Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponis Corner - Mama Nedu Son Virgin Bride...

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, April 01, 2022

Sisi Senaponis Corner - Mama Nedu Son Virgin Bride...

Make una come hear tori ooooh...









Una doh o! SDK pipu dem dem!


Mama Nedu say Nedu wan marry. He don bring wife come house. She say she nor too trust the geh. As Nedu talk say she be virgin na im Papa Nedu nor kukuma get problem with her again.


Mama Nedu say she bin feel say something is not right! Na im she invite the geh come her shop. Begin tell her say she dey happy and proud as she be virgin as their tradition na make the couple go perform ritual in front of Family elders.


Mama Nedu say small time the geh begin divert her calls. Nedu sef nor gree show for house like before! Wetin dey occur?



Nedu sneak come house, she quick corner am, begin ask why he and him gehfrend dey avoid the wedding plans? Nedu say the geh get cold feet, say her religion nor dey gree traditions.


Mama Nedu say no problem. Aftoroh, dem be virgins, nothing go do dem! Na im Nedu say he nor be virgin again o! Mama Nedu say since when? He say since he meet this geh!


No problem, the geh nko? He say No, but na him disvirgin her!


Mama Nedu say no problem! Make dem come house to continue plan. The couple show for house, Mama Nedu carry the geh go her shop. She tell am say nothing go do am at least na Nedu kukuma disvirgin her. She give the geh kolanut make she chop, say when she wan born, the pikin no go hang, or pull her life comot!


Na im the geh quick knee down, begin cry dey beg Mama Nedu say, 'Abeg o! Nedu nor be her first o!' She say 'she do 'tightening' down below, wey make am be like na the first time.


As Nedu nor kukuma get experience, Say Nedu na like some numbers after 10!'


Mama Nedu say no problem, chop the kolanut, at least you love Nedu and you are fertile and pregnant already ba?
Na im the geh say...'she no get belle again, say she don see her period last week!'


Mama Nedu say no problem, you see your period mean say you dey fertile.
The geh resume cry again! Say 'she no too sure o, say the last Abortion wey she do, the way the Nurse dey look her, something dey wrong!'


Mama Nedu say no problem, Abortion na Sin but God go forgive as na maybe one time?...

The geh say 'No Ma, na the 5th time, but she don repent and na why she wan settle down now!'

Mama Nedu say with good man, from good home abi? Wey him life never spoil abi? The girl say, Yes!


I jor know say, I see the geh wey tanda for bustop with only one shoe and wig dey hang from inside nylon.
I dey rush pass, persin wah put for shop, don finish one carton of Ribena (Full Adort wey nor be pikin o!) Na dia I dey run go! 


Na later Mama Nedu even gimme dis gist.

24 comments:

  1. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣,wahala.

    ReplyDelete
  2. Sisi Senaponi! Amebo go kii you 😂😂😂😂

    ReplyDelete
  3. I found it really hard to read this...

    ReplyDelete
    Replies
    1. I just scrolled to the comments. Can’t have headaches this afternoon

      Delete
    2. This one is in plain pidin now,last week was wow,could not read it. U just have to read it slowly.

      Delete
    3. Won tun ti de o! Complainants United! This simple pidgin. If concentrated waffi come near you nko? E ma wa orite!

      Delete
  4. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  5. This comment has been removed by the author.

    ReplyDelete
  6. Fornication and abortions have consequences. The devil who is tempting you presently will use them against you when you want to enter marriage which is God's institution.

    ReplyDelete
    Replies
    1. yes, only people who do not know the reality of the spirituality of life and Christ
      engage in fornication.

      Delete
  7. Yea, Sisi, you pidgin today is better understood. Please do not return to that other one.

    ReplyDelete
  8. Maybe nothing dey that kolanut. ,😅😅😅😅

    ReplyDelete
  9. Sisi aproko no go kill you for your area oooo😭😭😭😭😭😭😭😭😭😭

    ReplyDelete
  10. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣 Mama Nedu the investigator🤣🤣🤣🤣🤣

    Sisi Sena, you are good!

    ReplyDelete
  11. Inside this country...eyes haff seen what ears haff not heard!😂😂🤣🤣

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141