Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Dem Arrest Pikin And Papa Becos Papa Send Pikin Go Write Exam For Am

Advertisement

Thursday, October 08, 2026

Pidgin Post - Dem Arrest Pikin And Papa Becos Papa Send Pikin Go Write Exam For Am

This kind pikin sef!!!!......   Only look e begin confess!

On Wednesday October 7, 2026 Wahala burst for NOUN University for Abuja as dem catch 33-year-old man Monsuru Musa wey go write promotion exam wey dem keep for him papa, wey dey work for FCT Fire Service.


Na so security people wey Minister Nyesom Wike send begin waka round. Dem jam Monsuru, ask am who e be ,baba confess sharp‑sharp say “I no be the person wey suppose write am. My papa sick, na im send me.”
Dem ask am how old him papa be, Monsuru say “67 or 68.”
Later, papa come talk say “I go turn 60 for February 2027.”
Na there everybody begin look each other like Nollywood plot twist.
Papa still talk say e finish primary school for 1977 and secondary school for 1982. DSS collect both of them, take statement, then hand dem over to police.

2 comments:

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141