Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Destiny Thief

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, August 05, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Destiny Thief

This one na must read because e fit be you ooooh...






Una doh o! Yard pipu of Life.



Stellamazarati! How de components?! I hail o!

Wetin God nor fit do, truly nor de exist!


This kpelebe Aunty begin follow her Madam work for tailoring shop!


Small time, Madam go beg her make she come house to assist her.


Small time Madam husband begin eye the Aunty!


Aunty begin refuse to go the house whenever husband dey around!


Madam begin give Aunty attitude say she dey arrogant, na why she nor wan help her for house, as house geh wey she nor dey pay for the services o!


Small time Madam say she wan travel go the abroad, make Aunty go find work for another place!


Aunty find work soteh, God send her helper with better secretary job and even begin sew clothes for her office people!


Na so Madam don collect another New girl for shop, that one hear wetin her Madam nor like. So she fervently dey assist the Madam for house.


One Saturday night wey the Madam cajole the New girl to sleep for her house. The girl be wan go her parent house, so she go fit go church with them on Sunday.


Na for Sunday morning, the girl wake up begin hear person dey shout, scream up and down the house!


She go parlour, see her madam dey wriggle for floor like say invisible person dey flog her!


Madam wetin happen? As na Sunday morning, she and madam husband carry her put inside car rush go hospital. Girl go church for her parents side!


Na for church dem give her message say, make she nor return to the Madam house or shop o!


Wetin hapun? Den say madam get shrine inside her house wey she dey carry person destiny keep! Choi!


Say since the New girl nor dey gree sleep for the house or chop anything inside the house or even collect meat from the madam inside shop, na why the sleepover invite was planned!


Say in fact, the husband too na accomplice, so oga go knack her collect destiny shullincase if madam fail!


Say na because New girl fire prayer for night before she sleep and Madam wan forcefully enter her room for night, na im make Angels begin whip the Madam from inside sleep come real life!


Choi! Wonderment! Eeee!

39 comments:

  1. EWELEKE!!!!! 😲🙆‍♀️🙆‍♀️🙆‍♀️🙆‍♀️

    ReplyDelete
    Replies
    1. Eskelebe tiolebebe

      Delete
    2. Prayer be like Water, no matter wetin person drink, e nor fit be like Water! Because water get him own special duty for body. Na so prayer sef be! A o ni ko agbako o, ori wa o si ni ko Adura o! Amin, Ase Edumare!

      Delete
  2. Na wa o
    Thank God for divine protection,evil people everywhere.

    ReplyDelete
  3. Yawa... I know a family wae b say if them throw party any meat you chop there na meat wae Dem don use the head do sacrifice.. their mama even dae cook food sell I pity people wae DAE buy their food for this Benin.

    ReplyDelete
  4. Omo things dey occur o. Na only God dey save person for this life cos the heart of man is desperately wicked. One thing I have observed with all these fetish nonsense is that, no matter how effective it seems, it will surely fail .

    ReplyDelete
  5. truly the easiest way for evil men to steal female's glory,is tru sex... ignorant ladies have lost their ways and as a result,life became so difficult for them.thats y u see alot of elderly men having affairs with girls young enough to be their grand children.things are happening out there folks,we all have to be careful

    ReplyDelete
  6. Jehovah my Helper I thank Thee! 🙏🏽

    ReplyDelete
  7. Our God in action. My beloved! Prayer is the key

    ReplyDelete
  8. Things the occur for this naija,baba God continue to the protect and direct our steps to right places.

    ReplyDelete
  9. Hallelujah Na so dem for use this God pikin the man go by dey toast all the girls make dem for fall into sin by that time him wife go fit penetrate them use them. Thank God say she no eat madam food o, still one come forcefully attack the girl for night this one na him them dey call Holyghost Koboko. E sweet me

    ReplyDelete
  10. Na waaa oo, Tank God o na different story we for dy hear

    ReplyDelete
  11. It’s good to pray always o

    ReplyDelete
  12. Na wa o things dey happen.

    ReplyDelete
  13. Imagine. Wicked people everywhere

    ReplyDelete
  14. I don learn new pidgin word today again. Shullincase🤣. Sisi for president!🙌

    ReplyDelete
  15. Chai! What some people do in pursuit of wealth is shocking!

    ReplyDelete
  16. Wahala no too much like this?
    See wetin husband and wife dey do

    ReplyDelete
  17. Prayer na the strongest force for this earth o,e good make we dey always pray to God....... Josaria

    ReplyDelete
  18. Seeker of God's presence5 August 2022 at 17:06

    May God help us oh

    ReplyDelete
  19. I once went to an acquaintance function, he asked me not to eat anything at their party..Omo d smell of d jellof rice was drawing me like ogbono..lol.. he told me if I wanted anything we'll go buy it at ShopRite. But I shouldn't eat or take anything from d party... We later went to buy stuffs..after that day, I run four forty oo.. I no look back till today. I don't even pick he calls or calls from numbers not stored on my phone... This life is deep o.. one needs to be prayerful

    ReplyDelete
  20. I too gbadun this column. Thank God for saving the girl.

    ReplyDelete
  21. Evil people
    Looking nice yet darkness package them

    ReplyDelete
  22. God go dey safe us o

    ReplyDelete
  23. Wahala! Different things dey this life, person need dey shine eyes o

    ReplyDelete
  24. Where this post sweet me reach I come back come ready, na this gust dey my mouth since morning I come even add sweet join 😂
    Dem dey swear for the woman and her husband for here since 🤣

    ReplyDelete
  25. Of course na inside Nigeria you go dey hear this kind stupid gist. Who do una? Some people even believe the story join.Nawa for WAEC!

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141