Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Stolen Paent

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, April 15, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Stolen Paent

 Sisi pf life!




I greet o my fellow yardflix pipu dem dem!



Stellathespartan....i hail o!


Una remember that crase SIL and her daughter? Ngwa, na im my ears go carry update for wetin dey shele for the house e!


My customer husband begin get small small issues for work so him and wife begin split house bills. Wife come notice say food stuff and provisions dey quick finish for house. Wetin dey occur?


Na so wife begin do inventory on Saturdays when husband begin complain say feeding money don too corss monthly o! Say make wife go review how she dey spend money. Wife carry stool begin take inventory, do timetable for food to make sure say food reach until the next salary.


Gubernatorial candidate -Senator (Madam) Debby, her sister in law pikin wey dey follow dem live for house nor dey help do anything inside house o, wife no fit talk since dem dey mock am on top say she never born Pikin! * dis life no balance at all!*


One day for office, na so wife begin feel light headed. She go office hospital, the doctor say make she go house rest for like 3 days say be like she don carry belle o! Say dem go mail her the test results.


Choi! Na so wife drive come house with the likely goodnews say make she come rest o...
Na so she see Debby wey pack Ghana-must-go!


Where you dey go inside this hot sun? Debby ignore Wife as she dey wait okada for Estate gate. I dey my shop dey look the drama from afar!


Na so wife park her car, come down say make she see wetin dey happen well. Hope say no be person hypnotize Debby so? Na so wife leg hit the Ghana-must-go, something wey strong dey inside!
She ask Debby wetin dey inside the bag? Where she dey go? Who dey house? Debbie still dey snub wife publicly! She dey press phone dey try stop okada.


People don begin look the scenario. Na so wife open the Ghana must go, she see foodstuffs and provisions inside the bag.


That one no even be the only issue o, as wife carry the bag put inside her car booth reach house, call her husband to report as Debby no gree enter car follow her come house!


Wife begin comot the items put back inside pantry. Na there she see some thing wey dem wrap inside black nylon under the Bag.

As wife open am, Stella, wetin she see go shock you!


Na the pant wey wife wear on the last day of her most recent period. Wey she dey think say dey inside her undies laundry pouch. As she get plenty black net panties, she no even notice say anything miss for drawer! * Blood of Jesus eh*

No comments:

Post a Comment

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141