Stella Dimoko Korkus.com: The Hustle Post

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, July 25, 2022

The Hustle Post

 Hustle Ooooh make small pikin no jump konk your head because you borrow money from em hand....

- Hustle oh make you visit person dem begin hide food because of your longer throat.


You next!!!



52 comments:

  1. Hustle make your friend no turn you to sales girl o.

    ReplyDelete
  2. Hustle o make dem no suck your wife breast for national TV call am 'content' come divorce you ontop.😏

    ReplyDelete
  3. Hustleoooooh make them no drag u to go and wash plate at an event.

    Hustleooooh so that when u threaten ur pikin with disowning, ur pikin no go yimu u

    ReplyDelete
  4. Hustle o make APC no give you 'bishop' cloth come humiliate you for national TV.

    ReplyDelete
  5. Hustle oh make them no call you begi begi

    ReplyDelete
  6. Hustle o,Make dem no turn you into photographer for event.

    ReplyDelete
  7. Hustle oh, make you no because of 1 derica of palliative🙄🙄 go vote nonsense come 2023

    ReplyDelete
  8. Hustle ooo, make dem nor use tinted car pass with your wife, you con dey shout "My governor, carry go 2nd term.."

    ReplyDelete
  9. Hustle 😩😩😩😩😩😩make your mother in - law no go they send you small pikin errand.

    ReplyDelete
  10. Hustle ooooo make your father in - law no go ask you say make you go look after Cow 🐮... When there's an occasion...

    ReplyDelete
  11. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES25 July 2022 at 14:18

    Hustle ooooo make you no dey share one room with your family of seven.

    ReplyDelete
  12. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES25 July 2022 at 14:19

    Hustle ooooo make them no use your atm card do ruler.

    ReplyDelete
  13. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES25 July 2022 at 14:21

    Hustle ooooo make them no use your teeth as bottle opener for meeting.

    ReplyDelete
  14. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES25 July 2022 at 14:23

    Hustle ooooo make you no allow your garri to swell before you drink am.

    ReplyDelete
  15. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES25 July 2022 at 14:24

    My sister hustle, make you no call trekking under hot sun exercise.

    ReplyDelete
  16. Hustle ooo, make small pikin no hide biscuit if them see you.

    ReplyDelete
  17. TASTE BLISS CAKES AND PASTRIES25 July 2022 at 14:25

    Hustle ooooo make NTA no be your favorite channel.

    ReplyDelete
  18. Hustle 😩 😩 😩 😩 😩 😩 ooo make your father in - law no go ask you to monitor cow 🐮 when occasion comes up..... God bless your legit Hustle.

    ReplyDelete
  19. Hustle make your neighbors no turn you to gate man. Anytime they come back. You will hear. Papa Nkechi please help us open gate.

    ReplyDelete
  20. Hustle so that you will not always ask for urgent 2k

    ReplyDelete
  21. Hustle make dem no turn you to wine server for village meeting.

    My brother, hustle make your friend Pikin no ask you why you dey visit them every evening at dinner time.

    Hustle make your relative no send I'm Pikin to "bring that plate wey dem dey take serve uncle food".

    ReplyDelete
  22. Funny comments.
    Let me try.

    Hustle oh, make you no use your nysc white polo take do singlet.

    ReplyDelete
  23. Hustle oh, make neighbors no ask you boya NEPA bring light when dem go work.

    ReplyDelete
  24. Hustle ooo make you no allow your landlord snatch your wife

    ReplyDelete
  25. Hustle o, make family and friends no avoid and busy your call.

    ReplyDelete
  26. Hustle o,make man no tell you say get out of my house

    ReplyDelete
  27. Hustle ooo make ur young ones no day take decisions for house without you..

    ReplyDelete
  28. Hustle oooo before cold finish you this rainy season because of your one yard threadbare wrapper

    ReplyDelete
  29. Hustle oo make you no come depend on your children at old age.

    ReplyDelete
  30. Hustle o make your family and friends no see your call ignore am

    ReplyDelete
  31. Hustle oo, make the transformer for your area nor first you blow.

    ReplyDelete
  32. Hustle o make dem no use your waist belt as opener for ceremony.

    Hustle o make dem no swallow ur comments for giveaway because u be beggy beggy.

    Hustle o make dem no use your doormouth as parking place when landlord wan repair compound as u no de commot for house.

    ReplyDelete
  33. Hustle o make you turn from blog begger to blog angel.

    ReplyDelete
  34. Hustle o, make you no dey hail pesin wey reach to be your grandchild 'mormee', ' oba' 'my queen'...

    ReplyDelete
  35. Hustle o...make you no dey home for strike but come online dey support Tinubu

    ReplyDelete
  36. Hustle o, make we make Naija better.

    ReplyDelete
  37. Hustle, make you marry, born children o, get your own family buh hustle in God’s way through prayers o

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141