Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Balogun Packaging

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, March 20, 2023

Sisi Senaponi's Corner - Balogun Packaging

This one tough!



Kpoi! Kpoi! Una doh o!

Stellascoticscosco...i hail o!
Person wey lie give village people say he dey obodo oyinbo Christmas reach, dem begin wait am make he come carry wife, build house and drop dollars!

Na lagos he dey o! E nor cross Ikeja bridge talkless of enter helocopter!
He say he wan collect loan in 4 places, wey he go use buy 'yankeelike' things inside Balogun market to Carry and go village!

I say, you nor know say e get as the box of people from the abroad dey smell when dey open am?!
E get one unique, nice scent wey go dey everything wey dem bring come, plus their own body sef!

I say how you wan do am?! With this Lagos smell wey be mixture of borleh, igbo, burukutu and so on?!
He say village people nor go know the difference once he spray perfume.

Issoraite! So you mean am?! He say yes o! He gonna go oppress and retain level!
Inside this Hicnormi wey na management we dey!

He package and go o! Go jam person wey from come Canada legit with him own family!
They begin ask am which side him dey for the abroad, he use laff and sense cover am!
I bin wan whisper middle belt give am!
When the small pikin from the abroad begin look am one kain, he say he wan piss for body.
Una know say these obodo oyinbo children sabi embarrass person with kweshon. They nor dey fear to ask adort why him mouth dey smell?!

He do do finish o, twist tongue well well. Dey nor suspect say na wash o.
Na as he wan come back Lagos he hear say the real couple wey from come Canada don do paper for one young boy for their compound there! Make he go do school there!

He wey nor hold hundred dollars wey nor be aboki fake before, jor go waste money to impress, come back Lagos to start the hustle again!

He say na the night before he comot for next morning, the Canada bros call am for one corner ask him if dem deport am?!
He wan take offence and become defensive.Mumu say that's an insult bro!

That one say no offence meant, make he nor vex, say he jor wan understand the situation of things as family wey him be with the wife.

If he need any assistance.

Na so he jor lorss opportunity to really travel go the abroad ontop Balogun packaging!
I don go check if he open shop today!
Na okpa and koko he beenwack for shed!

He say that him Canada cousin wey be the wife carry belle for secondary school and na only him finish secondary and even go poly.

He say he nor fit come allow make people say after everything, na she come dey successful pass him. I say oooh! I hia you o!
Shame nor dey to beg and ask for help! Worse, the person go say No! E nor mean say God nor fit open anoda door!

17 comments:

  1. Hahahahahahaha. Like my sister wey go Delsu go stay for two years, say she dey school. Walahi, for those two years, my sister was just in the hostel doing nothing. According to her, someone was helping her to get the admission. This girl was also collecting school and hostel fees oo.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Na normal na. When I was
      living with big sis in their face me I slap you yard, she had an older neighbour who had two grown girls. One was her favourite because she brings money home while the other was the opposite, she no get luck for the holosho industry.
      The favourite lied to everyone she was in UST then, every morning she dresses up with her handout and goes there, takes lots of pics that she uses to do pepper them

      Her mum too knew her daughter wasn't schooling but she made everyone in the yard believe her daughter was in school. She dey use the babe mek mouth eh

      Not untill one day when she had a fight with her sis, that one exposed everything. She was angry their mum chosed her younger sis over her because her hustle pays better (reason why it's not good to compare kids or choose one over another).

      Mason yard scarra, babe moved to Lagos, she couldn't bear the shame. Not after all the bragging


      I have a villa bro who was squatting with his friends in school, as friends hang bag, he too will hang and follow them to class. Naso he follow them till they graduate

      Delete
  2. Fake life geng. Na dem. See as he take miss better opportunity. Maybe abroad no dey him destiny. Yeye boy.

    ReplyDelete
  3. Kai, Sisi you be correct werey. Your pigin na topnotch, I dey gbadun you ojare

    ReplyDelete
  4. He should have told them the truth. Now he has loans to repay. Chai, who fake life help.

    ReplyDelete
  5. Eeyah. It is good to be humble. God gave him a second chance when the Canada guy asked him if he was deported but his deceiving and arrogant nature made him loose a golden opportunity.

    ReplyDelete
  6. See as person take miss opportunity to Japa. God may I not miss my opportunity due to stupidness or fake life.

    ReplyDelete
  7. Sisi you be case oooooh. Stella why una wan rest this column?

    ReplyDelete
  8. Na to dey pray continually for wisdom on how to live this life sha

    ReplyDelete
  9. Canada no be Oshodi na, the man no fit carry am go that time when im come, na after e reach he fit arrange for am. But who even talk say dem wan help am sef? Make he dey bobo imself for Lagos, dem no need am for Canada

    ReplyDelete
  10. Stella abeg sisi blog no supposed end 31st March nah 🥺🥺😭😭😢😢

    ReplyDelete
  11. Stella please reconsider this column, it's always interesting full of lessons

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141