Stella Dimoko Korkus.com: The Hustle Post

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Thursday, September 24, 2020

The Hustle Post

The Hilarious hustle post is here again................






My sister hustle ooooh,make dem no turn you to baby making factory for Europe because money wey government dey pay kids every month.....Hustle oooo

237 comments:

  1. Back with a bang..My brother hustle o make because of love you wash woman pant wey no gbadun you sef...

    ReplyDelete
    Replies
    1. Neo come and carry ur shade o

      Delete
    2. HUssle o mk u no do “West” Trainner advert while others r doing EKO signature

      Delete
  2. Hustle o make you play golf after retirement instead of draught..

    ReplyDelete
    Replies
    1. All na games sha.

      Delete
    2. Tai ,ifbi hear say all not game, abegi game pass game... If only you know the timba and calibaa that plays draught, from morning to evening , awon baba semiu,spiroro, baba sometin and sometin, but those who play golf are called by the first name otedola, dangote,Felix, tunde, abeg hustle ooooo

      Delete
    3. 3Amigos Bread @ 6 Okesalu St, Ikotun. 0813851632824 September 2020 at 17:27

      😂😂🤣 @ anon 14:21

      Delete
    4. All no be game oo. Golf is a class on its own. I was opportuned to be at a golf course last weekend and the kind of people I saw there, omo! I was flabbergasted. I don't think those set of people sit down to play draught.

      Delete
  3. Hustle o make people no know you with only branded T - Shirt when you spread cloth for line

    ReplyDelete
  4. Hustle o, make Stella no dey suspect your stories say you dey use style beg

    ReplyDelete
  5. Hustle o make pikin for your compound no talk say ''That unku wey dey beg beg don come oh''

    ReplyDelete
  6. Hustle o make you no hide for landlord tell your pikin say ''Tell him I am not at home'' then when him ask your pikin about you..''him go say my papa talk say him no dey''//

    ReplyDelete
  7. Hustle o, make you no be the one wey dem go call to open and serve drinks for village meeting

    ReplyDelete
  8. Hustle o make you do correct nyash surgery instead of to inject 100naira ororo to increase your nyash...

    ReplyDelete
  9. Hustle o make you sef buy Ferrari for your children instead of to jump danfo

    ReplyDelete
  10. Hilarious comments loading 😂🤣😂🤣😂🤣😂🤣😂🤣😂🤣😂🤣😂🤣

    ReplyDelete
  11. Hustle o, make u no dey call everything vanity.

    ReplyDelete
  12. Hustle all you can but always remember;
    "It doesn't depend on human desire or efforts but no God's mercy" Rom. 9:16
    🤷🏽‍♀️🤷🏽‍♀️🤷🏽‍♀️🤷🏽‍♀️🤷🏽‍♀️🤷🏽‍♀️🤷🏽‍♀️

    ReplyDelete
  13. Hustle o make people no dey ignore your phone calls when you dey call them

    ReplyDelete
  14. Hustle oo make u no dey say vanity upon vanity to justify your poverty

    ReplyDelete
  15. Hustle ooo;so you won't be saying the latest Samsung Note 20 or S20 ultra is waste of money...

    Hustle ooo;So after your village town meeting,the chairman would call you and be like "Mr Martins;is there any other thing you would like to say or add to the ones we have said already??"

    Hustle ooo;so you won't be ranting why you can't buy one plot of Land for 80million at Ikoyi,when you can use the same money to build at Badagry or Okokomaiko..

    Anam Abia!! 😉😊😉

    @MARTINS

    ReplyDelete
  16. Hustle oo, make ur phone dey ring oo

    ReplyDelete
  17. My brother hustle oooo,so that you fit pay 3,100,000 for private jet.

    ReplyDelete
  18. Hustle ooo,make you no talk say Gucci and Versace logo na satanic symbol.

    ReplyDelete
  19. Hustle ooo make your children no call you useless father because another man buy Ferrari for him children...

    ReplyDelete
  20. Hustle o, make u no dey talk say i ll rather sleep in my car than lodge in an expensive hotel...

    ReplyDelete
    Replies
    1. 3Amigos Bread @ 6 Okesalu St, Ikotun. 0813851632824 September 2020 at 17:28

      😆😆😆😆😂😂😂

      Delete
  21. Hustle oooo,make your girlfriend no tell you to collect your friend iPhone so una go snap.

    ReplyDelete
  22. Hustle ooo make yard people no dey call you to ask if light dey

    ReplyDelete
  23. Hustle oooo so that you go fit buy Ferrari for all your children.

    ReplyDelete
  24. Sis Hustle oooo,make another girl no collect your boyfriend with "All bills on me".

    ReplyDelete
  25. Hustle ooo,make dem no borrow money do your burial.

    ReplyDelete
  26. My guy hustle oooo,make your babe no upload another guy picture because she know say you no get data.

    ReplyDelete
  27. Hustle ooo make people for your area no nickname you "garri drinker".

    Hustle make your children no vex say them no fit chop Christmas chicken.

    ReplyDelete
  28. Hustle ooo,so that your child will be called baby and not "pikin".

    ReplyDelete
  29. My brother hustle oooo,make another guy no use tinted glass carry your babe pass you.

    ReplyDelete
    Replies
    1. This actually happened to someone I know.
      He's in a better place now though.

      Delete
  30. Hustle oh make you no dey chew one gum all day even keep am for one place when you wan chop and continue chewing after eating..

    ReplyDelete
  31. Brother hustle,so no babe go tell you good night and still dey online.

    ReplyDelete
  32. Hustle ooooooooooo,make Dem no use you dey do example of longer throat person...
    Hustle ooooo,make Dem no see your call dey reject am because of beggi beggi
    Hustle oooooooooooooo, make you get mouth for where your mates dey..
    Hustle oooooooo,make you no because of wetin u go chop,call red black.....

    ReplyDelete
  33. Hustle o make you no fall for scammer message of you don 'win price' wey you no work for o

    ReplyDelete
  34. Hustle ooooo make billionaire pikin no turn you to sperm bank......

    ReplyDelete
  35. Hustle oh make your neighbors no dey come tell you "abeg, when shoemaker pass help me call am"

    ReplyDelete
  36. Hustle oh make you no dey use chalkboard, calculator, stone etc to calculate before you spend #1000

    ReplyDelete
  37. Hustle oo,make you no stay for self contain or one room,wey your children go dey see your bura and go dey gossip you and mummy after una don nack...

    ReplyDelete
  38. Hustle ooo,make you no go deposit 50# so that you go fit withdraw 1k.

    ReplyDelete
  39. Hustle ooo,make dey no tell you say your shoe fine but i know say the original go cost.

    ReplyDelete
  40. Hustle oooo,because there is no dignity in begging.

    ReplyDelete
  41. My sister hustle ooo make you one pant no tear for waist due to lack of money chai this nah life experience.poverty bad oh.

    ReplyDelete
  42. Hustle oooo,make your pikin no go dey turn on post notification on Bobrisky page because of giveaway.

    ReplyDelete
  43. Hustle so you won't call a person a liar when they are sharing their life experiences simply because it is different from yours.

    ReplyDelete
    Replies
    1. 😄 this would have been better in pidgin English.

      Delete
    2. Bomb!!! 😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂😂

      Delete
    3. 3Amigos Bread @ 6 Okesalu St, Ikotun. 0813851632824 September 2020 at 17:25

      Side eyes 👀👀👀👀 to the anon that accused me of lying for writing that I’ve never been in a keke 😂😂😂😂😂😂

      Delete
  44. My sister hustle ooo make one pant no tear for your waist due to lack of money chai this one nah life experience.poverty bad oh.

    ReplyDelete
  45. Replies
    1. Honestly mehn
      Where is our Hustle Queen
      I kept scrolling for her comments

      Delete
  46. Hustle, so you won't have the need to put on a false humility which you don't have and suppress the gangsta aspect of yourself that wants to come alive during arguments.

    ReplyDelete
  47. Hustle ooo,make you no hang charger for your neck dey find where you go charge phone.

    ReplyDelete
  48. Hustle ooo,make you no use person phone snap,and when you wan collect am,dey go tell you say dey don delete am.

    ReplyDelete
    Replies
    1. I choked on this one 😂😂😂😂

      Delete
    2. 3Amigos Bread @ 6 Okesalu St, Ikotun. 0813851632824 September 2020 at 17:33

      Oh my 🤣🤣🤣🤣😆😆😆🤣

      Delete
  49. Hustle ooo,make dem no write "we rise by lifting others",because dey sub for you.

    ReplyDelete
    Replies
    1. 😄You stop it right there. Stop.

      Delete
    2. 3Amigos Bread @ 6 Okesalu St, Ikotun. 0813851632824 September 2020 at 17:34

      @ Convice Me, your response got me reeling 🤣🤣🤣🤣

      Delete
    3. Loooooooolllllllll........this life no balance true true

      Delete
  50. Hustle, so when you hear a good news the first thing that comes to your mind won't be "Audio".

    ReplyDelete
  51. Hustleoooh so that anytime you ask for price of a product, seller no go first tell u say e costoooh.

    ReplyDelete
  52. Hustle oo,make you no dey reply Amen for all the online prayer points

    ReplyDelete
  53. This comment has been removed by the author.

    ReplyDelete
  54. Hustle oo,make you born fine baby,make dey no use am act devil/Satan for school drama.

    ReplyDelete
  55. Hustle, so that when you see someone carry a 'Birkin bag' you won't hiss with anger and say "waste of money".

    ReplyDelete
    Replies
    1. Chai!!!!
      Today's hussle quote is smoking hot.

      Delete
    2. 😂😂😂😂😂😂😂
      Or type there are people who haven't eaten and you're buying a Birkin bag lmao!!!!!!

      Delete
  56. Hustle ooo,so that your neighbours no go pursue your children when they enter their house to watch television.

    ReplyDelete
  57. Hustle ooo,make you no tell your children say Gotv and Dstv na the same .

    ReplyDelete
  58. Hustle ooo,make dey no use shop rite jollof rice shift your daughter pant.

    ReplyDelete
  59. Hustle, so you won't have to tell your kids "Education is not everything, look at Mark Zuckerberg" when they are being sent home for school fees.

    ReplyDelete
  60. Hustle o make your neighbour no come buy tv dey ask you if u need d carton

    ReplyDelete
  61. Hustle ooo,make dey no on hotspot for you come off data.

    ReplyDelete
  62. Hustle oooo,make your neighbour no come knock for your door say im dey find his fowl.

    ReplyDelete
  63. Hustle ooo,make your brain no turn to calculator during shopping.

    ReplyDelete
    Replies
    1. No be lie ooo, sometimes your brain will be playing mind games with you

      Delete
  64. Hustle ooo,make dey no give you isi okuko and ukwu okuko for occasion come tell you say meat don finish

    ReplyDelete
  65. Hustle, so you won't feel the need to force down our throats the false narrative of 'everyone' striving to survive in abroad and washing toilets.

    ReplyDelete
    Replies
    1. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣

      Delete
    2. That comment struck a nerve in you Sabella. Sorry o

      Delete
  66. Hustle, so that when you hear that "Iphone 20" is out in stores around you, you won't say, "phone is phone, as long as I can send text and make calls I am fine...you know I am not a materialistic person".😏

    ReplyDelete
  67. Hustle, so you won't feel the need to console yourself and chant, "I like my girls natural... I don't like flashy girls, I don't like flashy girls", meanwhile you are liking the pages of high maintenance women on Instagram.

    ReplyDelete
  68. Hustle ooo, make Nurse help you massage bumbum after injection with humility,come still ask if the massage belleful you.

    ReplyDelete
  69. Hustle oo, so that you can afford the food wey dey hungry you for real life instead of dem village people serving you in your dream

    ReplyDelete
  70. Hustle ooo make person monthly body cream no be your salary.

    ReplyDelete
  71. Hustle o make dem no ask you 'who is bankrolling you'

    ReplyDelete
  72. Hustle o make you no be person wey dem go tell 'i have a short fuse'

    ReplyDelete
  73. Hustle o make you no dey scream 'leave this zoo' everytime while you tanda gidigba inside the zoo

    ReplyDelete
  74. Hustle o make Isaacbaba no forget to include your name for data giveaway

    ReplyDelete
  75. Hustle o make you no dey comment 'pls martins help my phone is always hanging'

    ReplyDelete
  76. Hustle o make you no turn Usain Bolt inside SDK inbox

    ReplyDelete
  77. Hustle o make you no commot eye glass before you faint

    ReplyDelete
  78. Hustle o so that when others dey go vacation abroad you no go say home sweet home,i love my father land

    ReplyDelete
  79. Hustle o make person no see your coke/fanta pictures ask you 'wetin do your skin' you come reply 'na camera angle'

    ReplyDelete
  80. Hustle o make person no ask you why you still dey ride mercedes 230 you go say 'cars of nowadays are not strong'

    ReplyDelete
  81. Hustle o, make usher no dey skip you wen dem dey pass offering plate for church

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141