Stella Dimoko Korkus.com: Sisi Senaponi's Corner - School Principal Wey Too Smart

Advertisement

Advertisement - Mobile In-Article

Friday, July 29, 2022

Sisi Senaponi's Corner - School Principal Wey Too Smart

 Sisi Senaponi i have laughed so hard reading this...Oh My goodness!







Kpoi! Kpoi! Kpoi!


Una well done ! SDK pipu of the Lord!
Stellaexpresso! How the Latitude?! I hail o!



I sidon for shop, na im oga Peter waka pass with him container! I say make i check for new dross.


Oga Peter first daughter waka pass, inside school uniform with her friends. She no wan greet her Papa o!


Na me say Georgina, how school today?! Be like say hunger don comot your left eye, wey you nor quick see your Npa o?!


She squeeze face, greet herself with shame and pass!


Oga Peter say him pikin tell am, make he nor dey advertise Dross come her school area! She say her friends dey laff am say her Papa dey sell woman condiments! *Udonminit*


I say the same money wey you dey use send her go the school?! Buy books, uniform and sandals! I say she 'couldn't' be!


The next day, after I don open shop put person there, I call oga Peter for phone say I get customer for am!
He block me for junction, I carry am enter him pikin school; He nor wan follow me, begin look if him pikin go see am!


Na so I carry am enter their Principal office. She surprise to see me! *kiiikiikii...God abeg! No peace for the wicked!*


After the last time wey my Niece carry stool, stove, kerosene, pepper,carrots, maggi, 2cups of rice and 1 Titus fish go school for Home economics practical. Teacher say dem go teach them 'Stir-fry Rice'! *We support!*


Nna ehn, na only stool she put for head come back house! Anor see balcony not to talk of stairs!
Nzube, wey my pot?Wey Rice! Stove nko?! I go check gate maybe the rice wan do celebrity entry! *Hian!*


She say her Teacher don carry everything go face Oyinbo panel to give them score! Wetin concern oyinbo with Pot and Stove?! Chineke!


I say you taste the food?! She say they nor even cook, the principal say no need, they go paste practical result for them tomorrow!


I say why dey nor keep the stool?! She say teacher sidon on top, come use behind scatter the leg! Stool wey carpenter do for small pikin! Anevasee e!


Foreign rice wah buy, thinking... plus and minus, pikin go carry half come back house!


Anor think say na Indian breeze carry me! Mba! This one na Atlantic PanAfrican Tornado, wey carry me appear for their school!


I land inside staffroom, see these teachers dey share raw kpomo, fish, Beans, Rice, Yam Tubers! *Abomination!*


They say wetin I dey find?! I say na my niece forget her Titus fish inside her teacher bag! And the fish don call me say e dey hia!


I say as I stand there sef, my 2 derica of foreign rice dey text me say, dem dey inside Rubber Paint under principal Table! - HAHAHAHAHAHAHA



Imagine o, anor even know which time this my cutlass follow me comot for house! Come attach to my wrapper like Taaata! Like say the cutlass even pre-see their denial! Wisdom nor go kee persin abeg! * una say wetin?!*


Na the same Atlantic PanAfrican Tornado wey carry me reach there, land me back inside house!


Nna ehn, my Titus wey wear black and silver sequins, balance ontop my very arrogant Foreign Rice, beside better 'incarcerated' coke wey sabi! *clickstongue* God no go shame us abeg, na person wey hustle go Lem in Jesus name!


So as me and Oga Peter come land Principal office, she don quick carry megaphone, begin ask for staffroom who offend me?! Kiikiikii!
I say nobody offend me, make she sidon come buy wetin we dey sell! Nothing wey she nor buy!



All the struggling parents and guardians wey she don embezzle, nor make dross gree enter her west! *sideeyes* Thank God say Oga Peter get special Banquet sizes!


Some teachers even follow him buy. One teacher wey resemble Voldermot inside Harry Potter, ask if Oga peter get 'something' secret! She say na wetin she dey wear! say she nor dey wear cheap cheap, things! *Hmmm!*


I say our own products nor dey deceive person! E dey show you as you be! Na if you wan come request for cushion, iron rod and burglary, he go enter market bring for you!


Be like say something enter her eyes, after I tell her say the only secret wey Victoria never tell her be say, her big mouth go soon collect wotowoto! Wey she do nose like Aba Pringles, follow TomTom do Anko!



Oga Peter nor kukuma dey sell her type! The dross fabric too thin!Mba! Her bad character go dey ooze comot! So make she face the Aunty wey dey help her keep secret! *clickstongue!*


We finish o, I say I wan greet Oga Peter pikin for class, principal carry us go. Pikin go hide under locker! Begin find wetin nor loss for Grand!


I greet the fine fine pikin dem! Pray for them, tell them wetin we dey market as some sef don dey begin grow chest wey pass Principal own!


I say we get ambassador for hia! And her name na Georgina, so anytime wey they wan order, we dey do door to door service and home delivery! Anywhere wey breeze reach, we dey go!


Na so dem clap give us, wey we comot O jare. Chineke abeg! Pikin wey dey shame for him parents legit hustle, na wetin fit them be that!

28 comments:

  1. 🤣🤣🤣🤣. Georgina no go forgive you

    ReplyDelete
  2. Nice write up and good story line.....Kudos SIsi Senaponi.
    The Marketing Strategy for me.

    ReplyDelete
  3. I like your ginger! Hehehehe no time 😂.

    ReplyDelete
  4. A little overbearing but hilarious😃😃😄 You for do small private counseling for the pikin before you deplore your massive missile on the whole school. This dem GenZ no dey like face reality. No worry some time in the future she go understand wella & give kudos to her papa. Playing a vision of dis your write up in my head is fit for a good comedy show. Well done👍🏽

    ReplyDelete
  5. I had a good laugh
    Oyibo pipo tok say "There's dignity in labour" Georgina must have learnt to be proud of her daddy's hustle

    ReplyDelete
  6. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣 my belle oooo... I really laughed today. Thank you for this.

    ReplyDelete
  7. 🤣🤣🤣🤣🤣🤣jeez

    ReplyDelete
  8. Na Georgina dem type dey deny family cos of nonsense friends.

    ReplyDelete
  9. Sisi don finish Georgina e! Na you fit these Gen Z children o! No time for nonsense! Thanks alot for the good laugh 😂😂😂🤗

    ReplyDelete
  10. 😂i had a good laugh,makes me remember back in secondary school when a classmate of mine then, was ashamed when her father came to school.

    ReplyDelete
  11. Very funny woman, you be case 😂😂😂

    ReplyDelete
  12. Principal quick carry megaphone before she go collect another wotowoto! 😂😂stella you are doing well o! Sisi no go kill persin with laff abeg! Titus with sequins🤣🤣🤣 cutlass like tataa! My belle o!

    ReplyDelete
  13. Sisi 🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣🤣 read it in Bisola's vioce
    Mhen you dey do well for yourself
    You na violence promax ah ah principal quickly carry megaphone e nor wan collect🤣


    Nothing do you

    ReplyDelete
  14. 🤣🤣🤣 Sisi I like you jare. See small pickin wey dey shame for her papa legit hustle,wey she supos to dey help her npa market him Kaya.

    ReplyDelete
  15. Well done sisi. On behalf of Georgina Papa, I say a big thank you🙏

    ReplyDelete
  16. I don't support this sha, young children can be very brutal with bullying and mockery as they haven't seen life and don't know any better. Avoid things that seem embarrassing to your children among their friends. Na so low self esteem dey take start. "See dat girl wey im papa dey sell pant".

    ReplyDelete
    Replies
    1. Not teaching her to be proud of her father’s job is what causes low self esteem. Y’all be having crazy opinion. The man is not a thief, he is a mobile undies dealer for Chris sakes. I support Sisi 💯 on this. Teach them to own their parents hustle early. My husband sold crates of mineral for his parents while working in the bank, pushing that cart o. Humility is very essential.

      Karen

      Delete
    2. Anon 17:28. Maybe if you get job for him in oil company, you can let us know! To collect school fees is not embarrassing abi? Na your type dey raise rotten children! If the father joins armed robbery, na your type go first comment that he's a bad example! You think it's easy for a man to hawk under hot sun! So if your mother sweeps Lagos road, you will say she should not embarrass you. The one supporting her @game, so you will prefer your children think you work with CNN than that you sell bushmeat?! You are the ones spoiling these generation! She's even lucky she's not the one hawking whilst her mates are in school. Good man like her father!

      Delete
    3. God bless you for this comment Karen. Imagine the audacity of the tiny child o!🤣😂😂 In our days, you will hawk under hot sun and report back to base with pride. Infact, people will identify you with your mama hustle. 😂you go hear, no be Omo Iya Alamala be that or Oga carpenter pikin? Legit! Na with pride o! Your friends sef go come patronize the market and ask for discount! Na the money raise us o! Not like this fake generation!

      Delete
  17. Gen Z and their fragile self esteem, bloated egos and overrated opinions of themselves

    ReplyDelete
  18. One day, a classmate's dad came to our elite private school in his uniform as a driver for a private firm. Even our teacher was not sure about whether to look down on him or respect him but honestly, that day, despite his daughter being embarrassed, I was sooooo in awe of him as he obviously had far more sense than any of our own drivers who's sole concern was building in the village, birthing boys or colluding with the mechanic to rob . . He was giving his children the opportunity he never had despite their gender and he was holding down an honest job in a declining economy. This guy was making a bigger sacrifice than our own parents. As his walkie talkie swung from his hips on the corridor on his way out, I wanted to actually run after him to salute him. Even as a kid, I got it on a deeper level. May God continue to bless you, papa Chisom.

    When inflation runs riot and prices and fees rise, these are the people who get affected first. He couldn't meet up with the hiked fees so they changed schools.

    Please God, continue to prosper the hands of such responsible parents irrespective of what the devourers of this country are up to. They deserve to reap their good reward.

    ReplyDelete

Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Blog Commenters Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinion Of StellaDimokoKorkus.com

Pictures and culled stories posted on this site are given credit and if a story is yours but credited to the wrong source,Please contact Stelladimokokorkus.com and corrections will be made..

If you have a complaint or a story,Please Contact StellaDimokoKorkus.com Via

Sdimokokorkus@gmail.com
Mobile Phone +4915210724141