Stella Dimoko Korkus.com: Sunday In House Gists...

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Sunday, January 31, 2016

Sunday In House Gists...

Saturday in house gists was so funny,i laughed and laughed...Perhaps tdays will be funnier......enjoy!





GIST 8
SPEAKING IN TONGUES
Hi, gud day to you Madam Stella and my fellow BV's.  I wan share my
Tori with una, una wey no understand pigin make una no vex, this Tori
happen between me and my colleagues o, we be don dey go church every
Tuesday and he get 1 of us wey dey speak in tongue, na so wey go Dis
Tuesday o I notice say as we dey pray my 3rd colleague dey laff, I dey
ask myself wetin do her.

 I manage close before I run go meet her say wetin happen, na him she bust laff say if I sabi wetin breeze blow chicken yansh wey she see, I come beg her make I hear, na so she tell me say I no go believe say all Dis days wey we dey think say our colleague dey speak in tongue say na her Edo language she dey speak,
na so I shout, we cum plan say we self go dey speak in tongue by force
, as the next Tuesday come wey we gather go church na so I hear my
colleague dey use ilaje language take dey praise God,as I hear am na
so I bust laff wey I no fit hide o.  Thank you and have an awesome
week.


............................................................................................................



GIST 9GOST RACE

Stella, this na my own gist. Happened around late secondary school.
We had this family friend that used to rear goats. One Sunday after church, my papa say make we go visit the family as them just born new pikin, so from church we drive go their house straight. 

Now, we don dey hear say one of the goats dey pursue person oh, say if e catch you, e go use him head and horns jam jam you. The goats reach like five but we no know which one dey pursue person.

So during the visit na, my mumsi say she wan go collect something wey she forget for our motor, she come choose me out of all of the children say make I escort her go because of the goat, as per say me na guy, plus I don tall, get broad chest, goatee and deep voice finish, me sef come dey laugh her say na because of goat she dey fear like that? 

I come follow her go the motor. As we dey go, we scope the compound wella oh, we no see one single goat sef, I com say maybe them lock them for cage for backyard.
On our way back from the motor, na so she dey waka fast fast for my front, me and my swag just dey waka for her back dey form cool fresh dude. Lo and behold, we just hear one kain funny sound from back, I no know when my head turn sef. See one large he-goat just dey race towards us from nowhere! My heart just beat one heavy beat for my chest, GBAAAM! Then to worsen matters, mumsi come scream “Jesuuusss!!!” com pick race. 

Choi, the scream plus my mumsi race plus the sight of the goat just freeze my blood! Me wey plan say if the goat come, I go just kick one leg for air, shout “shaaaaaa!” I just confuse. I no believe say I go ever run from goat for this my life, but that day I no know when I follow pick race. Me and mumsi begin race dey go the front door. Meanwhile my siblings hear when my mama scream, they go the window dey watch us dey shout “Run, run, it’s coming, it’s coming!” By that time all the formings don clear from my body oh, na survival just dey my mind.

I dey run dey target mumsi say make I overtake her so that na she go dey my back near the goat, na that time I code say my mumsi sabi run sha. Me and mumsi race till we come reach the front door the same time, na there kasala burst. Who go enter first na? Me and mumsi squeeze for the door, none of us fit pass. She use her body dey press me dey drag my hand so she go enter first, me sef dey drag her blouse so I go enter first, till finally two of us com fall enter the parlour, my own leg nak stool join. Meanwhile the goat don stop to pursue us since oh, we no know. I stand up sharperly, run enter the dining, she stand up too run enter the bedroom side. 

Chai. Na that time I com calm down dey try to compose myself though my body dey shake like say I get fever. I com dey ask myself say me, I run from that goat?? Everybody burst laugh for our head. Them com yab me say me wey suppose protect my mother, na me go drag door with her. Shame wan kill me that day.
On the way back home, na so our last born go just stay laugh one kain wicked laugh, once she laugh everybody go come scatter laugh too. Except me. I been wan conk her head but I no fit, lol.

But guess who had the laugh? I did, when that family specially sent me my share of the goat meat when they killed the mumu goat some months later! And till tomorrow, if I see goat near me I must kick my leg towards am so e go run; I can’t help it, just trying to reboost my self-confidence... :.


.............................................................................................................



GIST 10
CONFUSION AT THE CHOIR


I remember during my teen days in the church,i was in the teens choir..so on this particular night,we were to minister at our headquarters coz it was a vigil...i was to take the lead in the song and we were rehearsing..the problem began when our coordinator started complaining that he couldnt hear my words clearly when singing,na so the thing lead to argument oo..

na so he cum vex say mk I no take the lead again...at last sha we cum change the song buh my mood had changed coz of the way I was shouted at,na so the mood spread like wildfire..we rehearsed the new song which had 3 lead vocal part so I was to take the 2nd...na so we pack oursef go the church ooo

When it was time for us to sing na as if our brain format when we climb altar..as the instrumentals dey go on na so we dey move with am...people first of all think say na mic no work..so the engineer cum test the mic ,he see say the tin dey work ,so by that time church members too don get....me just sing one kain solo wey me sef no know..na him one sista wey dey for front sleep go,she wake up and we still dey there na so she hiss and carry go with her sleep...
Shame no make us cum down,at last sha we were ushered down,na so people cum dey shake head for us....it was really embarrassing



.............................................................................................................



GIST 11
'SORTING'

Me and my friend, let's call her X went to check our result on this
fateful day. To pass the course you have to bribe the lecturer- sort.

" this course is a sure A", she said with so much confidence, me I
kept quiet and was also claiming it too, but seriously D go make me
dance shoki, cos I had no money to take care of myself, talk more of
giving to a lecturer. X continued with so much certainty that if she
did not make A no body will, this was a girl I was academically better
than.

 When we got to the notice board, I couldn't believe what I saw,
I got a B.  Now we were on our way back, X was so quiet and me don't
know what to say to her.  " dis our course rep is a wizard" she said
breaking the silence. She repeated it again and again. Then she
narrated how she gave the guy all her allowance money only for it to
result to an E. 

Whenever I remember the incidence na so smile I go dey smile.
NB: not all gist will make you laugh, but you can always relate to it.

.............................................................................................................


GIST 12
SETTLEMENT FOR NOTHING

Tuale mama
Everybody I hail ooo
I remember one friday like dat(last year) Mumsy ask us to dress up for
vigil and I don get one birthday to attend.I had to lie to Mum that I
ain't feeling ok.
After giving me some drugs she asked if I can stay @ home and manage
till the next day,I replied yes.she say make I stay house in short.
As I see say Mum and my siblings don go naso I run enter house say
make I change into something nice,Naso door jam...
I no fit open door again

1)My phones dey sitting room
2)I neva chop
After much self pity and regret I slept off.
The next morning na my junior brother come open the door.As this guy
man see me,naso he just dey shake head dey laugh...I con ask him wetin
he observe.He said I went to a party and he will tell mummy
After much plea he said settlement or he will report,and this small
rat stubborn.
I pay for wetin I no do because my mummy nor Suppose hear.
Naso I suffer myself on top nonsense ooo.





70 comments:

  1. Replies
    1. I vote that ghost story from yesterday Gist... Can't remember gist what it is... Gist 3 or so

      Delete
    2. I vote Gist 9.. I laughed ehn! Lol! Guy u no try oh! Dey follow ur mama drag door

      Delete
    3. Lol,gist 9 cracked me up ah swear...

      Delete
  2. Replies
    1. The goat gist got me tearing up. Well written!

      Delete
    2. All dry. I still maintain gist 3, the ghost story.

      Delete
  3. Gist 9 all the way, never laughed this hard on any IHG since the breastmilk and corn....gist 9 got my vote

    ReplyDelete
  4. All dis gists are dry.
    Madam Stella,it's high time u scraped dis IHG.
    I don't find it funny at all.

    ReplyDelete
  5. Dry gists today. I'd give it to gist 3 of yesterday.

    ReplyDelete
  6. Hahahahhaha @ the goat gist.
    Superb delivery.

    ReplyDelete
  7. Biko I vote gist 9... I laugh sotey my sis come dey ask me wetin happen

    Yesterday's gist 3 try sha but my vote is for gist 9

    ReplyDelete
    Replies
    1. Gist 9. Haven't laughed this hard for any gist In a while

      Delete
    2. Gist 9. Haven't laughed this hard for any gist In a while

      Delete
    3. Gist 9... you finished me I swear

      Delete
  8. Gist9 killed me... + u had fans cheering on sef..hahaahahahahhaahha

    ReplyDelete
  9. Gist 9,the goat race,has my vote

    ReplyDelete
  10. Gist 10....hahahahahahahahahahaha!
    Very funny!
    Una for pray before going up to sing na? Devil just come put sand for una midst...lol.

    ReplyDelete
  11. Gist 10 and the Last one, please what's that. Cocoz my vote goes to the nurses that ran away cos they thought it was a ghost, don't know the number.

    ReplyDelete
  12. Gist 9!!Too funny

    ReplyDelete
  13. Gist 9..... Laugh don die me here lmao
    The part about getting back your confidence Na die

    ReplyDelete
  14. Gist 3 of yesterday won my vote jaree cus 2day gists 2 dry

    ReplyDelete
  15. Gist 9 for me. I don dey laugh since

    ReplyDelete
  16. Gist 9 oooo!!!! Mehn, animals can make u embarrass yourself. Dog don chase u b4? Kai, all decorum go loss, hahahahhahahaha.

    ReplyDelete
  17. I cancel yest vote abeg na gist 9 sure pass

    ReplyDelete
  18. Gist 9. Never laughed thus hard at a gist.

    ReplyDelete
  19. I vote for gist 9

    ReplyDelete
  20. Gist 3 I laughed, but gist 9 I laughed and cried until every one at home rushed to my side asking if I was ok.
    please count my vote,I vote gist 9.

    @JustGlamour

    ReplyDelete
  21. Gist 3 of yesterday has my vote.

    ReplyDelete
  22. Gist 9 all d way.Laughed really hard

    ReplyDelete
  23. Gist 3
    Ghost gist made me laff gannn

    ReplyDelete
  24. Goat o gist 9. Still laughing

    ReplyDelete
  25. Gist 9 all the way

    ReplyDelete
  26. Wow! I laughed really hard! Chaai! Gist 9 is something else.

    ReplyDelete
  27. I vote for Gist 9...i laughed so hard

    ReplyDelete
  28. Gist 3 and 9....there must be draw this time around

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141