Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Bobo For Landlordship!!

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, May 13, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Bobo For Landlordship!!

Cant stop laughing!!!








Una kpoi kpoi o!


Stellamamalade!


Baba herbalist, pikin don go registry with him oyinbo wife, before that one eye go clear, that boy go don build him papa house for Banana. *choi, this life ehn*


Bobo, our landlord pikin, call meeting say he want to contest for landlordship, say him papa no sabi do the work again!


Landlord go sidon for balcony jeje like pikin wey dem carry Exam give!...Landlady travel go do omugwo for persin wey we nor know!


Bobo warn Mama Ejima make she no dey come block am for corridor with only wrapper for bwess! *clickstongue*


The corpers don run comot, na only one remain, as Bobo don promise am firstladyship!*Ok na!*


Bobo say if we vote for am war go dey, if we no vote for am war go still dey!


Bobo carry oga harvest bucket, use the water baff, he return empty bucket.
Oga harvest para give am! Bobo comot cutlass, Oga harvest don lock door dey read bible for over 5hours now!


Bobo say he want make I, become him personal cook! He carry list for food timetable give me!


I dey see pounded yam for breakfast. I see Afang and oha! I see amala and gbegiri for one corner! I sight goat head, tongue and cow blokos! I don help am add Salad and moin-moin!


I laff throway leg abeg! Make i go find Mama Timo, wey her husband dey sidon 4hours ontop mat, dey help her pick bag of beans! *sideeyes*


I just wan borrow something from her hand, I no go too teh!


Pikin wey say him mama nor go sleep, na error to carry the same crase come my side! *clickstongue*






Hahahahahahahahahahahahahahahahaha

12 comments:

  1. This your amebo na follow come πŸ˜€πŸ˜€

    ReplyDelete
  2. 🀣🀣🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  3. 🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  4. no be small something.. hahaha....

    ReplyDelete
  5. 🀣🀣🀣🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  6. This is like me reading Toni Kan in those days! Reading was fun!
    I used to read on the toilet seat where no one would disturb meπŸ˜„πŸ˜„πŸ˜„

    ReplyDelete
  7. Wahala 🀣🀣🀣

    ReplyDelete
  8. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  9. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚ the wonders of Life.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141