Stella Dimoko Korkus.com: Pidgin Post - Prophet Drive Him Wife Comot Marry Choir Mistress...

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Wednesday, June 30, 2021

Pidgin Post - Prophet Drive Him Wife Comot Marry Choir Mistress...

Wahala be like Bicycle ooooh...









 
PROPHET DRIVE WIFE AND MARRY CHOIR MISTRESS.


Na prophet evidence chikason wey be fineboy with plenty swags wey be Senior pastor and Founder of Gracehill Christian center for near winners church for okuokoko Naim convert his former choir mistress and doking mate wey her name na Helen to his second wife and chase his first wife wey her name na Praise chikason wey don born three beautiful daughters for am.



Evidence chikason and Helen wey be former choir mistress don dey doke each other for a very long time but his first wife no believe because she trust her husband well well so people no quick code even though both of them dey always dey together. Na when both of them con get serious accident when then dey return from one of their numerous love trips and Prophet Evidence chikason Prado jeep damage beyond repairs Naim people con dey code say na preeq and kpekus relationship dey exist between this two people.

Wahala start between chikason and his 1st wife Praise Chikason after she born their third daughter so the swaggerlicious prophet con dey feel bad say na soso omote his first wife dey born so who go come takeover the church when time reach? Na that time prophet begin give his first wife steady problem and accuse her of wanting to kill him until he finally go pay choir mistress wey be his sidechic dowry and chase out the first wife.

As if that one no reach, the prophet don establish a branch of the church for Ughelli and make the new mummy GO Pastor of that branch. As we dey talk now, new mummy GO don dey see vision, perform miracles and even sell anointing water for her own branch of the company oh sorry church.

Now abeg I like to ask my "touch not my anointed" followers....... Na God still call this Prophetess Helen aka mummy GO abi na preeq call her? Because I no understand wither anything like SEXUALLY TRANSMITTED ANOINTING dey exist oh.





24 comments:

  1. Trouble inside church yard. Many fake men of God, but there are genuine ones. Unfortunately, the bad eggs are bringing the revered vocation to bad light.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Too many fakers but God would shift the wheat from the chaff, the Lord would build his church and the gate of shall wouldn't prevail.

      Delete
    2. Wonderment even in the house of God 😳😳

      Delete
  2. Well, if you in your right mind and marry a man name Evidence then don't be alarmed if you end up in court with him.

    How you even make love to someone called Evidence🀣🀣🀣

    ReplyDelete
    Replies
    1. πŸ˜‚πŸ˜‚

      How person go born pikin name am Evidence? Suwah!

      Delete
    2. πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚I like your humor

      Delete
  3. Matthew 7:…22Many will say to Me on that day, ‘Lord, Lord, did we not prophesy in Your name,
    and in Your name drive out demons and perform many miracles?’ 23 Then I will tell them plainly,
    ‘I never knew you; depart from Me, you workers of iniquity!’

    ReplyDelete
  4. Marine power, Marine Vision, No solution after the Vision. Nonsense and ingredients

    ReplyDelete
  5. Wahala bi like end time prophet.

    ReplyDelete
  6. Wahala!!! E no fit finish for this kontiri

    ReplyDelete
  7. Apt, na company not Church, painful TRUTH.

    ReplyDelete
  8. This one na really sexually transmitted anointing ohπŸ˜‚πŸ˜‚πŸ€£

    ReplyDelete
  9. The foolish people are those who go to the church

    ReplyDelete
  10. BITCHandSLUT.com30 June 2021 at 14:28

    I just dey shake my head for hear oh.
    I read one wen be sey the wife born 3 daughters naim husband man vex sey wifey dey born only girls.

    E con go give side chic belle, side chic con born twin girls for am.

    ReplyDelete
    Replies
    1. E choke πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

      Delete
    2. Kwakwakwa idiot release x chromosome for him wife body come dey blame her, side chick sef shoke am with twin girls.
      The husband must be a fool to think that women are responsible for the sex of a child

      Delete
  11. And people still dey go the church

    ReplyDelete
  12. This wife versus side chick drama is everywhere oh, parents take time to train and empower your children especially females so that nobody can mess them up in future.

    ReplyDelete
    Replies
    1. Parents should train their male children to respect women and respect the sanctity of marriage. The thing is most parents don't exhibit better, so how can the children pick up these values? It not about do what I say. Children can feel the air between their parents; they can sense when there is tension and when there is love.

      Delete
  13. Hahahahahaha this pigin sweet me. Me self wet dey back am too no sabi this one.

    Mummy GO so na uggelli the branch dey. Those people dey fly for afternoon.. So nothing bad. Na all of them be the same. Make she dey give them miracle waters.

    Na victims I go pity

    ReplyDelete
  14. Church Agbasa
    Let's share the grace

    ReplyDelete
  15. Dis pastor church dey close to my house o,,,na wa o

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141