Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Correct Mother In Law

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, January 27, 2023

Sisi Senaponi's Corner - Correct Mother In Law

Kpoi Kpoi Kpoi!!!




Kpoi! Kpoi! Una doh o!

Stellascopicdollarscopic...how de terrain?! I hail o!

Nna ehn...

Nothing sweet pass make person get in law wey like person pass their own pikin sef!

We dey go do community service for church. Na inside bus we begin gist after we don sing and dance well well.

Sister Deborah nor joinus, i ask her sister Josephine, she say her sister dey enjoy omugwo fhingz!

I say when she born?! She say na last month! I say nor be Aba you say she been dey that time.
She begin laugh say, Mba o, na Debby say make she nor tell anybody for church! *sideeyes!*
If una see this person wah dey talk, her belle nor dey ever show say she get belle.
She fit just say she dey come now, now, you go jor hear weehn weeehn! *pikin don land!*

She come get MIL wey set like dem Kardashian Mama, she nor dey age at all!

The MIL nor dey like make wife drop body on top say she don marry or born o!
The MIL body fit pass anything! Small small gehs nor get anything for her FIL side so!
Na Sister Debby ,first naming ceremony wey all of us attend.

From where me i sit, i don dey notice one lady wey carry like four people front and back!
Wey dey use hand push Sister Debby Orbii for head! Like small small.children play! Hian

This her Orbii wey nor dey follow person smile!
Even his wife sef nor dey follow am do anyhow for public! Na im this lady just dey use hand malandu anyhow!

E nor too teh wey Sister Debo come out, dey greet everybody.

I notice as that lady quick comot hand for the Orbii elbow. She begin press phone, do like say she nor rate the wife.

Sister Debby come sidon with we, the sisters of light! Nor be the agent of darkness wey sidon for that side! Dey rub rub person Orbii for head!

We gist gist Na im i ask her if she sabi the lady?
She say na her Orbii assistant Team lead be that for office! *you say?!*

I say ngwa, better hol your territory before this one go assist and lead him inside temptation!

I never even talk finish wey she say her MIL come drag her from inside room, say make she come use her own eyes see her competition!
Gbam!

5 comments:

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141