Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - NFF Presido Cry Like Small Pikin Sake Of Say Eagles Draw Match With Sierra Leone

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Sunday, November 15, 2020

Pidgin Post - NFF Presido Cry Like Small Pikin Sake Of Say Eagles Draw Match With Sierra Leone

Mr Pinnick,the Presido of Naija football body on Friday begin cry like small pikin after Naija national team follow Sierra Leone drag 4-4 goals for 2020 Africa cup of Nations qualifier instead make dem win the mash...





 

Na Super Eagles first begin score ,come score reach 4 goals but before pesin go look back,look front,the other team don score dia own 4 goals.


Pinnick go yarn with the team for the place wey dem dey change cloth after or before mash, come begin yarn them how e begin cry as the oda team score their own goals...
E tell them say football na football oh and anything fit happen but wetin e eyes see wey dem play,no be am at all at all..


E come tell dem say last last na em name people go call as dem no win so.....


 I wonder why pesin go dey cry becos of say e team no win,wetin e come want make we Arsenal fans do?Make pesin epp me tell the Pinnick guy say we Arsenal fans dey salute am,make e nor dey cry anyhow abeg!!!

7 comments:

  1. Maybe the man stake big money say Super Eagles go win the mash.
    As Dem con draw, e dey cry cause him done lose the big money

    ReplyDelete
  2. Him go dey alright. He never ready to let go of his job that's why.

    ReplyDelete
  3. After de cry cry, de man don clean him eyes with estacode.

    ReplyDelete
  4. When dey refuse to employ better coach nko. Him think say other African teams come to look empty stadium.

    Lovelace

    ReplyDelete
  5. Amaju used to be very cute that year in Warri.
    Very smart guy though.
    He went to Hussey college, l had a crush on him that time.
    Intelligently stubborn boy he was....

    ReplyDelete
  6. amaju, all the estacode you dey chop suppose wipe those tears from ya eyes

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141