Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponis Corner - Okro Without Meat Versus Imported Cereal Sachet

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, December 09, 2022

Sisi Senaponis Corner - Okro Without Meat Versus Imported Cereal Sachet

 Hehehehehehe



Kpoi! Kpoi! Kpoi! Una doh o!

Stella-beverly-lehaiti... how your side? I hail o!

Na for the woman wey near Iya Dada shed, i quick go buy sachet milk and coffee...Anor too sleep last night!

Na as we dey settle one kworeh for yard, na im another set begin use slap do souvenir

The one wey dem knack bucket, collect bucket! The one wey na charm dem knack, don collect charm!
Na only God go reduce vawulence ontop woman and money matter! Anor know if na the hot weather sef dey contribute to anger!

I tanda for the Aunty Glory shed, to buy the things. Na so one woman come with her pikin, wey dey go school. She come buy imported cereal satchet, put inside the pikin school bag.

The other customer wah meet there begin hiss!

I say Aunty hope no problem o?!*sideeyes!*

She say na wa o! Say that woman wey na eba and okro without meat, she dey carry feed her pikin for house! Go come dey buy imported cereal for the same pikin to carry go school! Say no be fake life be that?!

Nna ehn, people get problem o!

I say Aunty, abeg how that one take disturb you?! No be wetin person like, she go carry give her pikin?!

I say so she suppose carry okro wey no get meat put inside bag for the pikin?!
She say yes na!

I say so person wey hustle buy pikin roadside rice and meat go school, because derica of rice and pepper don corss, don do bad?!

I say you think say big brands wey dey do their products into small small sachet no get sense?!

You nor know say na strategy and profit for dem to reach even the poorest!

As they themselves know say nor be everybody fit afford the big big sizes! All fingers nor equal na!

She say ehn, no be by force to dey chop those things! Say the pikin go grow up to live fake life!

Anor bother talk anything...she do and comot.

Aunty Glory tell me say, na me get time to dey answer her, Say na when she sef born, she go understand wetin scale of preference be!

Say na pepper body dey do her!
So she wan make the pikin dey feel inferior amongst her mates for class or make she turn beggy beggy! *clickstongue*!

Carry frustration on top another person matter!

I say when e reach her turn, make she carry garri and oyel put inside pikin bag! Mschew!

9 comments:

  1. Hahahaha ๐Ÿคฃ๐Ÿคฃ

    ReplyDelete
  2. Sisisenaponi no mind am, na pepper body

    ReplyDelete
  3. Lol.

    Person go jus dey, dey chook mouth for thing wey no consign am.

    Mtchewwwwwwww.

    ReplyDelete
  4. Half of the people beefing you inside their mind, they know you didn't do anything directly to hurt them. Most are just possessed and full of hate!

    ReplyDelete
  5. ๐Ÿ˜‚ ๐Ÿ˜‚ Jealousy people everiwia

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141