Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponis Corner - Lagos Na Wah

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, September 30, 2022

Sisi Senaponis Corner - Lagos Na Wah

 Lagos no easy!





Una doh o! Na who dey haase e?!


Stellahollandia-devanilla, how dey overs?! I hail!


Choi! E get one period wey things get as e be, nor be small thing o, even tie wrapper join!


Na so I kukuma pack my kaya go village.I go hustle small for that side!

Na after some time don pass,my childhood friend say make i come back Lagos o, make we see how to rough everything together!


The day after i enter town, come even coincide with one interview wah get for mainland.

Na that time wey office work make serious sense!

E nor matter if na sekuriti you be, just knack tie and coat comot for house! Na there respect dey that time, as plenty Judgina full town nor be small!
People wey sabi say their family and neighbours get bad mouth nor dey bother disclose the kain job wey dem dey do!


Even person wey go tanda for newspaper stand from morning till evening, go say na office he go!

Na when end of the month reach to bring salary come house, the men go start intentional kworeh with their wives So they nor go drop shishi!


Nna ehn, e don tey wey disguise and packaging don dey o! Na because people don upgrade to dey put am for chocho media now!


Choi,Suffer don dey we land teh teh, the difference be say, that time, people still get conscience to not build their happiness on top another person unhappiness! But now eh..we nor even know where the happiness sef dey!*God abeg!*


Na so I enter Lagos,i dey my friend family house, she describe the interview place gimme, na im I enter bus reach Oshodi.

Nne, see as Oshodi come dey different for my eyes for broad daylight! Anor see dem bros wey dey move something for person body!
Me wey don already dey prepared!


Na three dross awear under my skirt. *clickstongue!*

Na inside the first dross I put my money, the second dross na where I position my nokia phone, the third one na where I be wan put my certificate.


I come remember how many certificate aboki don use sell suya gimme for village! The person wey get the certificate go dey lagos, dey wait make company call am for job! *inside life!*


So I kukuma put my certificate inside handbag.


Anor even know if na handbag I suppose call am, because the only time wey this bag comot for middle of my leg, inside bus, na my chest e dey!


After they don delay us finish for the interview! Wey the staff dey use us press phone, do fashion parade, dey form activity upandan.


Na im i realise say na only me wear coat ontop skirt come the interview! The other ladies wear dress wey nor reach knee come! They do fine fine, long long attachment.

When i been buy that my wig, Iya fela nor tell me say the wig nor dey heat resistant!

Na everytime i wear this wig, enter sun, e dey shrink!
Anor know if na to put am for water or kukuma keep inside fridge!


I look round see say no male applicant knot tie come! One even wear fine, black, turtle-neck sweater and black trouser wey nor reach grand! Him shoe too shine abeg! Affit see my teeth inside! *choi! Money good e!*
This one just come interview for formality, he don get the job already.


When the staff wey interview me say we will get back to you, me sef don already know say na lie! The way he take dey look my wig, don already give me idea!


With all those fellow applicants wey follow come interview but na different doors for the office dem dey enter and comot!


Dem dey code, use sense to come check their candidates!


Wah dey see some staff dey ask two other ladies, what's your name? Are you here for the interview? Mba na cement they come carry!

I carry my bag go find where their canteen dey!

I balance chop three wraps of Garri and Egusi soup!
I position my wig near fan before I enter Lagos sun wey sabi roast hair!


Na so I reach Oshodi, I be wan climb bridge but the Garri wah chop, plus the job matter just heavy my mind and leg!


I see as people dey cross, na so me sef follow cross the first lane. I be wan cross the second lane. Na im one good Samaritan man hold my hand and help me cross!

Choi! I say so good people still dey this Lagos. We reach the other side, I say make i adjust my bag, uncle nor gree release my hand! Wetin happen?!

Na so he begin carry me go where anor know o! Oga leave my hand, nor be my way be this!


Nna ehn, na so this uncle carry me reach those bus, wey dem dey put them Hank Anuku inside fim, after dey don carry gun, kee Chief and Judge don conclude their matter for court!


Ewoooo! Abeg e! Anor kee person e! Na road i cross e!


Den say I cross road and na offence, say make i enter back of bus!

Na so I begin weep and wail e! I say anor geh family for Lagos e! Na work I find come Lagos!

Oga abeg hep me o! Anor know why you hep me complete the offence! You for jor use cane pursue me back for the first lane!


He say but na me wan commit offence so he assist Me! Na because he wear mufty anor quick suspect and escape! *kiikiikiii!*


After I don call all the names of my village people to come hep me o! Say anor wan go kirikiri o!


Na so the uncle go come, he say him oga say make i bail myself and go!


I don wear my wig and shoe, begin waka wey the uncle say Eyxx! Where you think you are going?!

I say but you say mah bail myself. He say so where the money? I say which money?!

Na my wig he first fling inside the bus! He say I dey play with him intelligence! Choi!


I say Oga anor get money except my transport!


He say where e dey?! I open bag show this man. He shook hand inside my bag begin gather my money. He say e nor reach! Say make I call my family people!


Na so I begin wail o! Chimooooo! I say Jehovaaaah, nor be wetin me and you discuss be this e! Jesus i pray before i comot haase e!


*If person tell you say God name nor get power, na lie dem give you!*

E nor reach 3minutes wah mention Jehovah plus Jesus wey this uncle say make i wear my wig, come dey go!

I say uncle abeg nor shoot me for leg, anor wan go! I go sidon e! Anor go make noise again e!


He say, Will you getat from here my friend! All these Ogbanje agents!


The race wah pick go find Mushin bus nor be here! I run like say person thief my kidney for market!

See person wey dey form intelligence! *kiikiikii*


He nor geh internal eyes, see say aget money inside dross! I laff throway leg inside bus! Mumu wey think say i nor sabi their way for Lagos!


I shake body small to confirm say my seven taasand eight hundred and fifty naira still dey intact for my dross. Na big money that time na!

Money wah nor gree leave inside house wey get Bingo, you think say na my dross you wan come thief am! You try! *kiikiikii!*


Anytime wah no sure if na one way or na wetin wetin, na dem uniform people i dey go ask first As evidence say na you direct me fa!

38 comments:

  1. Lol
    Sisi you will not kill someone with laugh o.

    ReplyDelete
    Replies
    1. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚ God this is one hilarious story..Sisi Senaponi mehn thanks for making me laugh

      Delete
    2. I don laugh tire sisi you bad lol

      Delete
  2. lol@"Na three dross awear under my skirt". Sisi, you funny I swear 🀣🀣🀣 🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  3. LMAO 🀣🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  4. 🀣🀣🀣🀣🀣🀣🀣🀣🀣🀣🀣
    I almost fainted from laughter.
    Sisi, you deserve an award πŸ‘

    ReplyDelete
  5. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚ Sisi you no go kill me πŸ˜†πŸ˜†πŸ˜†πŸ˜†πŸ˜†

    ReplyDelete
  6. Sisi ooooooo

    I don laugh tire πŸ˜‚πŸ€£
    I just dey imagine that your wig and the drama wey you act

    ReplyDelete
  7. Haase, sekuriti, dross, chocho media, kworeh, tears in my eyes from laughter πŸ€£πŸ€£πŸ€£πŸ˜€πŸ€£πŸ€£πŸ€£πŸ€£πŸ˜­

    ReplyDelete
  8. Lol those guys are thieves, those days if you cross eeehn without using the bridge na money them go use you chop, weldone I enjoyed your funny story and the Hanks Anuku part lol.

    ReplyDelete
  9. Omo eh🀣🀣🀣
    This is the most hilarious stuff I have seen todayπŸ€£πŸ€£πŸ˜‚what ?!
    I sabi that interview scenario
    And the crossing road o.
    Na so dem carry me for lagos one year like that eh, na one mama been dey give me eye make I run but anor quick understand, na so dem catch me, I begin beg o, even mama join dey beg for me, i tell dem say i be jjc o, say na my first time for city, say na one interior village i come from and na my first time to see tarred roadπŸ€£πŸ˜‚lass lass dem leave me o.

    ReplyDelete
  10. I don laugh Sotey water Comot for my eyesπŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚. People just dey look me with side eyes for office

    ReplyDelete
    Replies
    1. Very very funny, the pidgin na wire!

      Delete
  11. Chai you will not kill me o

    ReplyDelete
  12. I get one very fair cousin like that, A day before her wedding, she decide to go buy some honeymoon lingerie for market. After shopping, she head towards oshodi. As she cross road na so Dem grab herπŸ™„, throw her inside van. She begin cry. Chai!! Her face red! She explain say na tomorrow be wedding. They released her by 9:30pm.

    ReplyDelete
  13. Ewo, Sisi come finish this stori, the office give you job?

    ReplyDelete
  14. πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚ this life no balance at all.

    ReplyDelete
  15. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  16. I laughed till I started crying πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚. Chio

    ReplyDelete
  17. πŸ€£πŸ€£πŸ€£πŸ€£πŸ€£πŸ˜†πŸ˜†
    Were you offered the job?

    ReplyDelete
  18. Sisi no go kee person. It's the "help you complete the offence for me" πŸ˜‚

    ReplyDelete
  19. See tears dey commot my eyes from laughing. Jesus. Sisi no wound me bikoπŸ˜€πŸ˜€πŸ˜€πŸ˜€πŸ˜€

    ReplyDelete
  20. Hahahaha them nearly catch me for cms that time. The God wey save me be say the man was standing by the bridge and dey look my direction, I dey look his direction. Na God save me

    ReplyDelete
  21. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  22. Sisi I totally had a good lafπŸ˜€πŸ˜€. Mumu no dey finish for Lagos!

    ReplyDelete
  23. Sisi you be real character aswear, chai you no go kill person with laugh🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  24. Lagos life is not easy @ all for jjc...u must be wise and smart to live and strive in Lagos state...sisi those guys would have collected alot of money from you if u weren't smartπŸ˜‚

    ReplyDelete
  25. Ahhahahahhahahahahahhahahahahahahahahhahahahahahgahahaahhhhahahhahahahhhhahahahaha.....
    Sisi oh you too much

    ReplyDelete
  26. The catch my brother come carry them go court for Mushin na arround 3pm wey he come call me say make I carry 2k abi 4k come bail because dey want put them for prison

    ReplyDelete
  27. True true good people dey Lagos🀣🀣,see as good Samaritan helped you to commit offense🀣🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  28. 🀣🀣🀣🀣 chai oooo😁

    ReplyDelete
  29. Very funny πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜πŸ˜„πŸ˜ƒπŸ˜ƒ

    ReplyDelete
  30. I was laughing as I was reading. This is very funny.

    ReplyDelete
  31. You are just too much

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141