Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Naija Na Wah

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, March 10, 2023

Sisi Senaponi's Corner - Naija Na Wah

Hilarious!




Stella-afro-la-georgia, hpw body?!

Lagos na wao!Naija i hail o!
Kingsley early morning music for their compound na 'dey never see me coming...jo..jo..jo Until things begin lorss for their compound!

Nobody tell am to begin play 'Mo ro arojinle, lori aye mi o!'.
The one wey dey block our ears with 'I'm unstoppable, e nor need battery to play!',Since wey fuel don corss, wey new notes palava join,na two times we don hep am push car from bustop reach house!

Now na 'only you can do, what no man can do,Jehovah!'

Pikin nor dey talk say make dem comot the fish, leave meat for lunch box again! Now na onions dey decorate food anyhow!

You go chop the onions dey imagine say na sushi sef!
*bible don kukuma say as a man thinketh, so he is plus it is!*

As na breeze come dey full inside caprisone, na to charter agbalumo gee the pikin, make he kukuma lick the vitamins by himself! E go drink orange, chop all the inside! Na wia carbohydrate and erm, protein dey be that! *sideeyes!*

If to say Nigerian dey like chop dem octopus, lizard, frog well well like oyinbo, Mschew! Which kain yeye shakara fish seller wan carry person do!

Imagine Titus pikin, small pikin wey dem born whish day?! wey never even grow bwess, corss pass okuko wey gather biabia!

Na make everybody carry canoe go catch the one wey dem fit catch for water!
And the ones wey mammy water catch, dem go tell BBC wetin dem see! *coconut head!*

Persin do birthday, na.Beans dem carry put for tray, fry better pepper put! We drink water sotehh, eye begin comot water!

We nor even see road ask if dem go share cake! Belle don discontabombulate! Atmospheric earthquake and Armageddon inside bus! Choi!

Person carry straw come give celebrant as contribution, one aunty first share straw round, another broda begin share pure water!

We think say minara go still show, na zobo wey don block dem bring again!
Block wey be say you must to knack am for wall or Carry stool to break am!

You go lick the ice block till the celebrant go mark another one next year. Mouth and Tongue nor go bother get sensation again!

I say aunty, abeg we offend you before?! She say na because weather too hot, dem give us cool-aid!

Rice come wear shoulder pad like person wey dey play rugby! like say nor be all of us go answer to God!
Turkey go pursue person for real life, e die finish, e still dey pursue person with price!
Person beg buka woman make he do transfer, the woman say she nor want wahala o!

As bros don lem like 4wraps of Garri and Egusi soup, he do transfer, mama nor see anything!
Bros wey gentle na na. na,dey beg to do transfer before hunger go kill am, don turn voltron! He say he don do am! And they debit am! Nor be fake transfer! Him eye don red, garri don dey work!
He ready to beat anybody wey put mouth! *Emefiololoooo!*

People wey dey drink ogogoro sef don reduce now, as nobody get time to dey find anybody wey lorss or dey inside gutter!

If you like kidnap yourself and ask for ransome, when the foodstuff you dey lem for the side finish, na you go carry yourself come back house! People go dey use nonsense play!
Energy nor dey! You chop one wrap of akpu comot from house, you know say na until you reach house for night to chop 3spoons of Beans.

So during the day, anybody wey greet you, na nod!
If you open mouth talk one sentence, na one spoon of rice don go be that!

Laughter nor dey make person young this period o! Na like 2wraps of garri to laugh for 1 full minute!

Anybody wey you know say no be money he wan give you! Abeg jor go learn sign language! Save the energy for election biko!

25 comments:

  1. Abeg! Make una no use laff kill me stella biko🤣🤣😂😅. But wait o! E don tay wey i see people dey fight. Buhari don show us say him no be any body mate. I swear the mata don thick. I no dey see ordinary goat and chicken dey waka anyhow like before again. I no know whether dem don thief all of dem finish. Na god go help us.

    ReplyDelete
  2. 😂🤣🤣🤣🤣🤣 Mehnnnnn, I laughed so hard...

    ReplyDelete
  3. OMG my chest o 🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  4. Hahaha! Abeg, which one be okuko wey carry bia bia again?

    ReplyDelete
  5. 😂😂😂😂 as I no see food chop cos of naira scarcity, I reduce the way I greet and gist. Everything now na sign language . I save my energy for trekking 😆😆

    ReplyDelete
  6. 😅😅🤣🤣🤣. @Sis you captured everything happening in this our country Nigeria at the moment. God no go shame us.

    ReplyDelete
  7. i don laugh belleful!shuo

    ReplyDelete
  8. This is so hilarious and true. Lady, you're funny....

    ReplyDelete
  9. Ohh Sisi sometimes I feel guilty for enjoying this much laughter for close to nothing.I just want to hack your grey matter 🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  10. Ah! Honestly, I didn't get what the write up is about hence I stopped half way
    I can't comprehend pidgin

    ReplyDelete
    Replies
    1. Oh o...I wish I had time to translate but it won't still be interesting in proper English...lol

      Delete
  11. This is funny 😀😁😄🤣😂

    ReplyDelete
  12. 🤣🤣 chai Sisi you no go kill me.
    Before all this naira scarecity,if you open people status wetin you go dey hear na "billionaire onye ji cash,chopping and spending the money" now nobody dey put am for status again 🤣 naija don show everybody shege.

    ReplyDelete
  13. See as you captured the state of the nation,e go better.

    ReplyDelete
  14. I still struggle to read this pidgin but this is hilarious. Stand-up comedy worthy.

    ReplyDelete
  15. Hahahahahah..........I dey vex before cos I never eat since morning but this Sisi make me laugh so tey cry commot for my eye.......... Josaria

    ReplyDelete
  16. Lmao!!! I don laugh Taya … make I go find Garri drink🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  17. Hahahaha this is the true summary of what is happening in Nigeria.

    ReplyDelete
  18. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣 na clown you be oo. Hunger dey mama me, fear no let me take small money from wetin I get buy anything. I use 900 buy 3k, na small small I go dey spend am for transportation to work till e finish..

    God save us from these tyrants that call themselves leaders.

    ReplyDelete
  19. So during the day, anybody wey greet you, na nod!
    If you open mouth talk one sentence, na one spoon of rice don go be that!

    Laughter nor dey make person young this period o! Na like 2wraps of garri to laugh for 1 full minute!

    Anybody wey you know say no be money he wan give you! Abeg jor go learn sign language! Save the energy for election biko!

    Sisi you be case. You're doing well. Hahaha

    ReplyDelete
  20. Me na only nodding I dey do because energy no dey to talk as money no dey for pockets

    ReplyDelete
  21. I don laugh tire here oh.. Sisi thanks for the comic relief. You succinctly captured the state of the nation as it is right now😀 😄

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141