Him name Stefon Diggs Cardi share for interview with CBS morning say he make her feel safe after that thing wey she been dey with mess up e coconut head.....wetin be that him name sef?Mscheeeew!
Stefon Na NFL star and e face too sweet abeg and tattoo just full all him body..if you see him belle you go wet like who rain beat.
Dem two begin gbensh as 2024 wan end and na belle be the result now...
Cardi been get tiree pikins with the yeye ex... She say she never tell her people for house cos body dey do her somehow but she no need tell them now cos the news dey everywhere...people full for stefon page for instagram dey pet am, dey hail am..............
I go return there go read comments cos the comment dem sweet and not toxic like the ones Naija people dey post for their celebs page.....

Just gugud it!! The Stefon guy di okay....Cardi B that was very fast!! Baby Number 4....Meanwhile her ex don release Album about moving on from her and his late brother....Oyibo celeb life ehn!!
ReplyDeleteStefon Diggs na my dawg but e jonz anyways I pray he doesn't learn hard way.....
ReplyDeleteCode 107 knack but no give belle but this banny go stil knack offset
Later..... ( cases like this)
She got three kids for offset ,her ex....
Offset 3
Stefon 1
Off and on you gerrrrriittt
Good funking luck to them
Wow,so soon?🤔
ReplyDeleteGood for them
ReplyDeleteGood luck to them
ReplyDeleteSleeping at the court gave her away....lol!
ReplyDeleteCongratulations to her
ReplyDeleteStefan sighs and offsets na the same six and half a dozen. This whole charade is not to be applauded at all
ReplyDeleteNa wa
ReplyDelete