Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Ndume Don Free After He Sleep 5 Days For Him Paale Bunk..

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, November 27, 2020

Pidgin Post - Ndume Don Free After He Sleep 5 Days For Him Paale Bunk..

Chai.........................
To do good thing sometimes dey back faya and nah wetin hapun to Senator ali Ndume wey leave work wey e get say e wan stand shorty for the former Chairman of Pension Reformed Task Team (PRTT) wey don pick race....







Court for Abuja don kuku release Ndume on bail after e spend five days for em paale bunk wey dem dey call has released Senator Ali Ndume on bail Kuje Correctional Centre.


The judge say e release am because e get good conduct....wetin that one mean?

The reason wey dem send Ndume go em paale house na because Maina wey e stand shorty for don run but e never comot naija,e dey Abuja dey hide for em in law house according to wetin dey for ground oh....Dem say e spread news say e don run so that dem go find am waka far while e conclude how e go take run four forty....

Make we dey watch news sha.......

4 comments:

  1. So Maina dey inlaw house for abuja and they never arrest am? You see why I said that all these na scam.
    Where is Evans and his case today?
    The media and poli-tricksters are in complicit in doing us yahoo, yahoo when e concern high profile cases of loot. make I drop mic here. 🎤🎤🎤

    ReplyDelete
  2. That means the culprit,maina has gone scott free????
    Na wa

    ReplyDelete
  3. No be naija again? Paddy paddy government. Na who fall dem go wash

    ReplyDelete
  4. Me na dey pity Ndume Natall Natall.. because if him no be Maina accomplice and G for dis mata wey dey ground so e no go stand for am.. laslas na Maina and em peeps still pay bail am so.. check and balance am na..

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141