Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Wife Versus Sister In Law

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, May 20, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Wife Versus Sister In Law

 Na wah.....





Hellerrr! Gentle pipu of this wonderful world!


Stellamamalicious...I hail O!

Choi...if una see the kain Jellof wah lem for that my customer wey born boy house e! Jellof wey follow come from Palace de Buckingham! Odi Jellof wey puff Cuban! That one nor be anybody mate Biko!

We still dey follow my customer rejoice as devil don shame her sister in-law and her batallion...*sideeyes*

As we dey rejoice, Na so husband begin fall sick!

Wetin happen? Wetin happen?

Just after God don bless dem with healthy,male pikin, shame the devil!
Na small, small, husband begin dry up, begin loose weight, appetite no dey, nothing!

He no wan gree go hospital, na the wife beg am make he try go, so dey no go self-medicate for house...Na there results come back say husband get organ failure, dem go need transplant, donor, travel money, surgery money ...otherwise he no go see that Christmas!

Stella, na so the husband carry news give him senior brother, that one carry gist give him Wife, their house help carry gist give Debby, Debby carry give her mother!

Na so SIL fly go their house with another Tanker of holy water say make her brother begin drink! Say na him wife wan contribute am to her ogbanje group!

Sister- in- law call meeting as the timeline to find donor don dey close. She begin insist say make dem test the wife, make the wife donate for her husband afterall, she dey do 'Me and my Husband!

The wife family say no way! Say their daughter still dey young, with only one pikin wey never reach one year! No way!

*Na so another phase of battle begin o!*

Husband case dey worsen!..Dem don empty money for hospital...begin find donor...Wife begin run from pillar to post for divine intervention! Begin fast and Pray! Nursing mother wey her neck don long like broom!

Na there wife family call her aside, dem tell her say make she no worry, say God don clear say he dey her side! Say every thing wey dey hidden, God say he don ready to reveal! Say the SIL don decide say 'make the brother kukuma die, make she see which yanga the wife go do after'! *Na who talk say blood still thick pass water for this case?!Perish that thought Biko*

*This one na case of Hen wey spill persin melecine, na to break all her eggs!* Choi!

Na so dem see donor, dem see money to fly husband out for transplant. Sister-in-law say make the wife follow her husband go! Make she drop her pikin with her for Nigeria, and incase donor do anyhow, wife organ go dey as backup!

Husband at that point too come begin misbehave, he say him wife no love am enough, say why she no donate her own organ instead of the money wey dem go waste give stranger! Say make wife drop their pikin with him sister, Afterall na she kukuma raise him! Oriegwu!

Na so wife begin get bad bad dream say if she attempt donate, she go die! Fear and pressure left and center! Leave pikin wey still dey breastfeed? Never! Prayer begin intensify for Wife family.

Unexpectedly, na so sister-in-law say na she wan follow her brother travel for the surgery. Say make dem do travel every every for her make sef go obodo oyinbo! Aftoroh na the fruit of her labour! 

Time reach to travel, husband still dey carry face for Wife under the influence of course!

Sister-in-law say make dem carry her brother go put for their senior brother house, so that wife go fit focus on the baby! Na so without prior notice o, dem bundle husband comot for matrimonial home o!

Husband don dey believe say na him wife wan kill am! So he no gree make she come visit him at all...Na through brother-in-law Wife, Wife dey manage hear small, small update.

Wife become like crase person as dem abandon only her and small pikin for house, no money, Account don empty!She go carry her pikin dey go sleep for church, dey seek for God face! Say make God heal her husband.

I jam my customer for oshodi where she dey find beggars to give money for God's mercy! Choi, see as fine woman come lean, looking abandoned and hungry. This life!

* Be like say devil  get container where he dey pack those beggars hide, when person be find to give dem something urgently*

*I wan go comot cloth for wire, be like rain wan fall* I dey come,Biko.

I go continue this gist on Monday

9 comments:

  1. Life no balance!!!!!!!!!!
    Bbjac

    ReplyDelete
  2. How would they expect a woman who gave birth not too long ago, who's still breastfeeding to donate a kidney?
    Why couldn't the siblings of the man donate?
    The family of the wife should try and come through for her.

    ReplyDelete
  3. My God expose whoever that's involved. Na wa o.

    ReplyDelete
  4. Na waooo...May God Almighty send a Divine Helper to the wifeee ..

    ReplyDelete
  5. Chei. Pls let us know how this story ended oo

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141