  16. Sisi with amebo๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚๐Ÿ˜‚
    On a serious note, there are still good friends out there. At the same time, one needs to be very careful with the things you discuss with friends to avoid stories like this.

    ReplyDelete
  17. Good. Very Good Story Teller.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141