Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - Drama Inside Yard

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Monday, June 06, 2022

Sisi Senaponi's Corner - Drama Inside Yard

What a yard!!!










I hail o my pipu...how una dey!
Stellastically how markeit? I greet o!

Wonder nor dey ever end!

I sidon near well dey wash cloth. Na so frakukus commence! Wetin dey occur?


Bobo don carry belle give him corper gehfrend! Small time that one dey waka like snail, begin faint like ostrich!


Mama Ejima open the corper eye, she say na belle. She look her palm, she say na triplet! *orite!*

I tell corper friend make dem carry her go clinic make dem check wetin dey hollam for osor-fagors!

Small time dey come back house, corper begin wail like bushbaby! Bobo don follow him papa (landlord) go owambe.

Landlady come downstairs, she say bobo too get sense to carry belle give corper! *sideeyes*


*As belle be like airtime, wey the operator go tell you say wetin you load don enter na?!*
Abi because person nor dey ever get belle 3months wey e nor go even know?! *yeye*

Landlord and bobo come back for evening, he say he go show Bobo how him mates dey marry and settle down for the owambe!


Landlord ask bobo if na him get belle?


Bobo say Yes, dem do the do one time wey aboki no get protection for shed!

Una see this area, if you wan turn millionaire, the two things wey you go sell build house for Banana na ogogoro and ogogoro! Na why aboki dey wear canvas, dey knack better Atiku! When market dey 'sold out' like concert ticket!


Landlord say good thing say the corper go school, and Bobo sef manage graduate private university and do service before him papa village people begin use him head play draft!

The corper say she no wan marry bobo o! Say na suffer she go suffer! * she nor know say Bobo mama na Egoyinbo*


Corper female friend come yard join to put mouth say make she shine her eyes marry Bobo so she sef go be Landlady!


*kiikiikiii* I don laff throway leg!


Landlady wey her toothpick leg nor dey ever miss road go find one Baba wey nor miss, inside Bush! Na im dis tiny geh wan follow drag house!
Landlord say make everybody go sleep, say them go rethink the matter for daybreak!


Na for morning o, wey na my door person wan use blow comot!

Abeg o, Anor geh money o! Biko climb upstairs, landlord geh money inside mattress! Landlady get gold inside pot under bed! Na my periwinkle I keep for aside, una fit carry am o!


I listen well, hear landlady voice! I open door!
Wetin hapun? Why you knock door like that?!

Anor know how God dey share this thing abeg! After this landlady don born dozen pikin from dozen men! If una see as her bwess tanda like person wey never born one!

Meanwhile some of us, (Oga peter's customer) dey find bra wey get cushion, iron rod and spring inside! Lols...God nor go shame us abeg!


I say, landlady why you come carry two edged pointer come barricade me for early morning like this? Abeg tie wrapper on top this things biko. Oga harvest just begin change him ways, we nor want make he go backslide again! I don too taya to dey settle battle of the fornicators!


Landlady say the corper girl don go swallow concotion to try comot the pikin for night. But na like this pikin hol her osor-fagors! I say na lie! We join hand carry her go clinic, dey admit her begin pass water for her body.
I come house come relax before I enter market.


Never reach 30minutes wey four people with shout enter yard! Na one woman wey be like sumo wrestler lead them for front. Devil nor be me and you today! I quick close window, begin peep for curtain!


They begin para ooo! The sumo woman say landlord wan use her pikin do rituals! Say her fake pastor tell am say landlord wan renew him money and youth!


I don sidon for ground throway leg begin laff! I open my window make heat nor kill my ancestors! I carry bucket like say I wan fetch water begin use ear block the talk!

Landlady give the woman wotowoto. Choi! She say if person wan renew money, shey na her pikin wey resemble ostrich?!


Other people join to settle matter. Na corper friend carry phone call corper mama, give her half information say her daughter dey bleed for midnight.


Na inside yard there she hear say na abort her pikin attempt! Na there me sef hear say pikin no go school, talk of go service! Na tailoring school dem put her wey she run comot for house say she don find office job...

Matron talk say the pikin don abort! But the corper eventually recover as her mama bundle her go house!







Hahahahahahahhaha @ osor-fagors
your pidgin sweet too much..hehehehehehehehehe




12 comments:

  1. Replies
    1. Bra wey get spring 🀣🀣🀣🀣

      Delete
  2. Chai! This your amebo eeeehhhnnn, na first class you carry abeg. 100 gbosaaaa for you biko

    ReplyDelete
  3. omo this your pidgin konk o, the tin still dey hard a whole me wey be custodian of pidgin to comprehend at timesπŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚ na Fracas you turn to frakukus and Oesophagus to osor-fagors

    ReplyDelete
  4. See gist! E be like say that una yard na Cine Afrik o

    ReplyDelete
  5. Fuji house of commotion I raise hand for your amebo style

    ReplyDelete
  6. I too like this column I swear. E de give me excess joy πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

    ReplyDelete
  7. Kai! Dis your pidgin get PHD ehn...which one be frakukus? Chei, even my Warri friends dey learn work 🀣🀣

    ReplyDelete
  8. 🀣.. the gist sweet wela

    ReplyDelete
  9. I dey always look forward to this column, abeg this una house na cinema.

    ReplyDelete
  10. πŸ€£πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚πŸ€£πŸ˜‚

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141