Stella Dimoko Korkus.com: Actress Lizzy Gold And The 'Silent Troublemaker'

Advertisement

Monday, October 26, 2026

Actress Lizzy Gold And The 'Silent Troublemaker'

My people, gist don land oh!

Actress Lizzy Gold don hold one actor like say na work contract mixed with love contract and una sabi wetin ? The guy dey expect baby number four from that second woman, but na only Lizzy him dey see like torchlight wey dey catch thief for night.


This our “Silent Troublemaker” wey dey form coded for camera, na full loverboy behind the scenes and na Lizzy him wan dey play with, dey gist with, dey breathe with… well, at least for now.

The Amebos wey carry this matter come say the love don hold am like malaria, and na Lizzy be the medicine wey dey calm the fever.
If you see the way him dey follow her up and down ehn, you go know say this one no be ordinary crush , na love wey tie wrapper.
Make una siddon, because this movie go end well and e go sweet some and pepper some…..Me na fence i siddon dey look oh....

7 comments:

  1. Oh God! Let this not be true, and if it must be, let it not be who I'm thinking. These 'children' go too laugh and drag their papa here 🤣🤣

    But this Lizzy Gold na fine woman. At a point, she begin dey enter my eye. I come begin watch her dancing videos. These women, once they start getting older, e get this beauty wey they begin to exude. *Clears throat*


    ©️ TEEJAY

    ReplyDelete
  2. TeeJay the polygamist, come and see your mentor oh
    I guess women no Dey finish, so YUL carry Dey go.
    Proud polygamist, congratulations to YUL and Judy on the entrance of their other wife

    ReplyDelete
  3. Me self na fence i siddon o 😁
    Nothing concern me

    ReplyDelete
  4. So Judy "snatched" Yul to become a babymama. Abeg shift make I laugh 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete
  5. Oloololo, so akpa akpu udumoyoyor is pregnant again 😂😂, normally toto no dey pain second wives.

    ReplyDelete
  6. Tales of lust and debauchery

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141