Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Office Fracas And Karma

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, November 21, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Office Fracas And Karma

 WHAT!!! Wicked Church ' Brother'







Una doh o! Na who dey we yard e?! I hail o!

Stellalondon-leitaliano! I greet o!

Nna ehn...this life na real wonderment!

This my former roommate, Soba come house begin gist us wetin happen for their office. 

She say na one young fine geh they just employ in a space of how many weeks wey plenty controversy begin follow!

I say anor understand?!

She say the Girl (Kamsi) sabi one of the Oga (Bro Jude)wey dey recruit as na the same church dem dey go!

So Kamsi mother tell this Brother to help her daughter find job for their office. He post post them sotehh, One day as Kamsi Mama say make she kukima go the office and submit her cv herself, since brother just dey do them one kain, Na there Kamsi meet another lady, Clara wey dey recruit gangan for the position!

 That one collect Kamsi CV and as dem dey talk, na im the brother waka pass. *sideeyes!*

He just do like say he nor sabi Kamsi.

My room mate say she begin hear argument like one week after when their IT person wey be sickler just faint inside office! 

That them office na central AC! Person go dress like say na inside snow person dey go. For there, na everybody get blanket, headwarmer and stockings!

So be like say the IT guy don too expose to cold as he never even reach 3months for there! Wey dey wan use cold killam! God abeg e!

So they need to replace him quick as the boy say he nor dey likely to return soon! 

*be like say the reality when inside, dey different from aside, wey e dey reason before he enter!*

Clara come tell Brother say she wan contact Kamsi, as she get better experience for IT. So she go come for interview! 

Na so Brother say Mba o! She must not contact Kamsi o,  Say aftoroh plenty people wey send their CV online dey! 

Na then Clara say no problem, who Brother wan recommemd from the list?!  He carry name give Clara. 

The following morning, my roommate say as all of them comot from staff bus enter office, na lushious yellow tighs and fresh bwess jam them for reception! *like heart attack!*

Na the candidate wey Brother Jude recommend don find job come! The geh sef na their MD spec! 
*wickedness to pepper clara for MD parol*

Na so Clara interview the girl and she nor qualify as even the Clara sef dey use partition, to patronize MD with code! 

*make she no use hand employ wetin go spoil her own market* 

So Clara invite Kamsi, she come do interview with descent dress and begin work that day that day! 

Brother nor come office for three days as he go represent their department for Abuja. 

So na the Monday wey he come office, he see say Kamsi baby, don resume since last week and even they impress everybody including MD. 

*clearsthroat..Kamsi baby don dey enter MD penthouse on a coded*

Na so the kworeh between Clara and Brother start inside lunch room o! Wey Brother begin para say why Clara go employ Kamsi baby! 

I say Soba, wetin come dey there wey the matter  be like that?! 

Soba say na so she sef begin get close to the new girl, She come find out say this Brother na im even disvirgin Kamsi for University o! Wey because of their school fellowship and church, they nor fit fight public fight! 

She nor even fit confide in anybody say na like this he dey do her o!

Kamsi say the Brother dey promise her marriage fa, but later he say because they too don commit sin, God say make dem separate! 

She accept, begin ask God for forgiveness. She manage graduate after some issues.

 E nor too tey wey Brother contact her during NYSC, he say he wan come visit her.

 Na so dem do the do again and belle enter!

 Brother begin beg her say make church people no know or demote am! As he na head of protocol for their gini gwanu, from fellowship days.

Na im this girl go drink melecine wey land am for hospital and the pikin nor gree comot! 

Na so her Mama ship her go village to born the boy, make people no mock them! She still lie say no be Brother give her belle! 

Her Mama dey overrate the brother, say na mentor! In fact sef, the mama dey use brother type pray for Kamsi as future husband!

Na before Kamsi come back Lagos brother don engage one sister for choir. And dem marry o!
Kamsi mama sef join and buy Aso-ebi and carry coolers of food go, to support her daughter's mentor and school father!

The sister for choir and Brother don dey do coded knackings teh teh before Kamsi even enter the same Uni with them! 

*who knows if Aunty choir sef know, but she wan collect ring, so she fit jor turn blind eye*

The news of the marriage, wan make Kamsi crase for village!

*Choi, dem think say na post partum wetin wetin do her! Nor be am o! Na the secret wey she nor fit tell anybody, dey eat her up from inside!*

This Kamsi girl still come back city to put her life together!

Her Mama come still dey push her go Brother Jude side as mentor! 

Soba say the girl talk say, the day her mama go find out how many belle she don comot for that Brother and that he's the father of her grandson?! 

Nna ehn, she say she never see wetin nor go make Brother die that day!

Mama dey impose, Kamsi dey avoid, Brother dey misdo!

So as Kamsi don catch MD attention wey she dey get exclusive access to him, Clara don dey boil with rage, but she nor fit talk or resign.

*the salary and benefits nor be small stulvz*

Brother go dey sweat inside AC say him own don finish! 

Soba say everywhere just dey awkward for office, say everybody face front and mind their lane! 

Anything you see or hear, na to carry am swallow for belle o! 





But who tell Soba all these things? Nah Kamsi?
That brother is evil..Nah inside church nackings dey go on pass....... All those Church brothers wey you dey see? forget them!

10 comments:

  1. no be small tin, people wicked no be small

    ReplyDelete
  2. Na wa o!!! That Brother na devil subordinate o. kai things dey happen for Protocol and Choir department for church shaa

    ReplyDelete
  3. The bro is really evil. Evil men in the church deceiving gullible girls/ladies.
    Ok why was he preventing her getting a good job... idiot
    They are both adults and can handle the office beef

    ReplyDelete
  4. Some church brothers are something else, if I talk all the things wey I know back then, as a fellowship sister ehn...it is well, these days, it's just advisable to know God for yourself and pray never to be in a condition that will turn you to a miracle seeker.

    ReplyDelete
    Replies
    1. @15:31; "It is advisable to know God for yourself... ." You are so right. One just need know God him/herself, study the Bible and ask the Holy spirit for interpretation, else, he/she will just be "tossed here and there by doctrines of men whose gods are their bellies".

      You see all these church brothers ehn, just as sleeping in a bakery doesn't make one a loaf of bread, so too going to church everyday or even sleeping therein, doesn't make the church brother (or sister) a "CHRISTIAN".

      Delete
  5. Evil brother, see as God turn everything around for Kamsi.

    I pray Kamsi mother see the real brother's character

    ReplyDelete
  6. See sweet gist but why is kamsi protecting brother?

    ReplyDelete
    Replies
    1. Na like Stockholm syndrome wey victim go dey protect her abuser abi no be so?
      God help all true believers o. Make we no jam agbako suitors wey be devil in disguise.

      Delete
  7. I tire. Too many fake church executives

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141