Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Dem Say 'Sherlock Holmes' Video Don Ready

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Saturday, October 31, 2020

Pidgin Post - Dem Say 'Sherlock Holmes' Video Don Ready

 Dem don summon the company wey suppose get the recordings of wetin happen on October 20th wey Naija army Kpai plenty people for the place wey dem dey call Lekki tollgate....





The company show face for the panel on Friday,come yarn say dem get small recording of wetin happen on that day and dem ready to tender am ....


I come dey think say maybe na the tape wey that detective wey wear brown outfit discover the day he go with other important peoples go check the extent of destroy wey destroy for the tollgate....

My waffy forefathers sense dey tell me say 'Doctor' fit don touch the tape sef wey Sherlock fash holmes find.

My people nah to cross lap and fingers dey wait to see whether the thing wey dem wan release go make am enter netlinks....abi how dem dey call am again?

12 comments:

  1. Hehehehe😂😂😂😂😂 we dey wait oh

    ReplyDelete
    Replies
    1. How come they didn't wait for their so-called video footage before the varying statements put forth by the State Governor.

      Putting the cart before the horse. 🤦‍♀️🤦‍♀️🤦‍♀️

      Delete
  2. Na wah... I dey wait to see this movie. So many actors dey Nigeria. The most recent one na that Kogi Commisioner for Health wey dey shed crocodile smile abi tears😏

    ReplyDelete
  3. We dey wait for the season film

    ReplyDelete
  4. I no get anything to add. Your pidgin na die.

    Hahaha.

    ReplyDelete
  5. Chai Stella you funny die!
    😆 🤣
    Make we dey look dem

    ReplyDelete
  6. SDK u be correct waffarian 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141