Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Policeman Wey Dey Sell Native Wear...

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Thursday, July 29, 2021

Pidgin Post - Policeman Wey Dey Sell Native Wear...

 The story no balance at all!




Them catch person wey be alleged scammer but after some time e come confess say e be scammer and as e dey confess, e come mention Police name say e pay am to arrest and jail em enemy but Police come do rejoinder say na native outfit join em and scammer together..

E say scammer pay money to order for native when e see for em page for Facebook and say scammer pay directly to the clothes seller akant...

Police never answer wetin the money wey scammer pay into em akant dey for and we still dey wait because the story no complete at all, e no make sense.Why that people wey dem dey call FBI go mention name for document if dem no see anything for akant from scammer to Police?

We dey wait for better explanation from Police, at least if you wan follow scammer chop and help am hide em work, you suppose to sabi lie nah.


Abi how una see am?

2 comments:

  1. Everyday for the thief, one day for the catcher. I don't pity him at all.

    ReplyDelete
  2. E for be better lie make e say e dey work undercover to fully understand their doings. If the tailor no fear to even carry the cloth wen no concern you come your office, na hin be say e no respect you be dat. If na bomb, na so dem go receive an…….. odiegwu 😄😄😄😄

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141