Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Dem Say Fake Raincoat Full Naija

Advertisement

Wednesday, July 23, 2025

Pidgin Post - Dem Say Fake Raincoat Full Naija

 You don hear wetin dey go round? Dem say fake raincoat full Naija!....Meaning say person fit still get belle with the use of the raincoat or person fit still catch gonocacus......
I wonder why person go make fake of such important thing......
Anyway sha, the reason wey make me post am be say i want make una shine eyes, no be say person go get belle now una go deny am , we go come get many 'paskal' cases everywhere oh...



14 comments:

  1. na make everybody dey faithful to one person (your wife or husband). Husband and wife way no want get belle make una just dey careful make una no come dey shout we no dey ready lol.

    ReplyDelete
  2. Nti Adikwa 🙄🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  3. SDK say gonocacus 🤣
    Dem go get belle finish now, dem go come dey disturb you inside your inbox for hospital money, delivery money, etc. Dem go come our blog comment section dey disturb us with sob stories like say we follow dem 'release' when dem dey knack.

    ReplyDelete
  4. Eyoo, come and look at this...

    ReplyDelete
  5. Na to wear two or three at the same time naaa. No lele.

    ReplyDelete
    Replies
    1. LMAO 🤣🤣🤣
      No Feeling Again Nahh 🤣🤣

      Delete
  6. I no wan mention the name of the CD wey I dey suspect say na fake, cos that one too full everywhere. For my area, them even dey put am for display trays like say na sweets. Those days, you wont find CDs displayed casually on the counter, but nowadays, who care.......?




    NFCS does. Lol.

    ReplyDelete
  7. The raincoat pic sha 🤣🤣

    ReplyDelete
  8. But paskal no de like raincoat, bottom line…if you use fake, you and paskal same same

    ReplyDelete
  9. I think men don't deny pregnancy like before. Unless he's married. But single men accept pregnancy these day even if they don't wanna marry the woman.

    © TEEJAY

    ReplyDelete
  10. Make everybody dey their lane 😂

    ReplyDelete
  11. How person go take know the original and fake now... asking for a sister

    ReplyDelete
  12. Hmmmm, no be small wahala o, na do for those wey be knackersons, Una don hear abi? .

    ReplyDelete
  13. Wahala be like fake rain coat

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141