Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponis Corner - Fake Alert

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, March 27, 2023

Sisi Senaponis Corner - Fake Alert

LOL


Una doh o!
Stella-keke-nor-be-lambo! I hail o!

God abeg o!

One fine sister come follow me buy markeit, she say she jor collect POS mercheen for her business!

I say that one good o.

Na im my neighbour for market pass with her horseband. I see as eye dey wink wink!
Small time, sister say she dey come, horseband too miss for like 1hour!

Nehii,wia ya horseband?!

My neighbour say her husband say he wan go find new notes bring!

Horseband show,, money nor show. He dey rush rush wan carry him keke comot!

Na im that sister dey run come from distance with wig for ampit and POS for hand!

She dey shout make he nor go o! Make dem hollam!

Wetin hapun?!

She say he do her fake transfer!

Haba! Oga you sef! Aunty nor vex!

Wetin he follow you buy wey he nor pay and how much be the money?!
She say wetin she dey sell nor consine anybody, make he pay her!*sideeyes!*

My neighbour jump comot from inside shop, say she go slap the sister if she follow her husband talk anyhow!

The man begin raise voice too! Stand behind the wife!

Na im one aunty comot for crowd o, she say you this man, so he carry him bad character enter new year!

She say this man go follow her buy market, collect cash from her hand, say he go add am with wetin he wan pay her! Pakalam!

He go show her debit from his phone but she nor dey see credit!
You this man! Oya defend yourself! Na so he deny say he not know the lady!

Before we say Jeho...wife don slap the second lady!That one carry blow do her knock out!

Na bag of water we use wake her, i collect my money anor do charity reach that side!
Who send her fight?!

Na so the second lady say na achawo she be o! The first one say she too o! *eleeee!

Oya give us proof!

Na im the two achawo back themselves begin answer question, dey describe the biro cover plus the mumu thing he dey talk when he wan land!

The wife say make we nor wake her o!
She sidon for grand dey cry!

I say ngwa! People nor gather empathy like before o, country hard, everybody get one thing or the other for head!

You come say make dem no wake you! After dem waste energy settle kworeh for you! Alright o, nor stand up o! Like say na we do you!

7 comments:

  1. 😂😂😂😂
    First time here and I must say it's an interesting read.
    Stella - keke- no - Lambo I hail oooo

    ReplyDelete
  2. Eweee the wife na the mike tyson, defender of the defenseless 😂

    ReplyDelete
  3. Sisi you say...Biro cover plus mumu things he dey say when he wan land!!
    Choi,I dey hail you lol

    ReplyDelete
  4. Men are our problem. Zip up... mba.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141