Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner -Paranranran Palava

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, September 19, 2022

Sisi Senaponi's Corner -Paranranran Palava

 🤣🤣🤣





Una doh E!

Na who dey SDK yard E!


Stellagubernatorial-electoral...I hail o!


E don tey wah hear paranranran for area like that. Na im even remind me this gist wah wan give you!


Mama Ejima open door begin shout for yard early momo!


I open window say, Na you and who?!
Na who thief your pikin?! Nor gree to pay dem ransom o! Gee dem only two days, na dem go return your bushbabies,sorry pikin! *sideeyes*


I say abi na who wan carry belle gee your horseband..sorry their husb...your husband?!
They nor dey fear?! Dey nor know you?! You wey be say thief catch thief na your...sorry abeg na wetin hapun?! *sideeyes*


Mama Ejima say na her younger brother wey she carry LAPO loan give to buy trumpet, he say he wan use am do business as the surprise, surprise thing dey reign that time, Even though we know say sometimes na the person wey order the thing, kukuma get the thing but during the pepperdem skit, una go dey hear, Oh! My God! Who did this for me! *Yinmu!*


E nor go kee you to buy the cake, sidon for house, lem the level and sleep!
Aftoroh, honesty nor dey kee persin...except for person wey tell soldier say na im slap soldier wife! God abeg e!


I say so wetin come hapun? But money dey the business true true Na!


She tell am make he tell me wetin hapun!


He say him girlfriend na cake baker, so anytime wey person order cake, she dey ask if they wan do paranranran and she go call him so dem go go!


I say that one na wonderful combination, I say wetin remain na make dem kukuma marry, born pikin, make the pikin sef turn Drummer or towncrier, so the crew go kukuma complete!


He say the first one he go went well but na the second one get K-leg. *Hian*


He say him Babe call him say na hotel the Babe of the person wey order dey! So they both go meet the bobo for area and dem go the hotel together.


Na so dem reach hotel wey even the Receptionists and staff dey do ooooh-haaaa!
Some don dey even tap for the love sef!


Na im Bobo carry Room service, go knock door for 7am.
Aunty celebrant open door with lingerie wey get mad partition! Kiikiikii...Na im our trumpetier begin paranranran!
Cake madam dey shake body, carry cake give celebrant with plenty laughter and gladness of heart!


Na im celebrant turn hulk Hogan, she nor gree make door open well! He say na so her muscle cling for door handle! Like say na when village people hold persin destiny! Hian!


The bobo younger brother carry phone dey record the wonderful momentum!


Aunty open de door na! Make dem carry this cake wey heavy put inside na!


Those kain cake wey be say, if person carry one slice, stone person enemy, the enemy nor go ever wake up! If the enemy wake up, the brain go don enter reset like Taataa!


Na only icing dey cover the evil plan of the cake wey dey under!
Nor ask me! Mama Ejima don gimme the cake before! Na rat I use am stone for backyard!


Anor fit chop wetin anor know biko! No be by force to chop cement..sorry cake! *clickstongue*


This mumu boy say the celebrant begin cry, haa baby! Haa baby!
I say Choi! See as love sweet o!


Bobo hug him babe, use elbow open door. Madam cake go drop the concrete for table, paranranran begin flex muscle as the celebrity wey him be!


Na im one man comot for under duvet, on light, say what the something is going on hia! *kiikiikii*


He say celebrant begin vibrate, she say they just come deliver birthday gift for her! Like say she nor know any of them!


The naked uncle wear dross, begin look the scenario.


This mumu wey wan make dem send am go where he nor know, continue to dey blow yeye trumpet, even after the Bobo wey come do suprise say, E don do!


I say oh! So na there dem gee you elbow for mouth?! He say yes! I say continue, I dey hear!

He say na im the two Bobos begin ask the celebrant say who be who?!


Before this mumu go clean the mouth wey dey gush blood, cake don land for him head as the Naked bobo carry the cake to fling for Suprise Bobo head!


But una know say head wey go suffer, e nor matter even if persin carry am put under canopy!


As na him dey the angular radius! Fiam! Na him head the cake land! Cake baker don disappear as she hear 'do you know who I am?' and naked bobo don comot the leg of one chair! *God abeg e!


Oga trumpet say na so he sef rush comot!


I look am shake head! I say, you nor comot when the matter never sweet! Na when action wan start , you waka comot! Na wa for You o!


Na your type dey go church, begin parade toilet dey find wetin nor loss! Until angel nor go see una for chair comot and gee tbe blessing to another persin!


Abi you think say Angeh go find you go toilet?! This Nigerian toilet?! Hian! Make dem mob am, thief him wings! Una too dey watch oyinbo fim abeg!


Angeh nor get time like that o! Person wey dey assignment!


Except God get Nigerian Angeh wey e wan send you specially! Na those ones dey hep persin fight all those face-me-I-slap-you house battle!


Those ones rugged wehweh! But na after person don shout, freeze throat, use prayer block God ears? he dey use vex, dispatch dem!


I just imagine say, God go say ' una nor dey sleep!' God nor know say na midnight, day just dey break for face-me-I-slap-you!
Na that time the real tenants they utilise the facility!


So mumu nor carry trumpet come house! He nor get mind to go back the hotel!


Him babe wey bake cake tell am say the celebrant lie give bobo say her girlfriends dey host her for the hotel, after dey don do girls night out!


So na the baker even call the celebrant to ask for the hotel address, say she wan come deliver gift for her. Baker say she nor tell celebrant say her bobo wey order,go follow come!


I say anyways, e don hapun be that! If your sister Iya Ibeji nor quick find the money to return, dem go carry her bwess put on top lantern and lock you yourself inside toilet!

I carry my bucket mah go fetch water baff, day don kukuma break!



 Haahahahahahahahahahahahaha abeg abeg abeg

20 comments:

  1. Always laughing whenever I read your column.

    ReplyDelete
  2. Chineke! How Dem wan carry person bwess put on top lantern? This gal dey craze fah😂😂😂

    ReplyDelete
    Replies
    1. Na wetin dem dey call dem Lapo people be that nau 😂

      Sisi, you no go kill person gaskia 😂😂

      Delete
  3. 🤣🤣🤣😂😂😂😂
    Surprise gone wrong.
    Na that cement cake dey vex me pass. Some bakers no sabi say cake nor suppose dey hard/strong.
    Poor bobo wey carry paranraran

    ReplyDelete
  4. LMAO.... sisi I hail you,amebo wey get weight.

    ReplyDelete
  5. I started...but couldn't continue, someone has to be in the right mood. Be back to finish abeg

    ReplyDelete
    Replies
    1. My dear same here. Had to scroll through the comments to see if it’s worth the read

      Delete
  6. 🤣🤣🤣🤣🤣 this one na surprise gone wrong! Some girls get mind Sha .

    ReplyDelete
  7. 🤣🤣🤣panranran gone wrong

    ReplyDelete
  8. Funny but educating. No dey Waka up and down inside church

    ReplyDelete
  9. Panranran isonu.....sisi i hail o

    ReplyDelete
  10. Panranran in the mud

    Surprise Bobo in potopoto😂😂

    ReplyDelete
  11. 🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  12. Gifted and talented. Very so.

    ReplyDelete
  13. Sisi killode? You don scatter my ribs.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141