Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Yankee Wan Make Gbana Official...

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, October 07, 2022

Pidgin Post - Yankee Wan Make Gbana Official...

 You don hear the news wey dey hala everywhere for town?Yankee presido say make dem no put anybody for prison because of gbana!




The paale provoke join come even say him wan forgive all the people wey dey prison since becos dem bazz gbana or dem catch dem with am.... You say wetin? wahala be like bicycle wey dey find rider!


You no fit try am inside Germany becos many pipu wey dey waka with crase for head, nah gbana cause plenty of am and that is why nah crime if dem catch you with am...

E say all the pipu wey him dey comot for prison so because of this crime.make nobody use am deny dem work or where to live oh....

This nah same place wey pipu dey crase enter road with gun for no reason oh, now how e go be with this gbana wey everybody free to carry so? GOD ABEG!

29 comments:

  1. Na end time ni ooo

    ReplyDelete
    Replies
    1. All those itaboys for Accra be like "since morning I neva gbana" while scratching their bodies, this one is freeway to destruction for them.

      Delete
    2. What ur describing is crack cocaine or crystal meth dear. Weed doesn't do such. Just makes u high and lazy. It's legal in Canada and California, USA. Time for countries like Nigeria to embrace such too. This will help uptight people with frustrations and sticks up their nyashes to calm down small

      Delete
  2. Wetin be Gbana? Is that a type on psychoactive drug or what?

    ReplyDelete
  3. Freedom to smoke any how. hhhmmmm

    ReplyDelete
  4. Ahh! This one don pass be careful.

    ReplyDelete
  5. E don happen be that oooo..make God dey help oooo because no be everybody wey wear better cloth dey alright

    ReplyDelete
  6. Na small quantity dem talk o
    If you like go carry 200 grams of gbana waka. Dem go still catch you lock.
    All the pipu wey de under the supervision of Department of corrections, still nor go smoke gbana because their probation term say make dem nor puff am
    Na so one man say weed de legal, go smoke am. When dem tell am to bring piss, dem see say e smoke am. Na so dem give am more time

    ReplyDelete
    Replies
    1. America copy copy. They want to do like Canada. Lol

      Delete
  7. Stella, nobi everybody dey Sabi wetin all dis slangs dey mean. Which wan kun Ghana?



    Obi for President
    Wizkid FC
    Proudly TIV

    ReplyDelete
  8. Too much freedom no good abeg,na dia teenagers i pity.

    ReplyDelete
  9. Gbana is Cocaine/Heroin, President Biden was referring to Marijuana (weed, Igbo).

    ReplyDelete
    Replies
    1. I thought gbana was Igbo?
      Never knew it is cocaine o

      Delete
  10. You guys don’t even understand what was said.Biden said to stop arresting and putting people in prison for possession of marijuana quantities that isn’t enough for distribution.So if they see you with weed that is smokable quantity,you shouldn’t be arrested not to talk of going to jail for it.it is a good step in the right direction as it’s black people that has been suffering the most.he also wants to change the classification of marijuana from being on the same level with heroin and higher than meth and fentanyl to something lower.

    ReplyDelete
  11. A lot of people are recreational weed users. Apart from that, it helps some people with pain also. A lot of states already legalized it but you cannot have a whole trunk full of weed and expect the cops to let you walk. Biden only passed a federal law, decriminalizing it. Some states will never do it. If you get caught with an ounce of weed in certain states, you are on your own.

    ReplyDelete
  12. Replies
    1. GBANA is crack cocaine don’t confuse it with marijuana abeg . Difference plenty

      Delete
  13. Gbana is cocaine NOT weed

    ReplyDelete
  14. I taught he said he pardons all those arrested for possession of drugs only

    ReplyDelete
  15. Gbana is cocaine. He was talking about marijuana/weed which is igbo.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141