Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Follow Follow Dey Kee

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Thursday, December 08, 2022

Pidgin Post - Follow Follow Dey Kee

Hmmm my people this life eh, if you no sabi road to where you dey go, you go lorse!




You see the Video of the woman wey blind because she go follow person wey color eyes? You no see am? Ok make i yarn you!...

The story be say, she dey follow one motivational speaker wey she dey look up to for instagram, so as the babe come change color of her eyes with color, she sef come follow go do am and now she don blind, the two eyes don swell up gum together and doctors say nothing wey dem fit do because the eyes grow another layer out of infection...

Meanwhile person wey she go copy, nothing do the person oh....

Her small daughter warn am before she do but she no hear... The tortoise go drag shoulder say e no go stop until dem disgrace am.

Now the Lawyer and mama of five pikins don no dey see road again!
 You see wetin follow follow cause? Make you find your road make you no lorse oh!
Motivational wetin? Abeg motivate yourself to better things!

6 comments:

  1. I be read the story yesterday. Na so I jus hiss waka comot.
    The thing wey copy copy go coss for dis we life ehn, mouth no go fit to talk am finish.

    ReplyDelete
  2. I no dey piti pipu wey dey allow demsef dey carried away wit wetin dem dey see for soso midia. Na her children I piti. Who is this motivational speaker sef?

    Anne K

    ReplyDelete
  3. Yes ooo,follow follow enter gutter.

    ReplyDelete
  4. What Instagram will cause eh?
    Ndo to her.

    Apologies sha but they should find her a smooth ass walking stick.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hahahaha @smooth ass walking stick

      A whole educated person with pikins dey follow motigbetional speaker. Na real wa for her

      Delete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141