Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Wonders No Fit End.

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, July 25, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Wonders No Fit End.

 WHAT!!!





Wonder nor dey ever end abeg!



Na salon I dey wey two friends begin gist.


The tall one say na so she decide to spend time as overnight, weekend, sleeping over things with her new Bobo.


She say na Festac area, so the bobo say him Grandmama and the mother dey live with him for house so he no go fit invite the Babe there.


The two decide to meet inside hotel and enjoy the friday and Saturday together.


*as only Sunday na holyday, fornication can resume on Monday abi?! Plus aunty go need to 'sing' for choir and brother too na 'head' usher for him side!* clears throat*


Baby say as they don agree say na hotel, her mind be say na her bobo go settle the bills.
Bobo call her say make she send him 50k say the room wey he plan to book don dey overbooked so make dem upgrade.


The Mumu geh send am the 50k. She branch eatery as na work she from come, she carry uber reach the hotel, guy man don already dey familiar with the female receptionist and the entire casts and crew wey dey the hotel! *sideeyes*


They enter room, baby say she wan call room service for dinner. Bobo say the hotel food nor too sweet, make they go out chop better Amala.


Na babe request uber wey come carry dem go chop for buka. She say the kain things wey bobo order full seperate plate from the plate wey soup dey!


She say time reach to pay, bobo come ask her if she get change for pocket, as he nor carry ATM and they nor dey accept transfer. Baby carry cash pay the Amala people.


They comot go back hotel room, time reach to baff and sleep. Bobo say he wan watch match. Babe go baff and enter bed to sleep as Bobo still dey watch telly.


He finish match , come look the eatery chicken and chips wey babe carry come from house. He say the thing go spoil.


Babe say mba, make he either put am inside the room fridge, or leave am for table say she never belleful from the Amala as na only half wrap she chop. Plus say she like to wake up and chop for night, say she go chop the chips and roasted chicken.


Bobo say e no make sense, say the chicken go lose taste. Na so Bobo clear road, consume everything!


Babe wey don taya doze off.She wake up see say Bobo sef don sleep for edge of bed but he never baff or comot cloth.


She say na so she wan do romantic something to touch the below and caress him make he quick go baff come enter bed.She say her hand nor see anything!


The matter come be like when Israelites carry spies go check that land for inside Bible wey dem see tall, tall people...


Nne, na why i nor dey like sidon near Agar inside Sunday school be this! Na hot kpoff kpoff wey dey her bag wah dey eye, when teacher bin tell us the name of the area, abeg make una nor vex.


The difference be say giant nor dey where this aunty hand dey roam, infact dwarf sef nor show! The land just be like Sahara desert na sand sand wey just gallop full everywhere!


She say she jump up comot for bed say! Abi Bobo na 'himsh' abi na 'shimsh'!? She quick cover her mouth to shiish before shii go hit the fan!
She quick wake Bobo say make he comot cloth go baff. He say he nor dey baff say morning go soon reach! *olololo!, e don hapun e*


Na when person dey chop 4wraps of swallow and goat meat, come back room with woman wey everything for her body dey do kpechikom, and e nor near the babe, she suppose don suspect say this man wan use her beer drink garri!


She say ok comot cloth, come sleep for bed properly. He say he still wan go downstairs to the pool area. As tourist wey him be! *sideeyes*


Babe say she pretend like say she wan sleep, small time bobo off light, comot cloth, enter under duvet, turn back to baby.


Baby say she come reason say maybe na shy bobo just shy o! As na hot babe wey she be Na!


She say na only boxers bobo wear wey she grab am say make she help him shyness! Akuko!
Nothing dey dia! *clickstongue* Be like 2year old pikin something for grown man body!


She say fear catch am as he quick wake up push her hand comot. She say her mind still dey tell am say maybe e get how the owner dey take arise the thing wey go come get dimension *clickstongue*.


She say as she balance say today na today o! Man wey fine like this, 6ft Plus, Skin like chocolate, English like the Brits! Hian, She must to collect, person wey don dey discuss marriage with her. She must to check and balance the ferifera!


Na so she begin find bobo something wey nor miss under duvet.Bobo come dey form attitude say why she want make dem sin before they marry! Baby say make e nor vex as the thing sef na waste of sin! As the experience na like biro cover. She kukuma leave am, face wall.


Day never too break wey Bobo wake up begin wear cloth back, where you dey go? He say he wan quick reach house to see him grandma say e go soon come back.


As e comot, baby call reception to order breakfast. Den tell her say her money nor cover food say na extended day!


She go reception na man dey duty. She seduce am!


That one tell her say the room don dey booked for 4days FOR her bobo say even that Friday na extended day (1 extra night promo) checkout time na 12pm that Saturday.


She say she confuse as dem say if she wan chop, na to pay for the food separate, say na promo make dem give the extension till that Saturday for long time regular customer wey Bobo be! *wonderment*


She ask how much that room be? They say na N12,500 per night. She go pack her bag, do uber go house, block the bobo for phone after she don thank am for the opportunity to dish am breakfast after he don serve her buffet!


I say make i ask the aunty to show me the bobo picture for phone, make persin nor go jam one chance! She say who I be? I say make she nor vex, na me find trouble. Picture wah don already see as I stretch hand to carry magazine...kiikiikiii.








11 comments:

  1. Eweee! Clear evidence of don't judge a book by it's cover..Make he no go find help o,make he continue dey steal kobo kobo with his good fr##king look.mtchwww🤧

    ReplyDelete
  2. 🤣🤣🤣the babe too mumu sha

    ReplyDelete
  3. The bobo just cash out for her head,

    ReplyDelete
  4. Correct Bobo. He no wan commit sin, come hide pingolo under skin before daughter of Eve go tempt am. Dt Bobo na thief, using pea size dey collect money from babes. 🤣🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  5. Golddigger ni bobo yen!scamming ladies! Imagine the nonsense! That's how one innocent sister will marry this one with his tiny something!

    ReplyDelete
    Replies
    1. The babe na olodo. Some ladies just grow, mature but no brain

      Delete
  6. 🤣🤣🤣...guyman chop am mugu

    ReplyDelete
  7. This jist sweet sotey you no remember to hail Stella 😂😂😂

    ReplyDelete
  8. See as I dy laugh like mad woman here

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141