Stella Dimoko Korkus.com: Singer Tuface' Brother Charles Slammed For Calling Out His Famous Brother And New Wife On SM

Advertisement

Monday, July 07, 2025

Singer Tuface' Brother Charles Slammed For Calling Out His Famous Brother And New Wife On SM

This is a very Interesting Must read piece ..........



''Dear 2Face Brother,
Good afternoon brother. How far? Na Charles be your name abi? I see you dey post for social media about your brother. You say you dey talk to am. I no understand. Social media na una tribe or language or na there 2Face dey stay?
Okay, you no fit call his phone or find way reach am. The best thing na for you to run your brother down for social media. To what purpose?

Your brother na 50 years or so. Which part of 50 years be small boy? Wetin give you right to dey talk about 50 years old ancestor and his life’s choices, and for social media?

Guy, which work you dey do? What do you do? You get handwork? You go school? I like know. E get why
You say 2Face comot from frypan (Annie) to furnace (Natasha). E done occur to you say maybe your brother like heat? How is that your business? Ever heard of “volenti non fit injuria” meaning wetin person open eye enter, he no fit complain later? Why na you dey complain!

I see your mama video wey she say Natasha do juju, begin talk about jewelry wey Natasha wear, say na karofi/ogume/juju. Okay
Wetin me dey wonder na why 50 years old man, whether na una blood or not, why his life’s choices na una primal business.

Normally, if person brother marry bad wife, his mama and brothers, na prayer them dey pray for am, as they live their own lives. Why 2Face own case dey be like say na 9 years pikin wey never get power to make own choices una dey talk about?

So what if 2Face say na so so yeye woman he dey like? (since una no like Annie or Pero or now Natasha) He beg una food? Na una dey help am train him pikin? He pack enter una house, begin chop una food? How is his own affecting una own?
So all the women wey 2Face done choose, to una, one na frypan, the other na furnace?

My brothers done marry. I no get right to judge their wives. I no dey judge their wives. I senior all their wives. I dey tiptoe and show ultimate respect to them, because my brothers na their own men, and free to make their choices. If anyone no like me, I go phone my brother when he dey office. If she spoil me give my brother, na shame to my brother, as my brother suppose know me and wetin I fit do. So if him wife fit spoil me for am, na me and am get business on a private tip.

And I fit talk like so because, as much as my brothers all dey do well, I dey try feed myself. Their salary no be my business. Even when I no get for Lagos dey hustle that year, ask my brothers how many times I pick phone to ask for something. When them gimme, I thank them well. But their money no be my money. Their wife no be my business. I go love any woman them choose, or at the least, mind my business.

Why I go go social

media go run my brother or his woman down? I dey craze? I chop lion shit? Wetin gimme that right? I no get sense?
First wife Annie, una enter her
I dey Lagos for Pero era. Na so una attack Pero, but social media no dey then.
Now na Natasha.
WETIN!!!

If na say 2Face dey smoke. Na una house and as small boy he begin smoke. He never marry Annie wey he sing say “Okoli, pass me the kpoli’. If na drink, I never see 2Face without cup and hot drink, even before he marry Annie officially. Una brother, like most superstars dey “dirty him eye” constantly. No be Natasha house he begin do am. So wetin Natasha do?

The Natasha wey you say dey carry 2Baba go where he no suppose go, NA YOU GO TELL 2FACE WHERE HE SUPPOSE GO??? Na small pikin? You know whether na there the food dey?

Make I reveal one small secret, if una no know. Natasha, as she dey there, unto being Igbinedion grand pikin, get permanent room for Transcorp Hilton. She no need 2Face one naira. 2Face career done dey slide, as is expected. Na over 30 years of doing this. Rema them never reach 25. Na small boys game be this. The one benefit Natasha get from 2Face na say she be like who love public attention and 2Face dey bring the National relevance. If not, ma 2Baba done see where rest, no be Natasha. God done do her own.

If na the smoking amd things matter, e no get wetin Natasha teach 2Face. Na una house he start igbo wey be normal GATEWAY to many other things
So WTF are you on about, Dear Mr Charles Idibia? What is Natasha’s crime?
“She thief her man phone when he dey sleep” So? Na the first jealous woman? “She clone him phone”. How you take know?” 
“She post about divorcing his…” wee you keep kwayet???

If my babe thief my phone, delete all my female friends contact, or even break the phone, that is me and her business. Maybe I like the toxic way she is loving me. Only thing my brothers go tell me na “pupuru” meaning “small small,” for Uvwie language. No be them go tell me how to run my relationship, unless e done reach physical abuse say she dey beat me to hospital level (because I still fit be sadomasochist wey dey like make my woman choke me or beat me. Every man with wetin dey raise their manhood)

So weyin come be una business with 50 years old man wey happen to be una brother?
E come dey clear to me say e get wetin una dey want from 2Face wey he no dey give una and una dey blame his women. Innocent is innocent in una eye. He no guilty. Na his wives abi women

See, we know how hard e be for breadwinner to marry. Burna Boy sef go face same problem, if family no plan ahead and do everything contractually on paper on who does and geys what, when and how. If he marry, the wife go likely scatter wetin dey go so well today. Na so wife dey do. Ask PSquare.
Bible say

“ A man shall leave his family (father and mother) and cling to his wife”.
Bible no say wife go leave family cling to her husband.
You think say Bible no wise?

My brother wife brother get right for my brother house pass me, whether my brother na sole provider or not. If my mama go my brothers house, she go waka small small, because na another woman territory be that. But the wife own mama can enter pot as she like, whether na my brother get the money wey them
take buy the soup or not. My mama go ask permission but the womann mama go enter the pot. Na so life be. Na i law wey no learn this thing dey be enemy.
She i Them no teach una this thing for Benue state or FESTAC?

As I dey talk, this thing dey look more and more like say na unto breadwinner things. Una dey lose control over the goose that lays the golden egg.
But e be like yansh done dey pain the goose for the egg e dey lay. E be like una go try lay una own egg. You guys have had a good run with Nigeria’s then biggest artiste. You have traveled the world with him.

Una for enter America with am and no come back, begin hustle years ago. Una for start una own business totally independent from him. If he no send money to una mama, una for done position una selves enough to send una mama. If any of me or my brothers wife say make he no give my mama money, the rest go pick up the slack. The money fit no many like before, but at all at all na weensh.
Charles Idibia, YOU FUCK UP. You go dey tell them Daddy Freeze and other pressmen secrets of your brother? Make Daddy Freeze go beat Natasha? When you come press and social

media to run your own blood brother down, like say na fool, wetin you gain? Make we gather go give your brother sense wey he no collect from your papa penis and mama womb as DNA? Na we go give your 50 years brother sense?
So why hou come
dey involve us?

Mumu!

Na brothers like una go follow 2Face children drag property leave them
for poverty, if something something do 2Face. Una go pass Wigwe family. Na the very useless extended family feeling of ENTITLEMENT you done display so.
Guy! Charles, you no get orientation!!! Men!!! I like pronounce make
men run enter you. Run your own blood down in public? This guy no get better male friends? what type of obote behavior is this?
And, make I tell you. If Natasha, as a Benin girl, as a politician, if she decide to table your matter, them 
Kabaka go go carry you from anywhere you dey, come Urokpota Hall for Benin for correct jewish mending. na police go stand guard make the beating dey uninterrupted.

My point?

Let 2Face live his imperfect life, make his plethora of mistakes, and let God be merciful
im his judgement of a flawed creation of his.
The life of musicians have always been fraught with commotion chaos and controversies. Many opine that Lucifer, as the first musician, sees all musicians as his kith and kin and so makes their lives, from Marvin Gay, to Amy Winehouse to Witney Houston, through Prince and Michael
Jackson amd our Fela and Majek Fashek, as tumultuous as his own fall
from heaven.

If 2Face is not living the ideal life, in your opinion, Mr Charles, go on your knees and pray, or reach out to Natasha and have a better relationship than you guys have with Annie and see how you can be positive influence and how you can help. if indeed help is needed.

Dogging your own blood and his woman on social media is asinine.
NB. 2Baba, I hear, swears his apology was not Natasha’s idea. He said he felt a certain type of way when Nedu mentioned her name, and he still went on with what he was saying. The person swears Natasha worships the ground 2Face walks on. Say e be like na 2Baba do jazz for her.
I have been privileged to listen, to some new sounds by 2Baba. When you hear CELEBRATE, BALLING, and LOCATION, you will know that 2Baba’s music gift is follow come. 2Face turned back the years and incorporated the … make I no too talk. I hope they release this somg and LOCATION soonest, Sorry, you cannot find it anywhere for now. But this is how I remember the lyrics from it being played to me.

Celebrate by 2Baba
Verse 2
Everybody get his time to shine
Overtaking is not a crime
Why you dey pack my matter for your chest iye
We suppose discuss this matter
But you change am to banter
You leave your problem focus for my case iye!
chorus
celebrate Iye, Celebrate iye

Verse 1.
“E get one thing I want communicate iye!
Na the same thing we dey appreciate iye! (happiness happiness)
If person do well na to congratulate iye
No time for hating na to celebrate iye
chorus
E get one thing I want communicate iye
Envy and Jealousy dey strangulate iye
Anything you get you must appreciate iye!!
If person do well, no dey player hate iye!!
Player hate iye
Player hate iye
Bad belle doings na to player hate iye..

Verse 3
Body dey bite you, e dey bite me too
I no go let you put leg for my shoe
If you go flame me fire
Come make me dey para
There is a limit to what I tolerate iye!!''

BY Enalysis Ofugara on Facebook

33 comments:

  1. Abeg people that read it to the end should please summarise it for me🙏

    ReplyDelete
    Replies
    1. Hanty, na my 3 brain cells wey I kukuma dey manage you think say I go waste to read that project work? Abeg o

      Delete
    2. Pure Nwannem I follow you dey wait for the summary abeg perching here🙄
      DOGGY you be case Aswear 🤣🤣🤣

      Delete
    3. Huncle Dog abeg help me out na🤣🤣

      Glory nwannm'm make we day wait together 🤣🤣

      Delete
    4. i dey wait for summary too, so long a letter

      Delete
  2. I read the first three lines , then scrolled down to check out the author, as I kept scrolling through the novel, I was thinking in my mind "na uncle Reuben Abati write this thing".
    Then I got to the end and got disappointed.p

    ReplyDelete
  3. If I read all this make I bend

    ReplyDelete
    Replies
    1. Me too. If I read am make I baff with my pant.

      Delete
    2. Chimoo 😳 abeg abeg abeg 🤣🤣🤣🤣
      Medu pant no dey dry now oo
      As rainy season dey 🤣🤣🤣

      Delete
  4. This person get time. What!
    I couldn't fit.

    ReplyDelete
  5. Ogini di?
    Na person matter human being forget him own problem carry for head like this?
    Like? 🥹
    O shock me o

    ReplyDelete
    Replies
    1. Godswill isi gini? explain well biko🙄

      Delete
  6. Too long.someone summarise please.

    ReplyDelete
  7. What a wawu!!!

    ReplyDelete
  8. I read all, the guy is pained, sounded like someone that never had peace due to his family interference and now what to live for himself.
    All the best.

    ReplyDelete
    Replies
    1. You read ALL of that? Abeg go make dem check your eyes sharply. Before you go come get epilepsy for eyes.

      Delete
  9. Wetin be this 🤦🏼🤦🏼

    ReplyDelete
  10. True true, entitled family members wey go follow children drag property of breadwinner in the future. E clear.

    ReplyDelete
  11. I couldn't finish reading it...it's too long abeg...he come use pidgin write am 🤦🤦

    ReplyDelete
    Replies
    1. Person wey dey call Charles out, may Tubaba happen for una family

      Delete
  12. Summary is Charles should stop poke nossing into 2babas relationship. Whether na jazz or anything it is none of his business. If he (Charles) is so concerned he should talk directly to his brother or take it in prayer to God. The writer is also accusing Charles etal of just having entitlement mentality to his brothers assets (if any). They have had issues with all the women Tuface has had so the common denominator is them not the women.

    ReplyDelete
  13. This writer is accusing Charles of the same thing he is doing. Oga don't you know Charles inbox?

    ReplyDelete
  14. I think na entitlement mentality dey worry 2face family. I think also whenever 2face marries a wife they don't get enough of the freebies & hence the tantrums.
    Infact the family is greedy & mumu dey worry dey
    The Most Complex B

    ReplyDelete
  15. Wahala pro max😄

    ReplyDelete
  16. Where our chatgpt girl, make she come tell ua wetin the post dey all about. Her food don land.

    ReplyDelete
  17. I don’t like bad pidgin

    ReplyDelete
  18. Correct essay. Why the Charles no stand up for Annie to defend her interest then? Or tell Tubaba to go back to Annie?

    ReplyDelete
  19. Please, the write of this 'dogon turenchi' on TuFace and his family issues, LUCIFER IS NOT THE FIRST MUSICIAN in heaven ANYWHERE in the Bible ❗

    Men should learn to be responsible and stop jumping from one woman to another having children everywhere.

    Families protect one another but should also respect their siblings' decisions.

    If the Idibia family had respected boundaries in TuFace's marriage, he would not have left his wife Annie for this current woman. He gon' learn the hard way now!

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141